Show Sey You Get Faith for Wetin Jehovah Don Promise
‘Faith na wetin dey make person believe sey wetin e dey wait for dey real even though e never see am.’—HEB. 11:1, ftn.
SONG: 54, 125
1. How we take dey see the faith wey all Christian get?
THE faith wey all Christian get na character wey scarce. No be everybody get am. (2 Thess. 3:2) But Jehovah don give faith to all the people wey dey worship am. (Rom. 12:3; Gal. 5:22) All of us wey get this faith suppose dey thank Jehovah well well.
2, 3. (a) Which kind blessing person wey get faith fit enjoy? (b) Which question we go answer for this topic?
2 Jesus Christ sey im Father for heaven dey use im Son bring people come im side. (John 6:44, 65) And when person show sey e get faith for Jesus, God go forgive am. This one go come give am the chance to be Jehovah friend forever. (Rom. 6:23) We suppose receive this kind blessing? No. Because we be sinner, na die we suppose die. (Ps. 103:10) But Jehovah no see us like that, e see the better thing wey dey inside us. Because of im favor, e come open our mind make we fit know the good news about im Kingdom. Na this one come make us dey show sey we get faith for Jesus and believe sey we fit get life wey no go end.—Read 1 John 4:9, 10.
3 But wetin faith really be? Na to just to know sey Jehovah go bless us? And how we fit take show sey we get faith?
‘GET FAITH FOR YOUR MIND’
4. Why faith no be just to know wetin Jehovah get for mind for us?
4 Faith no be just to know wetin Jehovah get for mind for us. Na faith dey make us do wetin Jehovah want. When person get faith for how God go take save us, that one go make am dey tell people about God Kingdom. Apostle Paul talk sey: ‘If you use your mouth tell people sey Jesus na Lord, and you get the faith for your mind sey God raise am from death, you go save. Because na the mind person dey use show sey e get faith for wetin dey right, but na mouth person take dey tell people wetin go save dem.’—Rom. 10:9, 10; 2 Cor. 4:13.
5. Why faith be better thing and how we fit make am strong? Give example.
5 E clear sey, for us to get life wey no go end for paradise, we must get faith and continue to dey make am strong. As wetin we plant need water to grow na so e still be with our faith. Real flower no be like rubber flower wey no dey grow. Real flower need water every time so that e go grow well but if we no dey give am water as we suppose, e go die. Na so our faith still be, if we leave am e go die. (Luke 22:32; Heb. 3:12) But if we take care of am well, e no go die, e go continue to grow and we go get strong faith.—2 Thess. 1:3; Titus 2:2.
HOW BIBLE TAKE EXPLAIN WETIN FAITH BE
6. Wetin be the two things wey Hebrews 11:1 take explain wetin faith be?
6 Bible explain wetin faith be for Hebrews 11:1. (Read am.) Faith na about two things wey we no fit see, dem be: (1) ‘Wetin we dey wait for’—things wey God don promise like, to make this earth paradise and destroy bad people. (2) ‘Wetin dey real wey we never see.’ For this verse, the Greek word wey dem translate as ‘wetin dey make person believe’ dey talk about ‘wetin dey make person get reason’ sey wetin e no dey see dey real. This one mean sey we believe sey Jehovah God, Jesus Christ, angels and God Kingdom wey dey heaven dey real. (Heb. 11:3) How we go take show sey wetin we dey wait for dey real and sey we believe the things wey we never see wey dey Bible? Na the way we dey live our life and wetin we dey talk go show am. If no be so, our faith never complete.
7. How Noah example take help us understand wetin e mean to get faith? (Go check the first picture.)
7 Hebrews 11:7 talk about Noah faith. After Jehovah don tell am wetin e want do, wey Noah never see, Noah show sey e get faith. Im faith make am build ark wey go save im family. E fit be sey, people wey dey around am don ask am why e dey build this kind big ark. You think sey Noah close mouth or e tell dem to mind their business? E no do like that! Because of im faith, e preach give dem sey God want destroy the world. E fit be sey, Noah tell dem the same word wey Jehovah tell am, when e sey: ‘The time don come wey I go sweep anything wey get life comot, because dem don take their bad cover the whole world. I go use water take destroy everything wey get life for the earth.’ Noah still explain the only thing wey God talk wey go save dem. E sey: ‘Una must enter inside the ark.’ Noah still show sey e get faith because e be ‘person wey dey preach about wetin good.’—Gen. 6:13, 17, 18; 2 Pet. 2:5.
8. How God take use James explain wetin faith mean?
8 E fit be sey e no tey wey God use apostle Paul write about faith finish, na im James write the book of James. Like Paul, James explain sey true faith wey Christian get no be just to believe; you must do wetin go show am. ‘Show me your faith when you no dey do wetin show sey you get am, and I go show you my faith with wetin I dey do.’ (Jas. 2:18) James still show sey to just believe and to get faith na two different things. Demons believe sey God dey, but dem no get true faith. But dem dey do wetin show sey dem no support God Kingdom. (Jas. 2:19, 20) And when James dey talk about the faith wey Abraham get, e ask sey: ‘No be because of the better thing wey Abraham our papa do when e sacrifice Isaac im pikin for altar make God sey im na better person? You see sey e show im faith with the things wey e do and im faith come dey complete because of wetin e do.’ To make people understand the matter well, James come sey: ‘True true, as body wey no get spirit don die, na so e still be, faith wey no dey show for wetin we dey do, don die.’—Jas. 2:21-23, 26.
