Tell People the Good News About God Favor
“Preach well about the good news of God favor.”—ACTS 20:24.
SONG: 101, 84
1, 2. How apostle Paul take show sey e dey thank God for the favor wey God show am?
APOSTLE Paul talk true when e sey: ‘The favor wey God show me no be for nothing.’ (Read 1 Corinthians 15:9, 10.) Paul know sey God favor no be wetin suppose reach im hand as e be sey before before, im work na to punish people wey be Christian.
2 Around the time wey e go die, Paul write give Timothy sey: ‘I dey thank Jesus Christ our Lord, wey give me power, because e believe sey I fit do am, na im make e give me this work.’ (1 Tim. 1:12-14) Which work be that? Paul tell the elders wey dey Ephesus congregation wetin e be, when e talk sey: ‘But I no take my life like sey na anything to me, so far I go fit finish this race wey I don start and the work wey the Lord Jesus give me, to preach well about the good news of God favor.’—Acts 20:24.
3. Which special work God give Paul? (Go check the first picture.)
3 Which ‘good news’ Paul preach wey make am clear sey Jehovah dey show favor? E tell Christian dem for Ephesus sey: ‘Una don hear about the work wey God favor make me get because of una.’ (Eph. 3:1, 2) Jehovah choose Paul make e preach give people wey no be Jew so that dem go fit join people wey go rule with Christ for im Kingdom. (Read Ephesians 3:5-8.) Paul preach well well and im example show us how we go dey preach today. Paul still show sey the favor wey God show am, no be ‘for nothing.’
WETIN JEHOVAH FAVOR SUPPOSE MAKE YOU DO?
4, 5. Why we fit talk sey ‘good news about God Kingdom’ na the same thing with good news about ‘God favor’?
4 For this last days, Jehovah don give im people the work to preach the ‘good news’ about im Kingdom ‘for everywhere for this world make everybody fit hear.’ (Matt. 24:14) This ‘good news about God Kingdom’ na still ‘good news of God favor.’ How e take be so? E be like that because all the blessing wey we go enjoy for God Kingdom na because Jehovah get good mind well well and na Jesus Christ e go use bless us. (Eph. 1:3) We be like Paul? We dey show for how we dey preach sey we thank Jehovah for im favor?—Read Romans 1:14-16.
5 For the topic wey we study before this one, we learn different different way wey we take dey gain because of Jehovah favor. So, na our work to do everything wey we fit do to tell people how Jehovah don show sey e love us and how dem fit gain. How we go do am?
NO STOP TO TELL PEOPLE ABOUT THE RANSOM
6, 7. How e be sey we dey talk about the good news of God favor when we dey tell people about the ransom?
6 Today, people no dey count sin as anything; dem dey feel sey na normal thing. Na im make many people no know sey we need ransom. But many people dey see am sey that kind life no dey make person happy. Jehovah Witness people don help many people sabi wetin sin be, how e take dey affect us and wetin we go do to comot from sin hand. People wey get better mind dey happy when dem sabi sey Jehovah send im Son come this world make e come save us from sin and death. All this one na because Jehovah love us well well and because of im favor.—1 John 4:9, 10.
7 Paul talk something about this Son wey Jehovah love well well, e sey: ‘Na because of am [Jesus], the ransom come free us with that one blood, yes, our sin don comot, because im [Jehovah] favor dey surplus well well.’ (Eph. 1:7) Na this ransom Jehovah take show sey e love us well well and e still show us how im favor plenty reach. E dey make person mind come down to know sey if we dey show sey we get faith for wetin Jesus do, Jehovah go forgive our sin. And our mind no go dey judge us again! (Heb. 9:14) This na really good news to tell people!
HELP PEOPLE MAKE DEM COME BE GOD FRIEND
8. Why human being need to settle with God?
8 Na our work to tell people sey dem fit be God friend. Before human being start to show sey dem get faith for Jesus sacrifice, God first dey look dem like enemy. Apostle John write sey: ‘The person wey dey show sey e get faith for the Son get life wey no go end; the person wey dey do wetin the Son no like no go see life, but God go always dey vex with am.’ (John 3:36) We dey happy sey because Jesus die, we and God fit settle, come be friend. Paul talk sey: ‘Una no dey God side and una be enemy because una mind dey for wicked things, e don use the body of that one take settle with una now, because e die.’—Col. 1:21, 22.
9, 10. (a) Which work Jesus give im brothers wey God choose with holy spirit? (b) How ‘other sheep’ take dey help dem?
9 Jesus don give im brothers wey God choose with holy spirit wey still dey this earth ‘the work to make people settle with God.’ To fit explain how this work be, Paul write give the first Christian dem wey God choose, e tell dem sey: ‘Everything na from God, wey make us settle with am because of Christ, and e come give us the work wey go make people settle, sey, na Christ God use take make the world settle with am, e no dey use their mistake judge dem, and e come give us the message wey dey bring peace. So, we be people wey Christ send wey dey stand for am, like sey God dey use us beg una. As people wey dey stand for Christ, we beg una: “Make una settle with God.”’—2 Cor. 5:18-20.
10 The ‘other sheep’ dey see am as better chance to help their brothers wey God use im spirit choose for this work. (John 10:16) As people wey Christ don send message, na ‘other sheep’ dey do this work pass. Dem dey teach people the truth wey dey Bible and dey help dem make dem come be Jehovah friend. Wetin dem dey do na one important way to show sey dem dey preach well well about the good news of God favor.
