Dey Do Good Now and You Go Happy!
“Dey do good to unaself and no complain.”—1 PET. 4:9.
1. Which wahala the brothers and sisters for apostle time face?
BETWEEN 62 and 64 C.E., apostle Peter write letter to brothers and sisters wey be “strangers, wey scatter for everywhere for Pontus, Galatia, Cappadocia, Asia, and Bithynia.” (1 Pet. 1:1) This brothers and sisters come from different place. People dey suffer dem well well and dey talk bad about dem. So dem need wetin go give dem mind, and help dem know wetin to do. Things no really easy for dem that time. Peter write to dem sey: “The time wey everything go end don near.” Before ten years reach, people go destroy Jerusalem. Wetin go help Christians that time face all the wahala?—1 Pet. 4:4, 7, 12.
2, 3. Why Peter tell the brothers sey make dem dey do good to each other? (Check the first picture.)
2 One of the thing wey Peter tell the brothers be sey, make dem “dey do good to” each other. (1 Pet. 4:9) The Greek word wey dem translate as “dey do good” mean to “like stranger or to dey help dem.” But when Peter use this word, na brothers and sisters e get for mind, no be stranger. E sey make dem dey help each other, even though sey dem already know theirself. How this one go take help dem?
3 E go make dem near each other. This kind thing never happen to you before? You still remember how you enjoy am when person invite you go im house? When you invite person come your house, e no make una friendship tight pass before? One better way to know our brothers and sisters well na to invite dem to come enjoy with us. The brothers and sisters for apostle Peter time really need to near each other well well, as things dey bad more more. Na so we suppose do as we dey live for “last days.”—2 Tim. 3:1.
4. Which question we go answer for this topic?
4 Which chance we get to do good to our brothers and sisters? If e dey hard us to do good to people, wetin fit help us? And wetin we suppose do when person invite us?
DIFFERENT DIFFERENT WAY TO DO GOOD
5. How we fit take do good to people wey come meeting?
5 For Meeting: Na Jehovah and im organization invite all of us come meeting. So make we show everybody sey we love dem, especially if dem be new people. (Rom. 15:7) Na Jehovah still invite this new people. So make we welcome dem no matter their hairstyle or the kind cloth wey dem wear. (Jas. 2:1-4) If you see any new person wey just sitdown by imself, you fit call am make e sitdown with you? Belle fit sweet am if you help am know wetin dey happen for the meeting. And e fit still happy if you help am find place for Bible wey dem dey read. This na one better way to “do good to strangers.”—Rom. 12:13.
6. Who fit dey among the main people wey we go invite come our house?
6 E fit be small chop chop (snacks) or food: For Bible time, one way wey people take dey do good na to invite person to come chop for their house. (Gen. 18:1-8; Judg. 13:15; Luke 24:28-30) To invite person to chop with dem mean sey dem want be friend and dem no want get problem with each other. Who fit dey among the main people wey we go invite come our house? Na the brothers and sisters for our congregation. We need to dey help each other as life dey hard more more. And make we no leave dem, or dey get problem with dem. For 2011, Governing Body change the time wey dem dey do Watchtower Study for Bethel wey dey United States. Dem change am from 6:45 to 6:15 for evening. Why dem change am? Dem talk sey Bethelites fit get more chance to invite each other because more time go dey after closing. Other branch office later follow this arrangement. And this one don make people for Bethel near each other well well.
7, 8. How we fit take show love to brothers wey come visit our congregation?
7 Brothers fit come give talk for our congregation. Dem fit be circuit overseer, brothers from other congregation, or even brothers from Bethel. This one na better chance to do good. (Read 3 John 5-8.) We fit invite dem come our house, and prepare food or small chop chop for dem. You ready to do this kind thing?
8 One sister for United States dey do like that. And e talk sey: “For many years, many brothers and their wife don visit our congregation. Me and my husband dey invite dem come our house. We dey enjoy am everytime wey dem come our house. The one wey better pass be sey, their visit dey make our faith strong. We no ever regret am sey dem come.”
9, 10. (a) Which people go need place to stay for some time? (b) People wey their house small fit invite brothers to stay with dem? Give example.
9 Visitors wey go stay for some time: For Bible time, people dey give some of their visitor place to stay. (Job 31:32; Philem. 22) We fit still do like that today. When circuit overseer dey visit congregation, dem dey need place to stay. Our brothers and sisters fit need place to stay when dem dey attend school wey Jehovah organization arrange. People wey dey build Kingdom Hall and Assembly Hall fit still need place to stay. When things like heavy breeze destroy our brothers house, dem go need place to stay before dem go help dem repair their house. Make we no just dey think sey na only people wey get big house go fit help this kind people. Dem fit don do am plenty times. You fit invite dem to stay for your house, even if your house small?
