Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 August pp. 18-19
  • Find Wetin Better Pass Gold

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Find Wetin Better Pass Gold
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • YOU SEE ONE!
  • YOU COME SEE MORE!
  • NO STOP TO FIND!
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 August pp. 18-19
People wey their work na to find gold, dey find gold

Find Wetin Better Pass Gold

You don ever find gold before, come see am? People wey don see am no plenty. But many people for this world don see wetin better pass gold. Wetin be that? Na the sense wey God dey give, wey ‘original gold’ no fit buy.—Job 28:12, 15.

WE FIT talk sey person wey like wetin dey Bible be like person wey dey find gold. How? That person go work well well and e no go stop to find the better things wey dey inside Bible, wey money no fit buy. Make we see three things wey we fit learn from how people dey find gold.

YOU SEE ONE!

Think am sey you dey waka near river. You come see something wey be like small stone wey dey shine. As you bend down to check am, you come see sey na gold. Na so you jump up dey happy! The gold small pass one stick of matches head and e scarce pass original diamond. Na im you come check the place whether you go see more.

Na so e still be that day wey one Jehovah Witness first preach to you. Maybe you still remember the first truth wey you learn from Bible, wey be like gold. E fit be that first time wey you see God name, Jehovah inside Bible. (Ps. 83:18) Or that time wey you learn sey you fit be Jehovah friend. (Jas. 2:23) You no waste time tell yourself sey: “Ah! I don see wetin better pass gold!” E come dey hungry you to see more, so you start to check.

YOU COME SEE MORE!

Sometimes, small small pieces of gold fit mix with sand sand and stone for river. People wey dey find gold go dey pick am small small for the different place wey e gather. After some months, dem go don gather gold reach the one wey dem fit sell for plenty dollar.

When you start to study Bible with Jehovah Witness people, you fit see yourself like that person wey dey pick gold comot from where e mix with sand sand and stone. When you come dey think about wetin you learn for Bible, small small wetin you learn come dey plenty and you come sabi Bible. As you dey think about wetin you dey learn, e hungry you to learn more. You come learn how to near Jehovah. You still learn wetin go make am love you and help you get life wey no go end.—Jas. 4:8; Jude 20, 21.

One brother dey do personal Bible study

Like person wey dey find gold, you dey work well well to find the better things wey dey inside Bible?

Person wey dey find gold dey work well well to get am. E fit be sey na so you still study Bible well well to fit get the better things wey dey inside. The main things wey you learn from Bible fit follow for wetin help you tell Jehovah for prayer sey you want serve am; na im you come baptize.—Matt. 28:19, 20.

NO STOP TO FIND!

Person wey dey find gold fit see small small pieces for inside stone. Some part for this kind stone get gold pass other part for the stone. But the gold wey dey the body, reach for the person to scatter am make e fit get the gold. When you first see the stone, you no go know sey gold dey the body. Why e be like that? Because the gold wey dey the body no heavy reach one tablespoon of salt! But, for person wey dey find gold, even as the gold small reach, e go still scatter the stone to get the gold.

Na so person go still dey try, even if e ‘don grow pass the first things wey dem teach about Christ.’ (Heb. 6:1, 2) From your Bible study, you go need to work well well to learn new things wey go help you. So wetin you fit do to make sure sey you dey gain from your personal Bible study, even if e don tey wey you start to study Bible?

Make you still dey hungry to learn wetin dey Bible. No comot eye for anything wey you dey learn, even if e be like sey e small. No stop to study and you go get the sense wey God dey give, wey be like gold, wey go guide you. (Rom. 11:33)The things wey we dey use do research wey dey your language, use am well. E go help you learn more things. Take time find the advice wey you need and use Bible take find answer for all your question. Ask other people which Bible verse and topic wey don help dem. Tell people about the things wey you don learn as you dey study Bible.

No be sey you dey learn all this things just to sabi. Apostle Paul warn us sey, ‘to sabi dey make person raise shoulder.’ (1 Cor. 8:1) So, work well well so that you no go dey carry shoulder and your faith go strong. If you dey do family worship and personal study every time, you go fit dey do wetin Jehovah want and you go want help other people. On top all this one, you go happy sey you don find wetin better pass gold by far!—Prov. 3:13, 14.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share