Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 April pp. 23-27
  • You Dey Copy How Jehovah Take Dey Judge Matter?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • You Dey Copy How Jehovah Take Dey Judge Matter?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • DEM BEND THE MATTER
  • JEHOVAH DEY JUDGE MATTER WELL
  • E GO HELP US IF WE CARRY BODY DOWN
  • ELDER WEY PRETEND
  • DEY FORGIVE
  • God Punish One Wicked Queen
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 April pp. 23-27
Apostle Peter dey chop with Christians wey be Jew for Antioch but e no dey chop with Christians wey no be Jew

You Dey Copy How Jehovah Take Dey Judge Matter?

‘I go tell people about Jehovah name. Im na God wey no dey fail person, wey no dey ever do partial.’​—DEUT. 32:3, 4.

SONG: 110, 2

HOW THIS BIBLE VERSE DEM FIT HELP US IF PEOPLE NO TREAT US WELL?

  • Deuteronomy 32:4

  • 1 Peter 5:5

  • Matthew 6:14

1, 2. (a) Wetin happen to Naboth and im children? (b) Which two character go help us copy how Jehovah take dey judge matter?

JUST think am sey this thing dey happen. Two bad people lie sey one man don curse God and their king. So people for the area come gather sey dem go kill the man and im children. As dem dey kill dem for wetin dem no do, how you think sey people wey hate partial go feel? E go don pain dem well well. The truth be sey, this one no be ‘story story.’ Na wetin happen to one man for Bible wey im name na Naboth. This man live for King Ahab time.—1 Ki. 21:11-13; 2 Ki. 9:26.

2 For this topic, we go talk about wetin happen to Naboth. We go still talk about the serious mistake wey one elder do for apostle dem time. Their example go teach us two character wey fit help us copy how Jehovah take dey judge matter. (1) We need to carry body down and (2) ready to forgive people for congregation wey no treat us well.

DEM BEND THE MATTER

3, 4. Which kind person Naboth be, and why e no gree sell im farm give King Ahab?

3 For Naboth time, many Israel people dey worship Baal like King Ahab and im wicked wife wey be Queen Jezebel. Dem no dey fear Jehovah or follow im law. But Naboth no be like dem. E love Jehovah and e ready to follow im law, even if e mean sey e go die.

4 Read 1 Kings 21:1-3. Ahab tell Naboth sey make e give am im farm so that e go give Naboth another better farm or money, if na that one e want. But Naboth no gree. Why e no gree? Na because e remember the law wey Jehovah give Israel people. Jehovah tell dem sey make dem no sell their family property give anybody. (Lev. 25:23; Num. 36:7) Na wetin make Naboth sofri tell Ahab sey: ‘E no go make sense at all for Jehovah side make I give you the property wey be my papa-papa own.’ Wetin Naboth talk show sey im na person wey really dey follow Jehovah law.

5. Wetin Jezebel do so that dem go kill Naboth?

5 Because Naboth no gree sell the farm, King Ahab and im wife come do wetin bad. Jezebel come arrange make people talk lie about Naboth so that im husband go fit collect the farm. Na that one come make dem kill Naboth and im children. Wetin Jehovah go do about this wicked thing?

JEHOVAH DEY JUDGE MATTER WELL

6, 7. How Jehovah take show sey e hate wetin Ahab do, and why this one come make Naboth family and im friend mind come down?

6 Jehovah no waste time send Elijah go meet Ahab. Elijah tell Ahab sey Ahab na thief and e don kill person wey no do anything. Na im make Jehovah talk sey Ahab, im wife and children go die the way Naboth and im children die.—1 Ki. 21:17-25.

7 Wetin Ahab do pain Naboth family and im friend dem well well. But their mind come down because dem know sey Jehovah see wetin happen and e no waste time judge the matter. E no too tey, something come happen wey go show whether dem really dey carry body down and whether dem trust Jehovah.

