How to Get Real Freedom
“If the Son make una free, una go really dey free.”—JOHN 8:36.
1, 2. (a) Wetin show sey people really want dey free? (b) But wetin don dey happen because of this one?
TODAY, many people for the world dey talk sey everybody suppose get the same right and freedom. Some of dem no want make oppression, partial, and poverty, dey again. Other people want dey free to talk wetin dem like, to choose anything wey dem like, and to live the way dem want. So e clear sey everybody want get freedom.
2 Wetin people dey do to get the freedom wey dem want? Some of dem dey come out to talk sey dem no go gree, dem dey riot, and even try to change their government. But dem dey really get wetin dem want? No. Instead, people dey suffer more more and even die from wetin dem dey do. All this one show sey wetin King Solomon talk for Bible na true. E sey: “Man don control man enter wahala.”—Eccl. 8:9.
3. Wetin we fit do to really dey happy and enjoy life?
3 The disciple wey im name na James, talk wetin we go do to really dey happy and enjoy life. E sey: “The person wey dey really check the correct law wey dey give freedom, and e continue to follow am, go happy for wetin e dey do.” (Jas. 1:25) The correct law come from Jehovah. And na im know wetin go really give us happiness and make our mind come down. E give Adam and Eve freedom and other things wey go make dem happy.
THE TIME WEY HUMAN BEING REALLY DEY FREE
4. Which freedom Adam and Eve get? (Go check the first picture.)
4 For Genesis chapter 1 and 2, we see sey Adam and Eve get the kind freedom wey people dey find today, but dem never fit get am. Adam and Eve get everything wey dem need, dem no dey fear anything, and nobody oppress dem. Food no be their problem, and dem get work. Dem no dey worry about sickness and death because e no dey that time. (Gen. 1:27-29; 2:8, 9, 15) This one come mean sey Adam and Eve dey free to do anything wey dem like? Make we see.
5. Wetin people really need to get freedom?
5 Many people think sey for person to dey free, e need to fit do anything wey e want do, even if na bad thing go come out of am. The World Book Encyclopedia talk sey freedom na “when person fit choose wetin e want and do am.” But e still sey people dey free if government no put law wey no make sense, wey partial dey inside, or wey people no need. This one mean sey, people need better law to get freedom. But the question be sey: Who get the right to give people law wey correct, wey dem need, and wey make sense?
6. (a) Why e be sey na only Jehovah get right to do anything wey e want? (b) Which kind freedom human being fit get, and why?
6 E good make we get am for mind sey na only Jehovah get right to do wetin e want. And na im still get right to talk sey something good or bad. Why? Because na im make everything and na im be the King wey high pass. (1 Tim. 1:17; Rev. 4:11) King David use better better word take talk about the kind position wey only God get. (Read 1 Chronicles 29:11, 12.) But angels and human being no get the kind freedom wey Jehovah get. Dem get where dem suppose do reach. Dem need to know sey na only Jehovah get the right to give dem law wey correct, wey dem need, and wey make sense. And na wetin Jehovah do when e make Adam and Eve.
7. Wetin be some things wey our body need and wey dey make us happy when we dey do dem?
7 Adam and Eve first get freedom. But, e still get things wey dem no suppose do, and things wey dem suppose do. Some of this things just dey normal for dem. For example, dem know sey for dem to continue to live, dem need to breath, chop, sleep, and do other things. Because dem dey do this things, e come mean sey dem no dey free? No. Jehovah make dem so that as dem dey do this things dem go happy and enjoy life. (Ps. 104:14, 15; Eccl. 3:12, 13) All of us dey enjoy to breath fresh air. E dey sweet us when we dey chop our best food. And belle dey sweet us after we sleep better sleep. All this kind things no be work for us. We dey happy to do dem. Na so Adam and Eve go don feel about this things.
8. Wetin God tell Adam and Eve, and why?
8 Jehovah tell Adam and Eve to born children so that people go full the earth. E still tell dem to take care of the earth. (Gen. 1:28) This thing wey Jehovah tell dem go make dem no dey free again? No be so! Instead, e go make dem to fit turn the whole earth to paradise, where people wey no get sin go stay forever. Na wetin God get for mind be that. (Isa. 45:18) Today, if person sey e no want marry or born pikin, e no mean sey e no dey obey God. But, many people dey marry and born children, even though sey some kind problem dey follow am. (1 Cor. 7:36-38) Why e be like that? Because dem know sey this things na part of wetin dey make person happy and enjoy life. (Ps. 127:3) If Adam and Eve obey God, dem for enjoy their marriage and their family for happy forever.
HOW DEM TROWEY THE FREEDOM WEY GOD GIVE DEM
9. Why e be sey wetin God tell Adam and Eve for Genesis 2:17 dey correct, dem need am, and e make sense?
9 Jehovah still tell Adam and Eve another thing, and e tell dem wetin go happen if dem no follow am. E sey: “Make you no chop from the tree wey dey make person sabi wetin good and wetin bad, because the day wey you chop am, you must die.” (Gen. 2:17) Wetin God tell dem no correct? Dem no need am? E no make sense? Or, e mean sey dem no get freedom again? No! The truth be sey, many people wey sabi Bible matter talk sey, sense dey wetin God tell Adam and Eve. For example, one of this people talk sey: “From wetin God talk for [Genesis 2:16, 17] e show sey na only God know wetin good . . . for human being and na only God know wetin no good . . . for dem. To fit enjoy wetin ‘good,’ human being must trust God and obey am. If dem no obey am, na dem go take their hand choose wetin good . . . and wetin no good.” That one na heavy load wey human being no fit carry by theirself.