9, 10. How apostle John take show us why e good to get faith?
9 After thirty years, apostle John write the book of John and three other book for Bible. Like other people wey write Bible, John really understand wetin faith mean. E use the Greek word wey dem dey translate sometimes as “show sey you get faith” pass other people wey join write Bible.
10 For example, John explain sey: ‘The person wey dey show sey e get faith for the Son get life wey no go end; the person wey dey do wetin the Son no like no go see life, but God go always dey vex with am.’ (John 3:36) We dey show sey we get faith when we dey do wetin Jesus talk. Many times, John write wetin Jesus talk about wetin we go dey do to show sey we get faith.—John 3:16; 6:29, 40; 11:25, 26; 14:1, 12.
11. How we go take show sey we happy as Jehovah don show us truth from Bible?
11 We suppose dey thank Jehovah well well because e don use im holy spirit show us the truth and help us get faith for wetin e promise. (Read Luke 10:21.) Make we no ever stop to dey thank Jehovah sey e use im Son wey be our Leader and ‘the Person wey dey make our faith strong’ take draw us near imself. (Heb. 12:2) To show sey we happy as Jehovah dey show us favor, we go continue to dey pray and study God Word so that our faith go strong.—Eph. 6:18; 1 Pet. 2:2.
To show your faith, use every chance wey you get take dey preach about God Kingdom (Check paragraph 12)
12. How we go take show sey we get faith?
12 Make we continue to show sey we get faith sey wetin Jehovah promise go happen. We go dey do am make other people see am. For example, we go dey preach and teach people about God Kingdom. We go still dey ‘do good for everybody, but especially for people wey dey the same faith with us.’ (Gal. 6:10) And we go do everything wey we fit do to ‘pull the old person comot with all im character.’ Make we no do anything wey go comot us from Jehovah side.—Col. 3:5, 8-10.
WE MUST GET FAITH
13. Why e good make we get faith, and wetin faith be like, and why?
13 Bible talk sey ‘person wey no get faith no go fit do wetin go make God happy, because anybody wey want near God must believe sey e dey, and sey na im dey bless the people wey dey use all their power find am.’ (Heb. 11:6, ftn.) Bible explain sey ‘to get faith for God’ na part of the first thing wey person go get so that e go be true Christian and continue to be true Christian. (Heb. 6:1) When Christian don get faith, dem must add other fine fine character join their faith so that dem ‘no comot for God love.’—Read 2 Peter 1:5-7; Jude 20, 21.
14, 15. How love take big pass faith?
14 People wey write Bible for apostle time show sey faith na better thing because, dem talk about am plenty times. Dem no talk about other character wey Christian fit get like this. You think sey this one make faith better pass other character wey Christian suppose get?
15 When Paul dey talk about faith and love, e write sey: ‘If I get the faith wey I fit use take uproot mountain but I no get love, I no be anything.’ (1 Cor. 13:2) Jesus talk sey na love big pass other character, when e answer the question wey sey: ‘Na which command big pass?’ (Matt. 22:35-40) Na love dey make us get other Christian character, like faith. Bible sey: ‘Love dey believe everything.’ Love go help us get faith for wetin God don talk for Bible.—1 Cor. 13:4, 7.
16, 17. How Bible take use faith and love together, but which one big pass? And why?
16 People wey write Bible for the apostle time show how faith and love dey important reach. Dem use the two character together many times for the same Bible verse. Paul tell im brothers sey make dem ‘wear faith and love as breastplate.’ (1 Thess. 5:8) Peter write sey: ‘Even though sey una no see [Jesus], una love am. Even though sey una no dey see am now, una still dey show sey una get faith for im side.’ (1 Pet. 1:8) James ask im brothers wey go join am rule with Jesus for heaven sey: ‘No be God choose people wey this world dey see as poor people come make their faith rich and make dem fit join rule for the Kingdom, wey e promise people wey love am?’ (Jas. 2:5) John write sey: ‘This na wetin [God] command: sey make we get faith for the Son name wey be Jesus Christ and love ourself.’—1 John 3:23.
17 Even though sey faith dey important, we no go need am again when God don do wetin e promise and when we don dey enjoy wetin we dey wait for. But e no get any time wey we go stop to love God and our neighbor. Na wetin make Paul write sey: ‘But, now, na this three remain: faith, hope, love; but the one wey pass all of dem na love.’—1 Cor. 13:13.
DEM REALLY SHOW THEIR FAITH
18, 19. How God people take dey show sey dem really get faith, and na who dey make am happen?
18 Today, Jehovah people don show sey dem get faith for God Kingdom wey don start to rule for heaven. This one don make Jehovah Witness for the whole world plenty pass eight million. And for im organization, Jehovah spirit dey make im people get the different different better character wey im spirit dey give. (Gal. 5:22, 23) This one dey really show sey dem get faith and love!
19 Nobody fit sey na im make all this things happen. Na Jehovah make am happen. This better work dey make ‘people sabi Jehovah’ and ‘na sign wey no go ever end.’ (Isa. 55:13) True true, ‘na gift wey God give’ sey ‘make dem fit use faith save’ us. (Eph. 2:8) Our organization go continue to dey grow and shine until only good people wey no get sin and wey go always dey happy, go full this world. Dem go dey praise Jehovah forever. Make we continue to dey show sey we get faith for wetin Jehovah don promise!