SONG 121
Dey Try Control Yourself
(Romans 7:14-25)
1. We like to dey do wetin God tell us.
But the sin wey we get dey make am hard us.
Bible talk sey we fit enjoy life,
If we fit dey try control ourself.
2. As we just dey try to serve Jehovah,
Things wey we no expect fit bring wahala.
Thank Jehovah sey Jesus save us.
E leave im Papa come die for us.
3. E good to dey use our life praise our God.
Jehovah go happy if we serve am well.
God go give us im spirit wey strong.
So make we dey try control ourself.
(Still check 1 Cor. 9:25; Gal. 5:23; 2 Pet. 1:6.)