10 One brother for South Korea remember the time when e give brothers and sisters place to stay. The brothers and sisters come attend some of the school wey Jehovah organization arrange. The brother talk sey: “I first dey fear sey we no go fit do am because e never too tey wey I marry, and our house small. But we enjoy am as this brothers and sisters stay with us. Me and my wife come see sey, if husband and wife dey serve Jehovah and dey do im work together, dem go happy.”
11. Why we need to do good to people wey just join our congregation?
11 People wey just join our congregation: E fit be sey some brothers and sisters just join our congregation, and some fit come with their family. Maybe dem come help your congregation because publishers no too many. Dem fit still be pioneers wey dem send come help your congregation. Remember sey e no easy for dem. To pack go new area, and join new congregation no easy. And e fit be sey dem go need to learn new language, and how people for the area dey do things. You fit invite dem to come eat food or small chop chop for your house? You fit invite dem make dem follow you when you dey go enjoy yourself? This things go help dem make new friends, and e go make dem enjoy the new area.
12. Which example show sey we no need to prepare many things to show people sey we love dem?
12 You no need to prepare many things to show people sey you love dem. (Read Luke 10:41, 42.) One brother talk wetin happen the time wey im and im wife just start missionary work. E sey: “We dey young that time, we never do missionary work before, and we still dey miss house. E get one evening wey my wife just dey miss house well well. I do wetin I fit do to help am, but e no work. Later, around 7:30 for evening, one girl come knock our door. The girl dey study Bible with Jehovah Witness, and e carry three orange come give us. E hear sey new missionary don come, so e come welcome us. We tell am make e come inside and we give am water drink. We still make hot tea for am. We never sabi Swahili language and the girl no dey hear English. But wetin happen that day come make us start to dey near the brothers and sisters for the area.”
MAKE NOTHING STOP YOU TO DO GOOD
13. Wetin we go gain if we dey do good?
13 Something don make you no do good to people before? If e don happen to you, you fit don miss better chance to do good. You for use the chance take enjoy yourself with people, and get the kind friendship wey go last. If person dey feel sey na only im dey, make e dey show love to people. This na one thing wey go really help am. But wetin dey make am hard for some people to do good? Make we talk about some of dem.
14. If e dey hard us to invite or visit person because the time and power no dey, wetin we fit do?
14 Time and power: Jehovah people dey busy well well, and dem get many things wey dem dey do. Some of dem fit dey feel sey dem no get chance to invite people to come enjoy with dem, and dem no get power to do the work wey follow am. If na wetin dey your mind be that, you no think sey you need to check the things wey you dey use your time do? E get wetin you fit change so that you fit invite people? If you arrange your time well, you go still get chance to go if person invite you. Bible advice us sey make we dey do good to people. (Heb. 13:2) Na better thing to arrange your time so that you fit do this one. But to fit do am, you go need to reduce the time wey you take dey do things wey no too dey important.
15. Why some people feel sey dem no go fit invite other people come their house?
15 You fit dey think sey you no fit do am: E don ever happen to you sey you want invite person, but you think sey you no go fit do am? Because some people dey shame, dem fit think sey their visitor no go enjoy im visit. Some people wey no too get money feel sey dem no go fit give their visitor wetin other brothers dey give their visitor. But remember sey wetin matter pass no be how person house fine reach. The main thing be sey, the house clean, and dem arrange am well.
16, 17. If we dey fear about how e go be to invite people come our house, wetin go help us?
16 If you dey fear about how e go be if you invite people come your house, get am for mind sey no be only you dey feel like that. One brother for Britain wey be elder talk sey: “Plenty things fit dey worry person for mind when e dey prepare for im visitor. But the truth be sey, the gain wey we dey get if we do wetin Jehovah want, dey plenty pass any fear wey fit dey our mind. Even if na only coffee I give my visitor, I dey happy to gist with dem as we dey drink am together.” (Phil. 2:4) Many people dey happy to talk story wey don happen to dem. Other people fit no know our story. E fit be sey the only chance wey dem go get to ask us our story na when we dey enjoy ourself together. Another elder talk sey: “When I invite brothers and sisters come my house, e dey give me chance to know dem and understand dem well. E still dey help me know how dem take learn about Jehovah.” People wey come visit us go enjoy am if we show dem sey we really love dem.
