Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 August pp. 8-12
  • Marriage—How E Start and Why E Dey?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Marriage—How E Start and Why E Dey?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • WETIN MAKE MARRIAGE DEY?
  • MARRIAGE—FROM ADAM TIME GO REACH NOAH TIME
  • MARRIAGE—FROM NOAH TIME GO REACH JESUS TIME
  • NO LEAVE YOUR HUSBAND OR WIFE
  • MARRIAGE FOR OUR TIME
  • You Fit Enjoy Your Marriage!
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 August pp. 8-12
Adam and Eve for inside garden of Eden

Marriage—How E Start and Why E Dey?

‘Jehovah God come talk sey: “E no good make only the man continue to dey stay. I go make person wey go help am.”’—GEN. 2:18.

SONG: 36, 11

HOW YOU GO TAKE ANSWER?

  • Why we fit talk sey marriage na gift wey Jehovah give us?

  • How marriage be from Adam time go reach Jesus time?

  • Wetin fit help person wey dey serve Jehovah choose whether e go marry?

1, 2. (a) How marriage take start? (b) Because God use Adam rib make the first woman, wetin fit don dey their mind? (Check the first picture.)

MARRIAGE na normal thing for life. But how e start and why e dey? The answer go help us see marriage as God dey see am and help us enjoy the blessing wey dey marriage pass as we dey enjoy am now. After God make the first man, Adam, e carry the animal dem go meet am, make Adam give dem name. But ‘the man no get person wey go help am to make am complete.’ God come make Adam sleep deep sleep, e comot one of im rib, use am make woman, and e carry am give the man. (Read Genesis 2:20-24.) So, we fit talk sey na Jehovah start marriage.

2 Jesus gree with wetin Jehovah talk, when e sey: ‘Man go leave im papa and mama and e go dey with im wife, and two of dem go be one flesh.’ (Matt. 19:4, 5) As God use Adam rib make the first woman, e go don help dem know sey two of dem na one. E no dey Jehovah mind make marriage end or sey make person marry pass one husband or wife.

WETIN MAKE MARRIAGE DEY?

3. Wetin be one thing wey make marriage dey?

3 Adam happy to see im fine wife and e come later call am Eve. Eve ‘go dey help am,’ because Eve ‘make Adam complete.’ As dem dey do wetin dem suppose do as husband and wife, dem go dey happy every day. (Gen. 2:18) One thing wey make marriage dey, na for people to full this world. (Gen. 1:28) No matter sey pikin love im papa and mama, e go still leave dem go marry and start im own family. People go full this world, then everywhere for this world go turn to paradise.

4. Wetin happen to the first marriage?

4 Problem come dey the first marriage because Adam and Eve no do wetin Jehovah talk. ‘The original snake,’ wey be Satan the Devil, deceive Eve. E tell Eve sey make e chop fruit from ‘the tree of knowledge of good and bad.’ And sey if e chop am, e go get the sense to know and to choose wetin good and wetin bad. Eve believe Satan. Eve no respect Adam as head because Eve no ask am before e chop the fruit. And instead of Adam to do wetin God talk, e chop the fruit wey Eve give am.—Rev. 12:9; Gen. 2:9, 16, 17; 3:1-6.

5. Wetin we fit learn from how Adam and Eve take answer Jehovah?

5 When God ask Adam wetin happen, e come dey blame im wife. E sey: ‘The woman wey you give me make e dey with me, na im give me fruit from the tree, so I come chop am.’ Eve blame the snake. (Gen. 3:12, 13) All this excuse no get head at all! Because dem don do wetin Jehovah no like, e judge dem as bad people. Wetin happen to dem na lesson for us! If husband and wife want make their marriage work, make dem dey do wetin Jehovah want. Husband, no blame your wife for your mistake and wife, no blame your husband for your mistake.

6. How you go take explain wetin dey Genesis 3:15?

6 Upon wetin Satan do for garden of Eden, Bible show sey Jehovah still give all of us hope. (Read Genesis 3:15.) The ‘pikin’ wey ‘the woman’ go born, go scatter the head of that bad angel wey be Satan. This promise show us how Jehovah and all the good angel for heaven take love theirself. Dem be like Jehovah wife. Bible come later tell us sey na one of dem Jehovah go send to scatter Satan head. Na im Jehovah go still use give us wetin Adam and Eve trowey—life wey no go end for paradise earth, as Jehovah take get for mind before.—John 3:16.

7. (a) Wetin don dey happen to marriage since Adam and Eve do wetin Jehovah no like? (b) Wetin Bible sey make husband and wife dey do?