8. Wetin Ahab do as e hear wetin Jehovah talk, and wetin come happen?

8 When Ahab hear wetin Jehovah sey im and im family go suffer, e carry body down, come repent and e show sey e no happy for wetin e do. Wetin Jehovah do because of this one? Jehovah come tell Elijah sey: ‘Because e don carry body down for me, no be im time I go do wetin I sey I want do am. Na for im children time I go do am.’ (1 Ki. 21:27-29; 2 Ki. 10:10, 11, 17) Jehovah wey ‘dey see wetin dey person mind’ come pity Ahab.—Prov. 17:3.

E GO HELP US IF WE CARRY BODY DOWN

9. If Naboth family and friend dem dey carry body down, how e go take help dem?

9 How you think sey Naboth family and im friend dem go feel about this new message? E fit don hard dem small to agree with wetin Jehovah talk. But if dem be people wey dey carry body down, e go help dem. Dem no go stop to serve Jehovah and dem go still get the mind sey Jehovah no go ever do partial. (Read Deuteronomy 32:3, 4.) When Jehovah go bring people wey don die come life again, Naboth and im children go dey among dem. This one go show sey, true true, Jehovah na God wey dey judge matter well. (Job 14:14, 15; John 5:28, 29) Person wey dey carry body down suppose remember sey Jehovah ‘go judge everything wey people dey do, even the one wey dem hide do, whether e good or bad.’ (Eccl. 12:14) The thing be sey, Jehovah know everything wey concern any matter and e dey put am for mind when e dey judge. So, if we carry body down, e go help us continue to trust Jehovah.

10, 11. (a) Wetin fit make us no trust Jehovah and im organization again? (b) If we carry body down, how e fit help us?

10 If elders don agree for matter and you no like am or understand am, wetin you go do? For example, wetin you go do if you, your family person or your friend no come be elder, ministerial servant or pioneer for congregation again? What if dem disfellowship your husband, wife, pikin or friend and you no like am? Or what if you think sey elders don make mistake because dem no disfellowship person wey do bad? This kind thing fit make us no too trust Jehovah and im organization again. But if we carry body down, e go help us. How? Make we see two way.

The way elders judge one matter surprise one brother after dem announce am for congregation

If elders announce wetin dem don agree to do about matter and you no like wetin dem talk, wetin you go do? (Check paragraph 10, 11))

11 One thing be sey, if we dey carry body down, we go remember sey we fit no know everything about some matter. Even when we think sey we know everything, na only Jehovah know wetin dey person mind. (1 Sam. 16:7) When we put this one for mind, e go make us carry body down, help us remember sey no be everything we know, and help us change mind about the matter. Another thing be sey, if we dey carry body down, we go follow wetin elders talk, dey patient and wait make Jehovah correct the matter if any partial dey. Bible even talk sey: ‘Things go better for people wey dey fear the true God. But e no go better for wicked person, e go quick die.’ (Eccl. 8:12, 13) So wetin go better pass for everybody wey the matter concern, na to carry body down.—Read 1 Peter 5:5.

ELDER WEY PRETEND

12. Wetin we go talk about now, and why?

12 Something happen for the congregation wey dey Antioch for Syria wey show whether dem really dey carry body down and ready to forgive. Make we come talk wetin happen and how we fit use am check whether we ready to forgive. E go still help us see sey when we forgive, we dey copy how Jehovah take dey judge matter.

13, 14. Which work Jesus give apostle Peter, and wetin e do wey show sey e get mind?

13 Apostle Peter na elder wey people sabi for im time. E waka with Jesus and Jesus give am big work to do for congregation. (Matt. 16:19) For example, for 36 C.E., Peter do special work when e preach to Cornelius and everybody for im house. Why this one come be special work? Na because Cornelius no be Jew and dem no circumcise am. When Jehovah give Cornelius and people for im house holy spirit, Peter come ask sey: ‘Who fit talk sey make this people no baptize for water when God don already give dem im holy spirit as e take give us?’—Acts 10:47.