TELL PEOPLE THE GOOD NEWS SEY GOD DEY HEAR PRAYER
11, 12. Why e be sey na good news for people to know sey dem fit pray to Jehovah?
11 Many people dey like to pray because e dey make their mind come down but dem no really believe sey God dey hear their prayer. We suppose let dem know sey Jehovah ‘dey hear prayer.’ David write sey: ‘You wey dey hear prayer, na you everybody go come meet. My mistake don plenty pass me, but you no dey put eye for our sin.’—Ps. 65:2, 3.
12 Jesus tell im disciple dem sey: ‘If una use my name beg for anything, I go do am.’ (John 14:14) E clear sey, the ‘anything’ wey Jesus dey talk for here na anything wey agree with wetin Jehovah want. John talk something wey go make us happy, e sey: ‘This na wetin we believe for im side, sey, no matter wetin we beg am e dey hear us, if na wetin e want.’ (1 John 5:14) E good to help people know sey prayer no be just wetin fit make person mind come down. But prayer na how we take dey talk to Jehovah wey dey show us favor! (Heb. 4:16) As we dey teach people the correct way to pray, who dem go pray to and the correct reason why dem suppose pray, we fit help dem near Jehovah. And their mind go come down even when problem dey.—Ps. 4:1; 145:18.
JEHOVAH GO SHOW US FAVOR FOR THE NEW WORLD
13, 14. (a) Which better thing the people wey God don choose with im spirit go enjoy for front? (b) Which kind work dem go do for us that time?
13 Jehovah go dey show us im favor even when this wicked world no dey again. The time wey Paul dey talk about the special chance wey God don give the 144,000 people wey go follow Jesus rule for heaven, e sey: ‘God, wey dey pity us well well because of the way e take love us well well, make us come get life together with Christ, even when we don die for sin—na favor save una. Another thing be sey, e bring us come life together again and make us sitdown for the place wey dey for heaven with Christ Jesus, so that for the new world wey dey come, e fit show us im favor as e plenty reach because e get good mind for us, with Christ Jesus.’—Eph. 2:4-7.
14 We no fit really know the kind better things wey God get for mind for the people wey go follow Jesus rule for heaven when dem start to rule. (Luke 22:28-30; Phil. 3:20, 21; 1 John 3:2) Jehovah go show dem ‘im favor as e plenty reach.’ Na dem go be ‘the New Jerusalem’ wey be Jesus wife. (Rev. 3:12; 17:14; 21:2, 9, 10) Dem go join Jesus ‘cure people.’ Dem go show us wetin we go do to fit comot from sin and we no go dey sick, die or do bad thing.—Read Revelation 22:1, 2, 17.
15, 16. How Jehovah go take show ‘other sheep’ im favor for the new world?
15 For Ephesians 2:7, Bible talk sey God go show im favor for ‘the new world wey dey come.’ We dey sure sey for that new world we go enjoy ‘God favor as e take plenty reach.’ (Luke 18:29, 30) One way Jehovah go take show im favor na when e go resurrect people wey dey ‘Grave.’ (Job 14:13-15; John 5:28, 29) All the people wey get faith wey don die before Jesus come die for us and the ‘other sheep’ wey die for our time, go still come life again come serve Jehovah.
16 God go still resurrect many many people wey no know am before dem die. Jehovah go give dem chance to choose am as their king. John write sey: ‘I see the people wey don die, both big and small, as dem stand for front of God throne, and dem open scrolls. But dem come open another scroll; na the scroll of life. Dem judge people wey don die from the things wey dem write inside the scrolls, as dem take live their life. And river bring out people wey don die for inside, and death and Grave bring out people wey don die for inside, and dem judge dem one one as dem take live their life.’ (Rev. 20:12, 13) But the people wey go resurrect go learn wetin e mean to follow wetin Bible talk for their life. Another thing be sey, for ‘the scroll’ wey dem go open, dem write the things wey Jehovah want make people do for the new world. So, this people wey go resurrect go follow do wetin dey the scroll. For Jehovah to teach us wetin dey inside the scrolls, na another way wey e take dey show im favor.
CONTINUE TO DEY TELL PEOPLE THE GOOD NEWS
17. Wetin we no suppose forget as we dey preach?
17 E dey important now pass before sey make we dey preach the good news about God Kingdom! (Mark 13:10) We know sey Jehovah dey use the good news show im favor. Make we no forget this one as we dey preach. We dey preach to praise Jehovah. We go fit praise Jehovah if we dey tell people sey all the things wey we go enjoy for the new world, na because of Jehovah favor.
Serve Jehovah well well as “better servant wey don get God favor.”—1 Pet. 4:10 (See paragraphs 17-19)
18, 19. How we take dey make people sabi Jehovah favor?
18 As we dey preach, e good to tell people sey when Jesus go begin rule this earth, all of us go gain well well from that ransom and small small we go come be as we suppose be. Bible talk sey: ‘The things wey God don make, go free from sin come get the freedom wey God pikin dem get.’ (Rom. 8:21) Na only Jehovah favor fit make this one happen.
19 We get the chance to tell everybody wey ready to hear about this better promise wey dey Revelation 21:4, 5 wey talk sey: ‘[God] go dry all the water wey dey comot for their eye, dem no go die again, dem no go even cry because of sey person die, trouble and pain no go dey again. All this things don pass.’ And Jehovah, the person wey sitdown for throne talk sey: ‘See am! I dey make everything new.’ E still talk sey: ‘Write this thing wey I dey tell you because wetin I talk na true, and you fit trust am.’ As we dey use every chance take dey preach this good news give other people, we dey make dem sabi Jehovah favor!