7 Wetin Adam and Eve do cause problem for their marriage and other marriage wey follow their own. For example, Eve and other women go feel pain well well when dem get belle and when dem dey born pikin. E go always hungry woman to dey with im husband, but man go dey control im wife and sometimes dem go use strong hand as we dey see for many marriage today. (Gen. 3:16) Bible talk sey make husband dey treat their wife with love. And wife go respect their husband as head. (Eph. 5:33) If husband and wife wey dey serve Jehovah dey do things together, problem no go too dey the marriage. And dem fit even stop anything wey fit cause problem.

MARRIAGE—FROM ADAM TIME GO REACH NOAH TIME

8. From Adam time go reach Noah time, how marriage be?

8 Before Adam and Eve die because of wetin dem do, dem don already get plenty pikin. (Gen. 5:4) Cain, wey be their first pikin, marry one of im family person. Lamech, wey come from Cain family, na the first person wey Bible sey get two wife. (Gen. 4:17, 19) From Adam time go reach Noah time, people wey serve Jehovah no plenty. Some of dem na Abel, Enoch, Noah and im family. Bible talk sey for Noah time, ‘some of the son wey the true God get come dey eye the fine girls wey people for this world born. So, dem come dey take any one wey dem choose as their wife.’ The women come born giant because e no normal for angel to marry human being. Apart from that one, ‘the bad things wey people dey do for the world’ come too much and na only bad things ‘dey their mind every time.’—Gen. 6:1-5.

9. Wetin Jehovah do the bad people for Noah time? And wetin this one teach us?

9 Jehovah use the heavy rain wey fall for Noah time take kill all the bad people. That time, one thing wey dey their mind pass na to marry. Dem no put ear for wetin Noah dey tell dem, even though Bible sey Noah na person ‘wey dey preach about wetin good.’ (2 Pet. 2:5) Jesus talk sey our time go be like Noah time. (Read Matthew 24:37-39.) Today, we dey preach the good news for everywhere before the world go end. But many people no dey want hear. Wetin this one teach us? Make we no let family matter, whether na marriage or to train pikin, make us forget sey Jehovah day go soon come.

MARRIAGE—FROM NOAH TIME GO REACH JESUS TIME

10. (a) For Noah time, which kind thing people take as normal thing? (b) How Abraham and Sarah take show better example for their marriage?

10 Many people for Noah time dey marry plenty wife, but Noah and im three pikin marry one one wife. For many place, people dey count am as normal thing to dey put hand for different different sex matter wey no clean for God eye. Some even dey do am as part of wetin dem use dey serve their juju. When Abram (Abraham) and im wife, Sarai (Sarah) go Canaan, the things wey Canaan people dey do show sey dem no dey respect marriage. So, Jehovah come talk sey e go kill people wey dey Sodom and Gomorrah because dem dey put hand for sex matter wey no clean for im eye. As family head, Abraham dey do im work well and Sarah show better example of wife wey dey respect im husband as head. (Read 1 Peter 3:3-6.) Abraham make sure sey Isaac, im pikin, marry person wey dey serve Jehovah. Na the same thing Isaac do for Jacob and the twelve tribe of Israel come out from Jacob pikin dem.

11. How the Law wey Jehovah give Israel people that time take protect dem?

11 Later, Jehovah and Jacob pikin dem (Israel people) enter one agreement. That time, dem dey marry pass one person. But the Law wey Jehovah give dem dey direct their marriage. The Law still help dem make dem no marry people wey no dey serve Jehovah. (Read Deuteronomy 7:3, 4.) Anytime wey dem get serious problem for their marriage, the elders wey dey that time dey help dem. Some of the problem fit be jealousy, if person leave im husband or wife go dey follow another person and if husband dey suspect im wife. Even though sey the Law allow dem end their marriage, dem no get right to end am anyhow. Man fit end im marriage if ‘e see something wey no good about’ im wife. (Deut. 24:1) Bible no tell us wetin this thing ‘wey no good’ be, but we dey sure sey no be just any small mistake wey the wife do.—Lev. 19:18.

NO LEAVE YOUR HUSBAND OR WIFE

12, 13. (a) How some people for Malachi time dey treat their wife? (b) Today, wetin go happen if person wey don baptize run comot with another person husband or wife?

12 For prophet Malachi time, many husband for Israel dey let small small thing make dem end their marriage. Dem go pursue their wife so that dem fit marry young women or even women wey no dey serve Jehovah. Even the time wey Jesus dey this world, dem still dey end their marriage ‘because of anything wey their wife do.’ (Matt. 19:3) Jehovah hate this thing wey dem dey do.—Read Malachi 2:13-16.

