Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 December pp. 19-23
  • Tell Jehovah All the Things Wey Dey Worry You

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Tell Jehovah All the Things Wey Dey Worry You
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • ‘THROW THE LOAD GIVE JEHOVAH’
  • BIBLE DEY MAKE OUR MIND COME DOWN
  • BETTER CHARACTER WEY GOD SPIRIT DEY GIVE
  • ‘NO WORRY AT ALL’
  • NO KEEP YOUR PROBLEM FOR MIND
  • YOU GO DEY STRONG IF YOU NEAR JEHOVAH
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 December pp. 19-23
The different different problem wey one brother dey think about, dey worry am for mind

Tell Jehovah All the Things Wey Dey Worry You

‘Throw all the things wey dey worry una give [Jehovah], because e dey care for una.’​—1 PET. 5:7.

SONG: 60, 23

YOU GO FIT EXPLAIN?

  • How Bible fit make our mind come down?

  • How you fit get ‘the peace wey God dey give’?

  • How congregation fit help you make you no too dey worry?

1, 2. (a) Why e no go surprise us sey things fit worry us for mind? (Check the first picture.) (b) Wetin we go talk about for this topic?

LIFE no easy this days. Satan wey be the Devil dey vex well well and e ‘dey waka up and down like lion wey dey hungry dey find person wey e go chop.’ (1 Pet. 5:8; Rev. 12:17) So e no surprise us sey sometimes, some things fit dey worry some of Jehovah people for mind. E happen to Jehovah people for olden days. For example, Bible talk sey e get sometimes wey King David mind disturb am. (Ps. 13:2) Still remember sey, apostle Paul talk for Bible sey e ‘dey worry about all the congregation.’ (2 Cor. 11:28) But wetin we fit do if the things wey dey make us worry don pass our power?

2 Our Papa wey dey heaven don show sey e love im people for olden days when e help dem. E still dey help us make we no too dey worry today. Bible advise us sey: ‘Throw all the things wey dey worry una give am, because e dey care for una.’ (1 Pet. 5:7) How you fit do wetin that Bible verse talk? We go talk about four way wey you fit do am. (1) Dey use all your mind pray, (2) dey read Bible and think well about wetin you dey read, (3) dey beg Jehovah make e give you im holy spirit, and (4) tell better friend wey you trust about wetin dey worry you for mind. As we dey talk about this four way, see how you go take use any of dem for your life.

‘THROW THE LOAD GIVE JEHOVAH’

3. How prayer fit help you ‘throw the load wey dey heavy you give Jehovah’?

3 The first thing wey we go do na to tell Jehovah how the thing dey worry us reach. When things start to worry you, your Papa wey dey heaven wey love you, want make you tell am your mind. King David beg Jehovah for Psalm 55:1 sey: ‘Hear my prayer, O God.’ E come talk for verse 22 sey: ‘Throw that load wey dey heavy you give Jehovah, and e go help you.’ (Ps. 55:1, 22) After you don do everything wey you fit do about the problem, tell Jehovah your mind for prayer. This one better pass to let the the problem continue to dey worry you. But how prayer fit help you when your mind no settle and when things don dey worry you for mind?​—Ps. 94:18, 19, ftn.

4. Why e good make we pray when things start to worry us for mind?

4 Read Philippians 4:6, 7. When we dey try to use all our mind pray to Jehovah and we no tire to pray to am, e go fit answer us. How? E go give us rest of mind wey go fit make our mind come down and help us forget wetin dey worry us. This kind thing don happen to many brothers and sisters before. Instead make the problem dey make dem fear or worry, God make their mind come down and e give dem peace wey pass anything wey person fit think of. God fit still help you as e help dem. The ‘peace wey God get’ fit help you handle the problem well. Jehovah dey feel for you, so you fit believe wetin e promise for Bible, when e sey: ‘No worry because I be your God. I go make you strong, yes, I go help you.’​—Isa. 41:10.

BIBLE DEY MAKE OUR MIND COME DOWN

5. How Bible fit make our mind come down?

5 The second thing wey fit help us make we no dey worry too much na, to dey read Bible and think well about wetin we dey read. Wetin make am good? Wetin dey Bible fit help you live your life well, help you make you no put hand for things wey fit bring problem, and help you make you no too dey worry. No still forget sey na God get Bible and the advice wey dey inside go make you wise. As you dey think well about the things wey you dey read for Bible, dem go make you strong. Whether na for night or day, think about how you go take follow the advice wey you read for Bible. Jehovah talk sey if we dey read im Word, we go ‘get mind and dey strong.’ Fear no go kill us.​—Josh. 1:7-9.

