No Let Devil Spoil Your Mind
YOUR enemy come fight you! Who the enemy be? Na Satan. E carry wetin e want use finish you. Wetin e carry? Na lie lie! But no be your body e want attack, na your mind.
Apostle Paul know the kind wahala wey Satan lie fit cause. But no be all Christian for im time know. For example, some brothers for Corinth come dey feel sey dem too much. Dem dey think sey nothing fit make dem comot for Jehovah side. (1 Cor. 10:12) Na im make Paul come warn dem sey: ‘I dey fear sey, as the snake take use cunning-cunning deceive Eve, person fit spoil una mind. Una no go come dey use better mind and clean mind follow Christ.’—2 Cor. 11:3.
Wetin Paul talk show sey, e no good make person dey feel sey nothing dey happen. You fit win Devil for this fight. But you go first know wetin im lie lie fit cause, and how you go take protect yourself.
HOW SATAN LIE LIE BAD REACH?
Some people dey lie to deceive other people. Dem dey do am to change their mind and wetin dem want do. One book wey dem dey call Propaganda and Persuasion talk sey, na the same rope tie person wey dey lie, and person wey dey play wayo. E still talk sey e no good, and e dey bring problem.
Wetin lie fit cause? E fit dey change our mind small small, sotey we no go know when we start to believe the lie. E be like gas wey we no fit see or smell, and wey fit kill person. So, we fit no quick know sey wetin person talk na lie. Na im make one man wey im name na Vance Packard talk put for this matter. E sabi this matter reach ground. E talk sey, before many people even know sey lie lie don change how dem dey think, dem don go far. Another person wey still sabi this matter talk sey, lie lie don make people do many bad things. E don make dem kill plenty people. E fit be because dem no like where the people come from or dem no like their religion.—Easily Led—A History of Propaganda.
If human being fit use lie deceive us, what of Devil? Since e don tey wey e sabi how human being dey behave, e no go hard am to deceive us. Bible still tell us sey na im dey ‘control the whole world.’ So, e fit use any part of this world take deceive us. (1 John 5:19; John 8:44) Satan don really use lie ‘block many people mind’ today. Na im make Bible talk sey e dey ‘deceive the whole world.’ (2 Cor. 4:4; Rev. 12:9) Wetin go help you no believe im lie?
GET STRONG FAITH
Jesus teach us wetin fit help us. E sey: ‘Know the truth, and the truth go free una.’ (John 8:31, 32) But one thing be sey, na this truth Satan first dey attack. For example, when soldier go fight war, their enemy fit use lie deceive dem. Na im make the soldier need to find out if wetin their enemy talk na true or na lie, so that their enemy no fit deceive dem. No wonder Jehovah don give us Bible to help us know wetin we go do, make Devil no deceive us.—2 Tim. 3:16, 17.
Satan wey be papa of lie know sey Bible fit help us. So, e dey use this world to make us put hand for things wey fit make us stop to read and study Bible. Abeg, no enter im trap! (Eph. 6:11, ftn.) Make we no just know some things for Bible. But e good make we understand Bible well well. (Eph. 3:18) This one mean sey you go put all your body for the study. Na wetin one man talk be that. Im name na Noam Chomsky. E talk sey: ‘Nobody go pack truth put for your brain. Na something wey you go learn by yourself.’ So, to fit ‘learn am by yourself’ you go use your time study Bible everyday.—Acts 17:11.
If you no want make Devil spoil your mind, you must know wetin im lie lie fit cause and how you go take protect yourself
Get am for mind sey, Satan no want make you dey think well. Why you suppose get am for mind? One book talk sey, if person no think matter well, e go quick believe lie. (Media and Society in the Twentieth Century) So, e good make we no just believe everything wey person tell us. Make we first think am well. (Prov. 14:15) God don give us sense and power to think. Abeg, make we use am think well so that our faith go strong.—Prov. 2:10-15; Rom. 12:1, 2.
NO SEPARATE YOURSELF
Sometimes, soldiers fit use lie put fear for their enemy body. This one fit make their enemy no get power to fight dem. Their enemy fit start to fight theirself or separate theirself from their group. One oga wey dey control Germany soldier, talk sey na wetin make Germany lose the fight for World War I. The lie enter people body sotey their mind comot from the war. Na wetin Satan still dey do today. E want scatter the one mind wey dey congregation. For example, e fit make brothers and sisters for congregation get quarrel. E fit still make some people for congregation feel sey Jehovah organization no handle matter well. That one fit make dem leave Jehovah.