14 For 49 C.E., the apostle and elder dem for Jerusalem gather to talk whether people wey no be Jew suppose circumcise as dem don be Christian. For there, Peter gather mind tell the brothers sey Jehovah don first give holy spirit to people wey no circumcise. The apostle and elder dem come choose the correct thing because Peter tell dem wetin e use im two eye see. (Acts 15:6-11, 13, 14, 28, 29) Everybody for the congregation that time, whether dem be Jew or dem no be Jew go don happy well well with wetin apostle Peter do. E go don easy for dem to fit trust am because im na elder wey dey follow wetin Jehovah talk!—Heb. 13:7.

15. Which mistake Peter make when e dey Antioch for Syria? (Go check the first picture.)

15 Small time after that meeting wey dem do for 49 C.E., Peter go Antioch wey dey Syria. For there, e dey do things with brothers wey no be Jew. Dem go don happy to learn from wetin Peter don suffer and wetin e tell dem. But before dem know, Peter just stop to chop with dem! How you think sey dem go feel? E go don surprise and pain dem well well. Other brothers wey be Jew and even Barnabas, come dey do like Peter. Why Peter come do this kind serious thing wey fit scatter congregation? Wetin we fit learn from Peter mistake wey go help us if elder do or talk wetin pain us?

16. How apostle Paul take correct Peter, and which question person fit ask?

16 Read Galatians 2:11-14. Even though sey na Peter Jehovah use help people wey no be Jew to be Christian, Peter come dey fear wetin people go talk. (Prov. 29:25) E dey fear sey the brothers wey come from Jerusalem wey be Jew no go happy sey e dey chop with people wey no be Jew. Apostle Paul dey when dem do the meeting for Jerusalem for 49 C.E. E come let Peter know sey na pretend e dey pretend. (Acts 15:12; Gal. 2:13, ftn.) Wetin the brothers wey Peter treat like this go do? E go make dem stop to serve Jehovah? This mistake go make Jehovah no use Peter do Im work again?

DEY FORGIVE

17. Wetin Peter gain because Jehovah forgive am?

17 Peter carry body down, e listen to wetin apostle Paul talk. No where for Bible wey show sey Jehovah stop to use Peter do Im work. The truth be sey, Jehovah later use am write two book for Bible. For the second book, e talk better thing about Paul. E talk sey Paul na im brother and e love am. (2 Pet. 3:15) Even though sey wetin Peter do go don pain the brothers wey no be Jew, Jesus wey be head for congregation still use am. (Eph. 1:22) Brothers and sisters for the congregation go don see this one as chance to copy how Jehovah and Jesus take dey forgive. E good sey, dem no let wetin Peter do make dem stop to serve Jehovah.

18. Which time we fit copy how Jehovah take dey judge matter?

18 Elders for congregation that time make mistake and na so e still be with elders today. No wonder Bible talk sey ‘all of us dey make mistake many times.’ (Jas. 3:2, ftn.) We fit agree with wetin Bible talk, but wetin we go do if brother or sister do wetin pain us? We go copy how Jehovah take dey judge matter? For example, wetin you go do if elder talk something wey be like sey e dey do partial? You go stop to serve Jehovah because elder talk wetin pain you? Instead of you to dey think sey the brother no suppose be elder again, you ready to wait make Jesus wey be head for congregation handle the matter? You go still dey carry wetin the brother do for mind or dey think about how e don take serve Jehovah all this years? If the brother wey do wetin pain you still be elder or dem come even give am more work for congregation, you go happy? If you ready to forgive, e go show sey you dey copy how Jehovah take dey judge matter.—Read Matthew 6:14, 15.

19. Before Jehovah go comot Satan and this wicked world, wetin we suppose get for mind to do?

19 People wey hate partial, dey wait for the time wey Jehovah go comot Satan and im wicked world wey don make many people suffer for wetin dem no do. (Isa. 65:17) Before that time, make we dey copy how Jehovah take dey judge matter. Make we no forget sey we fit no know everything about some matter. So, when person do us bad, make we use all our mind forgive am.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share