6. How the thing wey Jesus talk fit help you?

6 For Bible, we see sey Jesus talk wetin touch people mind. Wetin e teach people dey make their mind come down. E dey sweet many people to near am because e dey tell dem wetin dey make their mind come down and wetin dey make dem strong. (Read Matthew 11:28-30.) The love wey e get for people dey make am think about how e go take teach dem God word, how dem dey feel, and wetin dem need. (Mark 6:30-32) Jesus still promise sey e go help us today, as e take help the apostles wey dey follow am waka that time. You no need to dey with Jesus before e go fit help you. As our King wey dey heaven, e never stop to help us and to show sey wetin dey pain us dey pain am too. So because e dey pity us when things start to worry us for mind, e ‘go fit help us’ ‘when we need help.’ Jesus go make your mind strong and e go give you hope. True true, wetin Jesus talk fit help you handle problem wey dey disturb you.​—Heb. 2:17, 18; 4:16.

BETTER CHARACTER WEY GOD SPIRIT DEY GIVE

7. How you fit gain from the holy spirit wey God go give you?

7 Jesus promise for Bible sey our Papa wey dey heaven go give holy spirit to people wey dey beg am. (Luke 11:10-13) God dey use im holy spirit dey give us fine fine character. This character dey help us handle problem wey dey worry us. Na this one be the third way wey God dey take help us. This fine character wey the holy spirit dey help us get, really show the kind person wey Jehovah be. (Read Galatians 5:22, 23; Col. 3:10) This character need to dey show for the things wey we dey do. If e be like that, people go like to near us. You go come see sey many things wey fit make you worry no go happen. Make we see how the spirit fit help you.

8-12. How God holy spirit fit help you handle or comot hand from things wey fit disturb your mind?

8 ‘Love, joy, peace.’ When you dey try to respect people, you fit come see sey e go help you make you no dey feel bad. How? When you dey show your brothers and sisters sey you love and respect dem, you no go do things wey go bring wahala.​—Rom. 12:10.

9 ‘To dey patient, to get better mind, to dey good.’ Bible talk sey: ‘Get better mind for each other, dey get mind to pity, dey forgive each other well well.’ (Eph. 4:32) If you do wetin dey this Bible verse, you go fit live well with people and peace go dey. Things wey fit make you worry no go too dey happen. And you go fit handle problem wey you and person get because of the sin wey dey our body.

10 ‘Faith.’ Many times, our mind no dey settle because we fit dey think about how to get money and property. (Prov. 18:11) But, when you get strong faith sey Jehovah go take care of you, you no go worry too much; or you fit no even worry at all. How e go take happen? You fit stop to dey worry about many things if you follow wetin apostle Paul talk for Bible. E sey: ‘Make wetin una get dey reach una. Because [God] don talk sey: “I no go ever leave you, and I no go ever forget you.” So that we fit get strong mind to talk sey: “Na Jehovah dey help me; I no go fear. Wetin person fit do me?” ’—Heb. 13:5, 6. 

11 ‘To dey gentle, to get self-control.’ To dey gentle with people and to fit dey control yourself dey good. E go help you no put hand for things wey fit disturb your mind. Na you go gain if you no ‘carry any bad mind, get hot temper, dey vex, dey shout and dey curse.’​—Eph. 4:31.

12 Make you no dey carry shoulder up so that you fit let ‘God strong hand’ help you and you fit ‘throw all the things wey dey worry you give am.’ (1 Pet. 5:6, 7) When you dey show sey you no dey carry shoulder up, God go support and show you favor. (Mic. 6:8) And when you know sey e get wetin you fit do and wetin you no fit do, e go help you no disturb yourself too much. This one go make you allow God help you.

‘NO WORRY AT ALL’

13. Wetin Jesus mean when e talk sey: ‘No worry at all’?

13 Jesus give us better advice for Matthew 6:34 (read). E sey: ‘No worry at all.’ But sometimes, e fit no easy to follow that advice. Wetin Jesus mean when e talk sey: ‘No worry at all’? E no mean sey nothing fit worry person wey dey serve God. We don already learn sey e get sometimes wey things worry David and Paul for mind. But Jesus help im disciples know sey no be when dem let things wey no suppose worry dem disturb dem, or when dem over worry, na im the problem go end. Every day get im own problem. So, make we no let problem wey don happen or wey never happen, come dey worry our mind join today own. How you fit do wetin Jesus talk, wey go help you no too worry?

Some Things Wey We Fit Do Make Things No Too Worry Us

  • Things wey you fit do

    First dey do things wey get value.

    PHILIPPIANS 1:10, 11

  • Person wey carry load wey pass am

    Know where your power reach.

    ECCLESIASTES 7:16

  • No use phone

    Get time wey you take dey relax every day.

    MATTHEW 14:23

  • Flower

    Dey enjoy the things wey Jehovah make.

    PSALM 104:24, 25

  • Face wey dey smile

    Dey enjoy funny things.

