Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 April pp. 31-32
  • Your Preaching Be Like Dew?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Your Preaching Be Like Dew?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • HOW OUR PREACHING FIT BE LIKE DEW?
  • NO TAKE YOUR PREACHING PLAY
  • You Still Remember?
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 April pp. 31-32
Picture of one Jehovah Witness wey dey preach to one man and two of dem be like people wey dey inside drop of water

Your Preaching Be Like Dew?

OUR work to preach no be wetin person dey take play. But no be everybody wey we preach to, dey see am like that. Even if people like the things wey dey Bible, dem no really see wetin go mek dem study Bible with us.

Gavin story na example of wetin we dey talk. E dey come meeting for Kingdom Hall, but e no want mek anybody study Bible with am. E sey e no too sabi Bible like that and e no want mek other people know sey e no too sabi. E no want mek person come tell am sey mek e be their church member. E no want mek dem deceive am. How you see this kind thing? You think sey e go easy to start study with Gavin? The things wey dey Bible fit help person. Na im mek Jehovah tell Israel people sey: ‘Wetin I talk go dey fall like dew, like when rain dey fall small small on top grass.’ (Deuteronomy 31:​19, 30; 32:⁠2) Mek we come learn some things about dew. And we go learn how our preaching take be like dew, so that we go fit help different different people.—1 Timothy 2:3, 4.

HOW OUR PREACHING FIT BE LIKE DEW?

Dew dey take sofri fall. Dew dey form small small, when breeze don cold reach when e dey turn to small small drop of water. How e be sey the things wey Jehovah talk come dey ‘fall like sey na dew’? God use love and e sofri talk to im people. We go show sey we dey do like God when we no dey condemn wetin other people believe. We go help dem see wetin mek us believe wetin we believe, so that dem fit choose by their self wetin dem go believe. When we show sey we want help people like this, dem go want hear wetin we dey tell dem. And this one go mek our preaching touch people mind.

Dew dey cool body. Our preaching go cool people body, if we dey think different different way wey we go use take help dem learn the truth wey dey Bible. Na one brother wey im name be Chris, first tell Gavin sey e want study Bible with am. Chris no force am study. But e try different different way to see which one go good pass for Gavin so that e go gree study Bible. Chris tell am sey e get one topic wey Bible dey always talk about. E still tell Gavin sey, if e fit sabi this topic, that one go help am fit know about our meeting pass as e know before. Chris still tell Gavin sey the things wey Bible talk sey go happen, na im help am believe wetin Bible talk. Because of that one, two of dem come dey talk about other things wey happen as Bible talk sey e go happen. The talk come mek Gavin mind finally come down. E come gree to study Bible.

Dew good for life. For dry season when every where dey hot for Israel, many months fit pass and rain fit no fall. If the water wey dew dey bring no dey, plant go die. Jehovah don talk am sey, for this our time, e go be like sey na dry season we dey. This one mean sey e go dey hungry people to hear wetin Jehovah talk. (Amos 8:11) But e come promise sey the people wey e don select go be ‘like dew wey come from Jehovah’ as ‘other sheep’ dey follow dem dey preach the good news about God kingdom. (Micah 5:7; John 10:16) The message wey we dey preach na one of the things wey Jehovah don bring, so that people wey truth dey hungry go get life. We dey take this message play?

Jehovah take dew bless us. (Deuteronomy 33:13) Our preaching fit be blessing, or gift, to the people wey gree hear am. Gavin get all the answer to im question because e gree study Bible. This one na blessing for am. E do wetin e learn and e come baptize. Now im and Joyce, im wife, dey happy to dey preach the good news about God Kingdom.

Jehovah Witness dey preach to people for bus stop

Jehovah Witness people dey preach the good news about God Kingdom for everywhere for this world

NO TAKE YOUR PREACHING PLAY

If we dey see our preaching like dew, e go help us see sey the time and power wey all of us take dey preach, one one, no be for nothing. How? Because one drop of water no be anything, but if e come plenty well well the whole ground go soak. Na so e still be with our preaching, wetin one person fit do for preaching fit dey small for our eye. But as all of us wey dey serve Jehovah dey join hand for this preaching, e dey mek the whole world fit hear the good news about God Kingdom. (Matthew 24:14) We go let Jehovah use our preaching take bless other people? Yes o! Our preaching go be like dew, wey dey cool body and wey good for life!

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share