Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 December pp. 8-12
  • “I Get Hope for God”

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • “I Get Hope for God”
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • RESURRECTION WEY HAPPEN AFTER MANY YEARS
  • WHEN GOD GO RESURRECT PEOPLE?
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 December pp. 8-12
Apostle Paul dey talk to Governor Felix and Drusilla

“I Get Hope for God”

“The last Adam come be spirit wey dey give life.”​—1 COR. 15:45.

SONG: 151, 147

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • How Psalm 118 take show sey person wey die fit still come life again even if e don tey wey God make the promise?

  • How wetin dem talk for Psalm 16:10 take happen?

  • Which people go resurrect when Jesus don start to rule for heaven, and how e go be like?

1-3. (a) Wetin we go add join the main things wey we believe? (b) Why resurrection dey important to us? (Check the first picture.)

IF PERSON ask you sey wetin be the main things wey we believe, wetin you go talk? You fit tell am sey na Jehovah make everything, and na im give us life. You fit still talk sey Jesus Christ come die to save us. You go still happy to tell am sey paradise dey come for front, and na good people go stay there forever. But you go tell am about the hope wey you get sey people wey don die go come back to life? You go let am know sey na one of the things wey you value pass be that?

2 E fit be sey you get hope to survive great tribulation, and stay this earth forever. Even with that one, you still get better reason to talk about resurrection. This na because na one of the main things wey we believe. Why? Apostle Paul talk sey: “If people wey don die no go come life, then e mean sey dem never bring Christ come life.” If to sey God no resurrect Jesus, e for no dey rule as King for heaven. And all the things wey we dey teach about am for be waste. (Read 1 Corinthians 15:12-19.) But we know sey dem bring Jesus come back to life. We believe am well well. We no be like Sadducee people wey no believe sey people wey don die go fit come life again. Even if people dey laugh us, we still believe sey people wey die fit come life again.​—Mark 12:18; Acts 4:2, 3; 17:32; 23:6-8.

3 When Paul write about “the first things wey dem teach about Christ,” e come still talk “the things wey dem teach about resurrection for people wey don die.” (Heb. 6:1, 2) And Paul believe sey one day, people wey don die go come back to life. (Acts 24:10, 15, 24, 25) Even though sey na one of the main things wey we believe and wey we learn from Bible, e still good make we study about am well. (Heb. 5:12) Why we talk so?

4. Which question we fit ask about resurrection?

4 As people start to study Bible, dem fit learn about people like Lazarus wey come back to life. Dem fit still learn sey Abraham, Job, and Daniel believe sey God go resurrect people when time reach. If person ask you make you show am for Bible wetin make you believe sey people wey don die fit come life again, even if e don tey wey dem make the promise, wetin you go talk? Bible even talk when this one go happen? Our faith go strong if we know the answer to this question.

RESURRECTION WEY HAPPEN AFTER MANY YEARS

5. Wetin we go talk about?

5 E fit easy to imagine person wey dem bring come life after e just die. (John 11:11; Acts 20:9, 10) But what about the promise sey person wey don die go come life for front, you still believe am even if e go tey before e happen? You go believe this promise even if many years don pass? Whether the promise na about person wey just die, or person wey don die tey tey, you go believe am? E get one person wey come back to life and Bible don already talk am tey tey sey e go happen, and you believe am. Who be this person? And how this one take affect the hope wey you get sey when the time reach, people wey don die go come life again?

6. How Jesus take be the person wey Psalm 118 talk about?

6 Bible talk am tey tey sey one person go come back to life. Dem talk about this person for Psalm 118. E fit be sey na David write this Psalm. E beg Jehovah sey: “Jehovah we dey beg you, abeg save us! . . . Make God bless the person wey dey come with Jehovah name.” You go remember sey, people talk this thing when Jesus dey enter Jerusalem for Nisan 9, before e die. (Ps. 118:25, 26; Matt. 21:7-9) But how Psalm 118 take talk about person wey go resurrect many years for front before e happen? Psalm 118 still talk sey: “The people wey dey build no want the stone. This stone don become the main stone for the corner of the building.”​—Ps. 118:22.

The people wey dey lead Jew people no want Jesus; Jesus die for pole

“The people wey dey build no want” the Messiah (Check paragraph 7)

7. How Jew people hate Jesus reach?

7 “The people wey dey build” wey Bible talk about, na the people wey dey lead Jew people. Dem no want the Messiah. Jew leaders no like Jesus at all, and dem no believe sey na im be the Christ. Many Jew people even hate am sotey dem talk sey make dem kill am. (Luke 23:18-23) True true, dem join people wey kill Jesus.