13 Today, Jehovah people no dey let this kind thing happen for congregation. But what if person wey don marry and wey don baptize run comot with another person husband or wife, come marry this person after e don end im first marriage? If the person wey do this bad thing no change, dem go disfellowship am so that congregation go still clean for God eye. (1 Cor. 5:11-13) This person must ‘show sey e don repent’ before congregation go gree make e come back. (Luke 3:8; 2 Cor. 2:5-10) Na true sey e no get time wey dem put sey after e pass, congregation go bring back the person wey do this kind thing. But make we get am for mind sey, congregation no go comot eye for this kind matter even if e no dey too happen. E fit reach or pass one year before congregation go fit know whether the person don change from that life. Even if congregation gree make e come back, the person go still ‘stand for the front of God judgment seat.’—Rom. 14:10-12; go check November 15, 1979 Watchtower, pp. 31-32.

MARRIAGE FOR OUR TIME

14. Wetin the Law do for Israel people?

14 E pass 1,500 years wey Jehovah use the Law take direct Israel people. The Law help dem to dey handle family matter and other things the way Jehovah want. And na the Law still direct dem go reach when Messiah come. (Gal. 3:23, 24) The Law end the time wey Jesus die and God come start one new arrangement. (Heb. 8:6) This new arrangement no allow dem do some of the things wey dem dey do when the Law still dey.

15. (a) For our time how God want make marriage be? (b) Wetin person wey dey serve Jehovah go get for mind before e end im marriage?

15 When Jesus dey answer some Pharisee people wey ask am question, e tell dem sey because Moses allow dem to end their marriage, no mean sey na ‘so e be from beginning.’ (Matt. 19:6-8) So wetin Jesus talk show sey wetin God get for mind about marriage na one man and one woman. (1 Tim. 3:2, 12) Because dem be ‘one flesh,’ people wey don marry no suppose leave each other. Dem suppose allow their love for God and theirself make their marriage strong. If dem go collect paper to end the marriage when e be sey their husband or wife no go sleep with another person, dem no get right to marry another person. (Matt. 19:9) But person fit forgive im husband or wife wey sleep with another person, the way Hosea take forgive im wife, Gomer, wey dey follow man. Na so Jehovah still do for Israel people. E forgive dem even though sey dem go serve another god, like woman wey leave im husband follow another man. (Hos. 3:1-5) Make we still get am for mind sey, if person know sey im husband or wife sleep with another person and e come start to sleep again with that im husband or wife, that one mean sey e don forgive am. After this one, Bible no support make e end the marriage.

16. Wetin Jesus talk about person wey never marry?

16 After Jesus talk about wetin fit end marriage, e come talk about people wey never marry, ‘wey get the gift’ to dey like that. E still talk sey: ‘Make the person wey fit make space for am, make space for am.’ (Matt. 19:10-12) Many people don choose sey dem no go marry so that dem fit put all their mind for Jehovah work. We suppose praise dem for this thing wey dem do.

17. Wetin fit help person choose whether e go marry or e go dey like that?

17 Na person go choose whether e go marry or e no go marry. Na im know whether e get the gift wey Jesus talk about. Apostle Paul talk sey e good if person sey e no go marry; but, e come talk sey: ‘Because people dey do sex wey no clean for God eye anyhow-anyhow, make man get im own wife and make woman get im own husband.’ E still sey: ‘But if dem no fit control theirself, make dem marry, because e go better if dem marry instead of their body to dey hot for sex.’ Marriage fit help person comot hand for things wey no clean for God eye like to rub im private part (masturbation) or to dey play love with person wey no be im husband or wife. E still good make people wey want marry ask theirself whether dem don reach to marry because of wetin apostle Paul talk. E sey: ‘If anybody think sey the way e dey behave as e never marry no good, and if e don pass the age wey im body dey push am for sex, then make this one be wetin go happen: Make e do wetin e want; e no sin. Make dem marry.’ (1 Cor. 7:2, 9, 36; 1 Tim. 4:1-3) But this one no mean sey person go just marry because of the way body dey do am when e young. E fit never mature reach to do the work wey dey inside marriage.

18, 19. (a) How marriage for our time suppose start? (b) Wetin we go learn for our next topic?

18 Marriage for our time suppose start with man and woman wey don give Jehovah their life and wey love am with all their mind. Dem suppose don love theirself well well sotey dem want live their life together as husband and wife. Jehovah go bless dem because na person wey dey serve am dem marry. (1 Cor. 7:39) Their marriage go sweet because dem dey follow the advice wey dey Bible.

19 For this ‘last days,’ many people no get the kind character wey go make marriage work. For the next topic, we go learn some things for Bible wey fit help people wey don marry to manage their problem. (2 Tim. 3:1-5) Wetin we go learn go make their marriage work, help dem enjoy am and help dem to dey waka with im people for the road wey dey carry people go life wey no go end.—Matt. 7:13, 14.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share