    PROVERBS 17:22

  • Person wey dey run

    Dey do exercise.

    1 TIMOTHY 4:8

  • Person wey dey sleep

    Dey sleep well.

    ECCLESIASTES 4:6

14. Wetin fit help you when your mind dey worry you because of wetin you do before?

14 Some people mind dey worry dem because of wetin dem don do before. Even if e don tey when e happen, their mind fit still dey judge dem. E get sometimes wey King David feel sey ‘all im sin don plenty for im head.’ E talk true, sey: ‘The pain wey I dey feel for my heart dey make me cry come out.’ (Ps. 38:3, 4, 8, 18) For that kind condition, wetin David go do to show sey e wise? E trust Jehovah sey E go show am mercy and E go forgive am. Because e dey sure sey Jehovah don forgive am, e sey: ‘The person wey dem don forgive im mistake dey happy.’​—Read Psalm 32:1-3, 5.

15. (a) Why you no suppose dey worry because of wetin you dey face now? (b) Wetin you fit do wey go make your mind no too worry you? (Check the box “Some Things Wey We Fit Do Make Things No Too Worry Us.”)

15 For some of us, our mind fit dey worry us because of wetin we dey face now. For example, when David write Psalm 55, e dey fear sey dem want kill am. (Ps. 55:2-5) But e no allow the fear make am stop to dey trust Jehovah. E pray well well to Jehovah make e help am. But e still know sey e suppose do wetin e fit do to make im mind come down. (2 Sam. 15:30-34) You fit learn from David example. Instead wey you go let problem over worry you, do wetin you fit do to handle the problem. And leave the matter for Jehovah hand because you trust am.

16. How the meaning of God name fit make your faith strong?

16 If we dey think about problem wey never happen, e fit make some of us dey worry. But, you no need to dey worry about wetin never happen. Why? Because e fit no bad reach as you think. Apart from that one, e no get any problem wey big pass Jehovah, the Person wey fit help you for any problem wey you get. Im name mean ‘E Dey Make Anything Be.’ (Ex. 3:14) The meaning of God name make us dey sure sey God no dey fail to do wetin e get for mind for im servant. You fit dey sure sey God go bless im servant and e go help dem make dem no too worry about any problem wey don happen before, wey dey happen now, or wey fit happen for front.

NO KEEP YOUR PROBLEM FOR MIND

17, 18. If you talk to person wey you trust about wetin dey disturb you, how that one fit help you?

17 The fourth thing wey fit help you make you no worry too much, na to talk to person wey you trust. This person fit be your husband or wife, friend wey near you, or elder for congregation. E fit tell you wetin go make your mind come down and wetin go help you. Bible talk sey: ‘Things wey dey worry person for mind dey make am weak but better word dey make am happy.’ (Prov. 12:25) Make you no hide how you dey feel so that you go fit understand and handle the problem well. Na im make Bible talk sey: ‘Plan dey fail when advice no dey, but wetin you plan go get head if plenty people advise you.’​—Prov. 15:22.

18 Jehovah still dey use our meeting for congregation dey help us make we no too dey worry. For there, you go see people wey get better thing for mind for you and wey fit help you. (Heb. 10:24, 25) Dem go fit talk wetin go help you continue to serve Jehovah and wetin go help you no too worry.​—Rom. 1:12.

YOU GO DEY STRONG IF YOU NEAR JEHOVAH

19. Why you dey sure sey to near Jehovah more more fit help you dey strong make problem no too worry you?

19 Make we see how one elder for Canada learn why e good to tell Jehovah anything wey dey worry am for mind. E dey teach and advise people for school; the work dey stress am well well. And the brother get one sickness wey dey cause fear and wey dey make person too worry about things. Wetin help this brother? The brother talk sey the main thing wey help am be sey, e no stop to dey do things wey dey make Jehovah happy. This one come dey make am near Jehovah more more and e come fit dey manage the problem. Brothers and sisters for congregation help am. E no hide anything from im wife. Their circuit overseer and other elders help am see things the way Jehovah dey see am. E still talk sey doctor help am, e learn how to manage im time well, and e get time to dey do exercise and rest. Small small, e come fit dey manage the problem well and control how e dey feel. When e face things wey e no fit control, e leave the matter for Jehovah hand.

20. (a) How Jehovah go take help us with wetin dey worry us for mind? (b) Wetin we go talk about for the next topic?

20 For this topic, we don learn why e dey good to tell Jehovah for prayer wetin dey worry us for mind and to dey read Bible and think about wetin we read. We still see sey the fine fine character wey holy spirit dey give us and to tell person wey we trust wetin dey our mind, fit help us make we no too worry. And our congregation meeting dey help us too. For the next topic, we go learn how Jehovah dey help us with the hope wey we get for wetin e don promise.​—Heb. 11:6.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share