The resurrected Jesus on his heavenly throne

God bring Jesus come life again make e be “the main stone for the corner” (Check paragraph 8, 9)

8. How Jesus go take be “the main stone for the corner of the building”?

8 As dem reject Jesus and kill am, how e go take be “the main stone for the corner of the building”? Na only when dem resurrect am, na im this one go take happen. Jesus talk about am by imself for one story about one man wey get farm. The man send im servants go meet the people wey dey work for am for im farm. The people wey dey work for the farm no treat the servant dem well. Last last, the owner come send im own pikin go the farm. But dem no listen to am, instead dem kill am. Na so Israel people still be. Dem no treat the prophets wey God send go meet dem well. After Jesus talk the story finish, e come talk wetin dey Psalm 118:22. (Luke 20:9-17) Apostle Peter still talk wetin dey this verse when e dey talk to “the people wey dey rule, the elders, and the people wey be scribe wey gather for Jerusalem.” E talk about ‘Jesus Christ wey come from Nazareth, wey dem kill and hang for pole. But God bring am back to life.’ Peter still tell dem sey: “Na this one be ‘the stone wey una wey be builders treat like sey e no mean anything. Na im come be the main stone for the corner of the building.’”​—Acts 3:15; 4:5-11; 1 Pet. 2:5-7.

9. Wetin Psalm 118:22 talk about?

9 Psalm 118:22 talk about one person wey dem go bring come life again after e die. Dem talk am tey tey before e happen. Dem go reject the Messiah and dem go kill am. But God go bring am come life again, make e be the main stone for the corner of the building. After dem bring am come life, e come be the only person wey fit save us. Na im make Bible talk sey “e no get any other name for this earth wey people dey bear wey fit save us.”​—Acts 4:12; Eph. 1:20.

10. (a) Wetin Psalm 16:10 talk sey go happen? (b) How we take know sey wetin dey Psalm 16:10 no happen to David?

10 Make we see another verse wey talk about resurrection. E pass one thousand years wey dem write am before e happen. This one suppose make you get the mind sey people wey die go fit come life again, even if e don tey wey dem make the promise. David write for Psalm 16 sey: “You no go leave me inside Grave. You no go let person wey dey your side see inside pit.” (Ps. 16:10) David no dey talk sey e no go die or dey inside Grave. Bible help us know sey David old and e die. After e die, “dem come bury David for where dem bury im papa-papa dem. And na for David City dem bury am.” (1 Ki. 2:1, 10) But wetin Psalm 16:10 come mean?

11. When Peter take explain Psalm 16:10?

11 After one thousand years don pass wey David write Psalm 16:10, Peter come explain who that verse dey talk about. After some weeks wey Jesus die and wey dem bring am come life again, Peter tell many many people about Psalm 16:10. Some of dem na Jew, and some no be Jew. (Read Acts 2:29-32.) E talk sey David die and dem bury am. The people wey dey listen to Peter know this one. No where for Bible talk sey the people argue with Peter when e talk sey David “see am before e happen and e talk about how God” go resurrect the Messiah wey dey come.

12. How wetin dey Psalm 16:10 take happen, and why e fit make us put mind for the resurrection?

12 Peter use wetin David talk for Psalm 110:1 take support wetin e dey talk. (Read Acts 2:33-36.) Because Peter use Bible, the plenty people wey listen to am believe sey Jesus na “Lord and Christ.” The people still believe sey na when dem resurrect Jesus, na im wetin dey Psalm 16:10 take happen. Later, apostle Paul come still talk the same thing when e dey talk to Jew people for Antioch wey dey Pisidia. Wetin Paul talk sweet the people well well. E come dey hungry dem to hear more. (Read Acts 13:32-37, 42.) We self don come see sey resurrection fit happen, even after many years wey God make the promise, and we believe am.

WHEN GOD GO RESURRECT PEOPLE?

13. Which question we fit ask about resurrection?

13 Our mind don come down to know sey person fit come life again, even after many years wey God make the promise. But, some people fit dey think: ‘E mean sey e go tey well well before I go see my person wey don die? Which time God go bring people wey don die come life?’ Jesus tell im apostle dem sey e get things wey dem no know and dem no fit know. “Na only the Father get power to choose when the time and season go be.” (Acts 1:6, 7; John 16:12) But this one no mean sey we no know anything about the time wey people go come back to life.

14. How Jesus resurrection take different from other resurrection before im own?

14 For all the resurrection wey dey Bible, na Jesus own important pass. If to sey dem no bring Jesus come life, we for no get hope sey we go see our people wey die again. Before dem bring Jesus come life, God servant like Elijah and Elisha don already bring people wey die come life. But this people later die again, and dem turn to sand sand for grave. But Jesus own no be like that. “Dem don raise Christ come life from death, and e no go die again. The power wey death get no fit do am anything again.” E “dey live forever and ever” for heaven.​—Rom. 6:9; Rev. 1:5, 18; Col. 1:18; 1 Pet. 3:18.