No let Satan deceive you! Follow wetin Bible talk. For example, Bible tell us wetin fit make us continue to get one mind for congregation. E sey make we ‘dey use all our mind forgive each other,’ and make we dey quick settle matter. (Col. 3:13, 14; Matt. 5:23, 24) Bible still warn us make we no separate ourself from our brothers and sisters. (Prov. 18:1) E good make you ask yourself question wey go help you know whether your faith strong reach to block Satan lie. For example, ‘The last time wey brother or sister for congregation make me vex, wetin I do? I show sey na God spirit dey control me or I behave like people for this world?’—Gal. 5:16-26; Eph. 2:2, 3.
CONTINUE TO TRUST PEOPLE WEY DEY DIRECT US
Soldier wey no trust im oga, no fit fight well. Na im make the enemy go lie give the soldier so that dem no go trust the oga. If the oga do mistake, the enemy fit tell the soldier sey: “You see, your oga no reach to lead una!” and “If una follow am, una go die finish!” Na so Satan dey do. E know sey you trust people wey Jehovah dey use direct im organization. So, e go always do wetin go make you stop to trust dem. E no dey tire!
Wetin you go do to protect yourself? Tell yourself sey you no go ever leave Jehovah. Continue to trust and support people wey dey direct us, even if dem make mistake. (1 Thess. 5:12, 13) People wey don leave Jehovah or other people fit begin talk bad things about Jehovah organization. Even if wetin dem talk be like sey na true, abeg, ‘no let anybody quick change your mind or wetin you dey think.’ (2 Thess. 2:2; Titus 1:10) Follow the advice wey apostle Paul give Timothy. E tell am sey make e hold the truth wey e don learn tight. E still tell am sey make e no forget the people wey teach am this truth. (2 Tim. 3:14, 15) We suppose trust the people wey dey direct us. Dem don teach us many better things for Bible. Even self, e don nearly reach hundred years since dem start to direct us.—Matt. 24:45-47; Heb. 13:7, 17.
MAKE YOU NO FEAR
Remember sey, no be only cunning-cunning Satan fit use deceive us. E fit still come direct. E fit put fear for our body. One book talk sey: ‘No be today people begin use fear deceive person. E don tey.’ (Easily Led—A History of Propaganda) For example, one man wey come from Britain talk how Assyria people take dey use this style for their enemy. Im name na Professor Philip M. Taylor, e talk sey: ‘Dem dey use fear plus lie take dey deceive their enemy.’ Na so Satan self dey do. E dey use things wey e know sey fit make us fear. Things like: To dey fear people, fear sey we fit die, fear sey people go suffer us and any other thing to put fear for our body. Wetin e want na make we stop to serve Jehovah.—Isa. 8:12; Jer. 42:11; Heb. 2:15.
No let Satan put fear for your body or make you stop to serve Jehovah. Jesus talk sey: ‘No fear people. Dem fit kill person but dem no fit do pass that one.’ (Luke 12:4) Use all your mind believe sey Jehovah go protect you. E go give you ‘power wey pass normal power,’ and help you stand well make you no enter Satan trap.—2 Cor. 4:7-9; 1 Pet. 3:14.
Sometimes, body fit tire you or something fit make you fear. But remember wetin Jehovah tell Joshua. E tell am sey: ‘Get strong mind. No let anything make you fear, because I go dey with you anywhere wey you go.’ (Josh. 1:9) If something begin worry you, no waste time, tell Jehovah for prayer. Get am for mind sey ‘the peace wey God dey give, go protect how you dey feel and the things wey you dey think.’ That one go give you power to fit handle any lie wey Satan bring.—Phil. 4:6, 7, 13.
You remember wetin Rabshakeh talk to make God people fear? E want make dem believe sey nobody fit save dem from Assyria hand. E talk sey Jehovah, wey be their God, no go fit save dem. E even get mind tell Judah people sey na Jehovah tell dem to destroy Jerusalem. Wetin Jehovah come talk? E sey: ‘No fear because of all the thing wey you hear, all the things wey Assyria king servant don talk, to lie about me.’ (2 Ki. 18:22-25; 19:6) That night, Jehovah send one angel wey kill 185,000 Assyria soldier.—2 Ki. 19:35.
GET SENSE—NO STOP TO LISTEN TO JEHOVAH
You don ever watch film, come see sey dem dey deceive person? How e do you? E no do you like sey make you tell the person sey: ‘No believe am! E dey lie!’ Just think am sey the angels still dey tell you the same thing sey: ‘Not let Satan use lie lie deceive you!’
Close your ear! No listen to Satan lie. (Prov. 26:24, 25) Listen to Jehovah. Trust am to direct you for anything wey you dey do. (Prov. 3:5-7) E love you and na wetin make am dey tell you sey: ‘My pikin, show sey you get sense and my mind go sweet.’ (Prov. 27:11) If you follow Jehovah advice, Satan no go fit deceive you or spoil your mind!