Question From People Wey Dey Read Our Book
E good make Christian get gun wey e dey use protect imself from other people?
E no bad to protect ourself from bad things. But before we do anything to protect ourself, e good make we follow wetin dey Bible. Some of the things wey dey Bible, make us know sey e no good make person get gun to protect imself from people. Make we see some of dem.
Jehovah value life. David for Bible know sey na Jehovah ‘dey give life.’ (Ps. 36:9) So, e no good make person wey dey serve Jehovah kill person because e want protect imself or im property. E go make sure sey e do everything wey e fit do, make person blood no dey im head.—Deut. 22:8; Ps. 51:14.
Na true sey, apart from gun, other things dey wey fit kill person. But to use gun kill person dey easy, whether na koro koro eye or na mistake.a Apart from that one, if person attack us, fear fit still dey catch the person. So if the person see sey we get gun, something fit happen wey fit make person die.
The night before dem kill Jesus, e tell im disciples make dem carry sword. But no be because e want make dem use am protect theirself. (Luke 22:36, 38) Instead, Jesus want teach dem sey, even when people carry things wey dem take dey fight come meet dem, make dem no fight. (Luke 22:52) After Peter use sword cut the high priest slave ear, Jesus tell am sey: ‘Put your sword for where e dey before.’ E come talk something wey im disciple dem follow. E sey: ‘Anybody wey dey carry sword na sword go kill am.’ Jehovah people still dey follow wetin Jesus talk till today.—Matt. 26:51, 52.
People wey dey serve God dey follow wetin Micah 4:3 talk. That place show sey dem go change their sword and spear to something wey person take dey do farm work. Dem know God people to be people wey dey do wetin dey bring peace. Dem dey do wetin apostle Paul talk for Bible, when e sey: ‘No use bad thing pay anybody wey do you bad. If una fit, as far as e dey una hand, make una make peace with everybody.’ (Rom. 12:17, 18) Paul face many wahala. For example, e ‘enter trouble for thief hand.’ But even with that one, e follow wetin e talk for that verse. E no do wetin Jehovah hate to protect imself. (2 Cor. 11:26) Instead, e trust God, and e know sey the advice for Bible ‘good pass things wey dem take dey fight war.’—Eccl. 9:18.
Jehovah people value life pass money and property. Na true sey the ‘things wey person get no fit give am life.’ (Luke 12:15) So, if sweet mouth no fit make armed robber change im mind, e go make sense if we follow wetin Jesus talk. E sey: ‘No fight person wey wicked.’ As Jesus talk, we fit even leave our cloth for am. This one mean sey, we go give the person anything wey e want. (Matt. 5:39, 40; Luke 6:29)b But, e go even better if we no do wetin go make us enter thief hand. Make we no dey show ourself sey we get money. Make people know sey we dey serve Jehovah and we no like trouble. This one fit make thief no put eye for our body.—1 John 2:16; Prov. 18:10.
Make we no do wetin go worry other people for mind. (Rom. 14:21) Some people for congregation fit know sey we get gun to protect ourself because of thief or other people. E fit surprise dem if dem know, and their mind fit even start to worry dem. E fit be sey government for our area dey let people get gun. But because we love our brothers and sisters, we no go do wetin go worry dem for mind. Instead, we go first think about how dem go feel.—1 Cor. 10:32, 33; 13:4, 5.
Jehovah people dey try show better example. (2 Cor. 4:2; 1 Pet. 5:2, 3) If Jehovah servant get gun to protect imself from people, elders go use Bible advise am. If e no follow the advice, dem no go see am as better example. Because of that one, e get some kind work wey no go reach im hand for congregation. Na so e go still be if the work wey person dey do to get money, dey make am carry gun. E better make e find another work!c
Na person go choose how e go take protect imself, im family, and im property. Na im go still choose the kind work wey im want do. But e good make e follow wetin Bible talk, because sense dey the advice wey dey Bible. Jehovah give us Bible because e love us. Na im make any Christian wey really dey do wetin God like, no go get gun to protect imself from other people. Dem go do wetin Bible talk to show sey dem trust Jehovah. And dem know sey na that one go make Jehovah protect dem forever.—Ps. 97:10; Prov. 1:33; 2:6, 7.
For great tribulation, Jehovah people no go fight for theirself. Instead, dem go trust Jehovah
a Person wey dey serve Jehovah fit talk sey e want get gun wey e go dey use kill animal chop. E fit still want use am protect imself make bush animal no kill am. When e no dey use am, make e comot the whole bullet, go lock am keep for where person no go see am. E fit even loose am keep. E get some place wey government no want make people get gun, or make only some people get. If we dey stay that kind place, make we follow wetin government talk.—Rom. 13:1.
b If you want know wetin person fit do make dem no rape am, go check the topic “How to Prevent Rape,” wey dey March 8, 1993 Awake! (for English).
c If you want know more about work wey fit make person carry gun, go check The Watchtower of November 1, 2005, p. 31; and July 15, 1983, pp. 25-26 (for English).