15. Why dem call Jesus “the firstfruits”?

15 God resurrect Jesus go heaven as spirit person. This na the first time wey this kind thing dey happen. And na im own dey important pass. (Acts 26:23) But no be only Jesus dem promise sey go resurrect go heaven as spirit. Jesus promise im apostles sey dem go rule with am for heaven. (Luke 22:28-30) But na only after dem die, dem go fit go heaven. After dem die, dem go come resurrect like Jesus go heaven as spirit. Paul write for Bible sey: “Dem don raise Christ from death. Na im be the firstfruits among the people wey don sleep for death.” Paul still talk sey God go resurrect other people go heaven. E sey: “Na turn by turn e go happen: Christ na the firstfruits. After, e go be the turn of people wey be Christ own when e dey around.”​—1 Cor. 15:20, 23.

16. Wetin we know about the time wey some people go resurrect go heaven?

16 Wetin Paul talk help us know something about when people go resurrect go heaven. Bible talk sey e go happen “when Christ dey around.” For many years now, we don dey show people from Bible sey na since 1914 “Christ dey around,” as King. Jesus still dey rule, and this world go soon end.

17, 18. Wetin go happen to some anointed ones when Christ dey around as King?

17 Bible still talk more things about the people wey dem go resurrect go heaven. E sey: “We want make una know the truth about people wey dey sleep for death . . . Because if we get faith sey Jesus die and dem bring am come life again, na so God go still . . . bring people wey don sleep for death come life. God go bring dem come back follow Jesus. We wey get life and wey survive reach the time wey the Lord go dey around, no go fit go before the people wey don already sleep for death. Because the Lord imself go come down from heaven, and e go shout with command . . . And people wey be Christ own wey don die go first rise. After that one, we wey survive and wey dey alive, no go waste time join this people enter cloud. We go comot go meet the Lord for air; and then we go always dey with the Lord.”​—1 Thess. 4:13-17.

18 E no too tey after Christ start to rule, na im the first resurrection start. When great tribulation go start, anointed ones wey dey alive “no go waste time enter cloud go meet the Lord for air.” This people wey “enter cloud” no go “sleep for death.” This one mean sey dem no go die tey. Instead, when dem die, “all of dem go change. E go happen quick quick, even before person open eye close am, when the last trumpet blow.”​—1 Cor. 15:51, 52; Matt. 24:31.

19. Which better resurrection we dey wait for?

19 E get many people wey dey serve Jehovah well today, but dem no be anointed and God no choose dem to rule with Jesus for heaven. Instead, dem dey wait for the time wey this wicked world go end when “Jehovah day come.” Nobody fit know when that day go be. But the things wey dey happen don help us know sey the time don near. (1 Thess. 5:1-3) After that one, another type of resurrection go come happen. This time, na people wey go stay for paradise for this earth dem go resurrect. People wey dem go bring come life, go get the hope sey for front, dem no go get sin for body again, and dem go live forever. This resurrection go better pass the ones wey happen for Bible time. Because the people wey resurrect that time still die again after some time.​—Heb. 11:35.

20. Wetin make us believe sey God go arrange the resurrection wey dey come for front?

20 Bible talk about people wey God go resurrect go heaven sey “na turn by turn e go happen.” (1 Cor. 15:23) So we believe sey na so e go still be for this earth. The resurrection go be turn by turn, no be anyhow. E go really make sense! We go happy to see our people. This one fit make us ask sey: Na when Jesus Christ just start to rule for one thousand years e go resurrect people wey die for our time? God go quick resurrect people wey sabi lead for Bible time to come direct im people for paradise? What about people wey no serve Jehovah at all? Which time God go resurrect dem, and which place e go resurrect dem put? E get many question wey person fit ask. But wait, any need to dey worry ourself with all this kind question? E no better make we just wait and see wetin go happen? We dey sure sey e go really make sense to see how Jehovah go handle matter by imself.

21. Which hope you get about people wey don die?

21 God don promise us sey e go use Jesus bring people wey don die come life again. But before that time reach, make we do everything to make our faith for Jehovah strong. (John 5:28, 29; 11:23) To show sey Jehovah get power to bring people wey don die come life again, Jesus talk something about Abraham, Isaac, and Jacob. E sey for God eye, “all of dem dey alive.” (Luke 20:37, 38) So, like Paul, we get plenty reason to talk sey: “I get . . . hope for God sey people go come back to life.”​—Acts 24:15.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share