Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb17 September p. 2
  • Why You Value as You Dey Serve Jehovah?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Why You Value as You Dey Serve Jehovah?
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
  • Similar Material
  • Dem Go Worship Jehovah Well Again!
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
mwb17 September p. 2

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

Why You Value as You Dey Serve Jehovah?

The vision wey Ezekiel see about the temple, really make Israel people happy. That time, dem be slave for Babylon. E give dem hope sey dem go serve Jehovah well again. For this last days, ‘the mountain of Jehovah house don stand well, e don high pass other mountain dem.’ We dey among the people from different different country wey don gather come. (Isa 2:⁠2) You dey always think about the better chance wey Jehovah don give you to know and serve am?

THINGS WEY WE DEY ENJOY AS WE DEY SERVE JEHOVAH:

  • One brother dey read the Bible

    Jehovah dey teach us well. We don know wetin Bible talk about question wey still dey worry many people. We don learn how to live better life, and we get hope sey our tomorrow go better.​—Isa 48:​17, 18; 65:13; Ro 15:4

  • We don get brothers and sisters for the whole world wey love us and wey dey follow us worship Jehovah.​—Ps 133:1; Joh 13:35

  • We dey enjoy Jehovah favor as we dey do the preaching work now.​—Acts 20:35; 1Co 3:9

  • Jehovah dey make our mind come down when we get problem.​—Php 4:​6, 7

  • Our mind dey clean.​—2Ti 1:3

  • We and Jehovah don be tight friend.​—Ps 25:14

How I go take show sey I value as I dey serve Jehovah?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share