Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 November pp. 19-20
  • ‘The Work Big No Be Small’

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • ‘The Work Big No Be Small’
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Similar Material
  • ‘God Go Bless Person Wey No Dey Tight Hand’
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 November pp. 19-20
King David dey show one man the plan for the temple; one brother dey look the plan wey dey im hand

‘The Work Big No Be Small’

AS TIME reach for one important meeting for Jerusalem, King David come gather all the prince, the people wey dey work for im court, and all the strong men. E sweet dem to hear the special message wey King David tell dem. Jehovah don tell David sey na im pikin Solomon go build one mighty house wey dem go use worship am the way e want. David don give the plan of the house wey Jehovah give am to Solomon and and by this time, David don old. David talk sey: ‘The work big no be small, because the temple no be man own but na Jehovah God own.’​—⁠1 Chron. 28:​1, 2, 6, 11, 12; 29:⁠1.

David come ask this question, ‘Now who ready to come out come give Jehovah gift wey dey im hand?’ (1 Chron. 29:⁠5) If to sey you dey there, wetin you for do? You for join hand support this big work? Na so Israel people enter the work, and dem ‘happy well well sey dem take their mind give this things, because na all their mind dem take give Jehovah this things.’​—⁠1 Chron. 29:⁠9.

Many years after that time, Jehovah come bring wetin pass the temple wey Solomon build. E come arrange how human being fit take worship am because of Jesus sacrifice. This one be like big temple wey eye no fit see [the great spiritual temple]. (Heb. 9:​11, 12) Today, how Jehovah take dey help people make dem come back to am? Na our preaching work e dey use. (Matt. 28: 19, 20) Every year, this preaching work dey help us fit teach many many people the truth wey dey Bible. Many of dem dey baptize and we dey form plenty congregation.

As we dey plenty, we go need more book wey we take dey teach Bible, build more Kingdom Hall, maintain dem and buy more land to build Assembly Hall. You no think sey this preaching wey we dey do, na big work wey dey bring better gain?​—⁠Matt. 24:⁠14.

Na the love wey we get for God and our neighbor, and because na small time remain to preach, make us dey ‘come out, come give Jehovah gift wey dey our hand’ as we dey contribute to support im work. E dey sweet us to ‘serve Jehovah with the better things’ wey we get. And we still dey happy sey dem dey use all this things wey we dey contribute well, dem dey use am support the work wey dey important pass for this life!​—⁠Prov. 3:⁠9.

How Some People Take Dey Contribute To Support Jehovah Work

Today, many of Jehovah people dey ‘keep something’ or plan how much dem want give, and dem dey put am for the contribution box wey dem write “Worldwide Work.” (1 Cor. 16:⁠2) Every month, congregation dey send wetin dem see for inside the box go the branch office wey dey their country. You fit still send your contribution to Jehovah Witness branch office for your country. Abeg, call the branch office for your country if you want know how you go take contribute. You fit still see the address for www.jw.org. The kind contribution wey you fit send na:

CONTRIBUTION WEY BE GIFT

  • For this one, person fit use internet, ATM card or im phone take send money. For some country, person fit use jw.org or another website from the branch office.

  • Person fit contribute money, better earing, ring, necklace or other better better things wey e get. E go write letter to show sey e no dey borrow am to branch office but na gift.

CONTRIBUTION WEY PERSON FIT COLLECT BACK

  • Person fit contribute money, and talk sey branch office go give am back if e need am.

  • E go write am for letter sey if e need the money, branch office go return am.

OTHER WAY TO TAKE SUPPORT JEHOVAH WORK

Apart from money and other better things wey you fit contribute, other way still dey wey we fit use support Jehovah work. Na dem we want talk about. No matter how you want take contribute, abeg first ask the branch office wey dey your country to know how you go do am. Because every government get their law about tax, e good to ask lawyer or person wey fit advice you about tax matter before you choose how you go take contribute.

Insurance: This na contribution wey person go talk sey na Jehovah Witness branch office wey dey im country, go collect im life insurance or pension money.

Bank Account: This na contribution wey person go arrange with im bank sey if e die, make the bank give Jehovah Witness branch office for im country the money wey dey im bank account, or im pension money.

Shares, Stocks and Bonds: When person buy shares or e get stocks and bonds wey dey bring money for am, e fit contribute am as gift to Jehovah Witness branch office for im country, or e go write agreement sey make dem give am to the branch office when e die.

Land and House: Person fit contribute land or house as gift to Jehovah Witness branch office for im country. But for some people wey still dey stay for their house when dem make this kind contribution, na when dem die, the branch office go take am.

Wills and Trusts: Before person die, e fit use im lawyer write sey na Jehovah Witness branch office for im country, go get im money and property when e die.

All this way to take support Jehovah work wey we don talk about show sey for person to do this kind contribution, e must plan am well.

If you want know more, press “Contribute to Support the Work Wey We Dey Do for the Whole World” wey dey the bottom of the frist page for our website or ask the branch office for your country.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share