Wetin Adam and Eve do bring wahala! (Check paragraph 9-12)
10. Why e be sey for person to fit do wetin e want, and to get the right to talk sey something good or e bad, na two different things?
10 When people read wetin Jehovah tell Adam, many of dem fit talk sey God no give Adam freedom to fit do wetin e want. But dem no know sey for person to fit do wetin e want, and to get the right to talk sey something good or e bad, na two different things. God allow Adam and Eve to choose whether dem go obey am or dem no go obey am. But na only Jehovah get the right to talk sey something good or e bad. Na wetin “the tree of knowledge of good and bad” go don make Adam and Eve understand. (Gen. 2:9) We no dey always know wetin go come from wetin we choose. And we no fit know whether wetin we choose go always favor us. No wonder, many times, we dey see people wey take better mind choose something but better thing no come out. Instead, na suffer, wahala, and other bad things dey happen. (Prov. 14:12) E clear sey no be everything we fit do. Wetin Jehovah tell Adam and Eve teach dem how to use their freedom well. Why e be like that? Dem hear wetin God tell dem?
11, 12. Why e be sey wetin Adam and Eve choose, bring wahala? Use example talk am.
11 Adam and Eve no follow wetin Jehovah talk. Eve follow wetin Satan talk when e sey: “Una eye go open and una go be like God, come sabi wetin good and wetin bad.” (Gen. 3:5) Wetin Adam and Eve do make dem get more freedom? No. Wetin dem choose no make dem get wetin Satan talk. Dem come see sey if person no follow wetin Jehovah talk, na only bad thing go come out. (Gen. 3:16-19) Why e be like that? Na because Jehovah no give human being right to choose wetin good and wetin bad by theirself.—Read Proverbs 20:24 and footnote; Jeremiah 10:23.
12 Make we use one example talk am. If pilot want carry im plane reach where e dey go, e go need to follow where dem sey make e pass. And e go still use the things for the plane wey go help am know where e dey go. E go listen to people wey their work na to direct am. But if e no listen to wetin dem tell am, and e come dey fly go anywhere wey e like, e fit enter wahala. Like that pilot, Adam and Eve want do wetin dey their mind. Dem no gree follow wetin God tell dem. Wetin come happen? Dem put theirself and everybody for wahala. Na im make sin and death come dey. (Rom. 5:12) Because dem want choose wetin good and wetin bad by theirself, dem come trowey the freedom wey Jehovah give dem.
HOW TO GET REAL FREEDOM
13, 14. How we fit get real freedom?
13 Some people think sey e go better if dem allow dem do anything wey dem like. But na so e really be? Na true sey e get many better things wey person fit do if e dey free. But how you think sey the world for be if dem dey allow people do anything wey dem like? The World Book Encyclopedia talk sey the law wey dey different different place dey give people freedom, and e still dey tell dem where dem go do reach. This one no easy at all. Na im make law plenty. And na im still make lawyer and judge plenty, because na dem go explain the law and use am judge matter.
14 But Jesus Christ talk about one simple way to take get real freedom. E sey: “If una continue to dey do wetin I dey tell una, e go show sey una really be my disciple, and una go know the truth, and the truth go free una.” (John 8:31, 32) Na two things Jesus talk sey we need to dey free. (1) We go follow the truth wey e teach, and (2) we go become im disciple. Na when we do this things we go really dey free. But wetin we go free from? Jesus talk sey: “Anybody wey dey do bad things na slave to sin. . . . If the Son make una free, una go really dey free.”—John 8:34, 36.
15. Why the freedom wey Jesus talk about fit make us “really dey free”?
15 E clear sey, the freedom wey Jesus promise im disciples better well well pass the kind freedom wey many people want today. Which kind freedom Jesus dey talk about when e sey, “If the Son make una free, una go really dey free”? The worst thing wey don make human being slave na sin. So Jesus dey talk sey we go dey free from sin. Sin fit make us dey do bad things. Apart from that one, e fit make us no do wetin we know sey correct, or wetin we know sey we fit do. Na this one make all of us be slave to sin. Sin dey cause pain, e dey make life tire person, e dey cause suffer suffer, and later death go follow. (Rom. 6:23) Wetin apostle Paul talk show sey e really feel the kind pain wey sin dey cause. (Read Romans 7:21-25.) Na only when sin no dey again we go get the kind freedom wey Adam and Eve first get.
16. How we fit really dey free?
16 Wetin Jesus mean when e talk sey, “If una continue to dey do wetin I dey tell una”? Wetin e talk show sey, for am to give us freedom, e get things wey we go do, and things wey we no suppose do. Because we don give our life to God, we no dey do wetin we want. And since we be Jesus disciple, we dey use our mind follow the things wey e teach. (Matt. 16:24) Just as Jesus promise, we go really dey free for future. That time, we go don get all the gain from Jesus sacrifice.
17. (a) Wetin go make us happy and enjoy life? (b) Wetin we go talk about for the next topic?
17 As Jesus disciple, if we want happy and enjoy life, make we dey follow wetin Jesus talk. If we do this one, we get hope sey for front, we go dey free from sin and death kpatakpata. (Read Romans 8:1, 2, 20, 21.) Jehovah na the God wey dey give real freedom. So how we fit use our freedom well to make Jehovah happy? We go talk about am for the next topic.