Wetin Dey Part 10
Jehovah na King. No be today e start to dey use im power save im people and e go no go stop to dey use im power save im people. For example, e save Jeremiah when some people throwey am for inside hole. E save Shadrach, Meshach, and Abednego when the king put dem for fire. E save Daniel when the king put am for where many lion dey. Jehovah protect Esther make e fit save all im people. E no go let bad thing continue to dey happen. Wetin Bible talk about the big image and the big tree make us know sey God Kingdom go soon comot bad things for this earth.