17 E get one sister wey be pioneer. And people wey come the different school wey Jehovah organization dey arrange dey stay im house. The sister talk sey: “I first dey fear because my house no too fine. Some of the things wey dey my house na secondhand. The wife of one of the brother wey dey teach for the school dem, really make my mind come down. The sister sey when im and im husband dey do circuit work, dem dey happy well well when dem stay with person wey love Jehovah. The person fit no get money, but e dey serve Jehovah well and dey live simple life like dem. Wetin e talk make me remember wetin my mama dey tell us when we small, e sey: ‘E better to chop vegetable for where love dey.’” (Prov. 15:17) So make you no dey worry yourself. Wetin matter pass na the love wey you show people.
18, 19. If we dey do good to our brothers, how this one go take help us change how we dey see dem?
18 The kind eye wey you take dey look some people: E get person for your congregation wey dey do wetin you no like? You fit no like the person, and you fit continue to feel like that if you no do something. If you no like the way person dey behave, you fit no like to invite am come your house to come enjoy with you. Or e fit dey hard you to forgive person wey do you bad.
19 Make we dey do good to people, even if dem be our enemy. This one go make the way we dey do things with dem dey better. Na wetin Bible sey make we dey do be that. (Read Proverbs 25:21, 22.) If you invite person come your house to follow you enjoy, e fit make una no dey get problem like before, and you go dey look am with better eye. E go help you see the good character wey the person get wey make Jehovah draw am come im side. (John 6:44) If because of love you invite person wey no think sey you go invite am, e fit make two of una become friend. But how you go take dey sure sey na love make you invite am? One way na to follow the better advice wey dey Philippians 2:3. That place talk sey: “Carry yourself down when you dey do things, with the mind sey other people better pass you.” Look for how other people take better pass you. E fit be sey dem get some better character pass you. Character like faith, to dey endure and get mind. This one go make the love wey we get for dem strong, and e no go hard us to do good for dem.
WETIN WE SUPPOSE DO WHEN PERSON INVITE US
People dey like to prepare well well for their visitor (Check paragraph 20)
20. If we promise person sey we go come, why e no good make we change mind? And how we go take show sey we value am as person invite us?
20 For Bible, David ask Jehovah sey: “Who you go invite come your house?” (Ps. 15:1) After David ask this question, e come start to dey talk the better better character wey person suppose get before Jehovah fit invite am. One of dem be sey, the person no dey do promise and fail. Bible talk sey this kind person dey do wetin e promise even when e hard for am. (Ps. 15:4) If person invite us, and we agree to go, make we no change mind, unless serious thing happen. The person wey invite us fit don prepare sey we dey come. If we no go, e mean sey the person fit don waste im time. (Matt. 5:37) Some people wey talk sey dem go come when person invite dem, fit change mind if another person invite dem. Dem fit dey think sey na the other person own go better pass. If we love and dey respect the person wey first invite us, we no go behave like that. Instead, make we go, and make we use better mind collect anything wey the person give us. (Luke 10:7) If something happen wey no fit make us go, e good make we quick tell the person wey invite us. This one go show sey we love am and still get am for mind.
21. If we know wetin people for different area like, how this one go take help us be better visitor?
21 E good to get am for mind sey, people wey come from different place get how dem dey do things. For some place, you fit visit person even if you no tell am sey you dey come. For other place, dem go like am if you first tell dem sey you dey come. E get some area wey people dey give their visitor wetin better pass. Dem no dey worry even if their family no get this kind thing to enjoy. But for other area the visitor and the people wey e visit dey enjoy the same thing. For some place, na normal thing for visitor to bring something when e dey come. But for other place, dem no dey want make their visitor worry imself bring anything. For some area, if person invite you the first time, na normal thing to sofri tell the person sey you no go fit come. And you fit still talk like that the second time. But for other place, if you do like that dem no go like am. Make we do wetin we fit do to make sure sey the person wey invite us no regret am.
22. Why we really need to “dey do good” to our brothers and sisters?
22 Apostle Peter talk sey: “The time wey everything go end don near.” (1 Pet. 4:7) Today, the time don near well well. And we know sey great tribulation dey come for front. And as things for this world dey hard everyday, we need to make sure sey we get strong love for our brothers. So na now be the time to follow apostle Peter advice when e sey make we “dey do good” to each other. (1 Pet. 4:9) E dey really make us happy to do good to our brothers and sisters. And this na wetin we suppose dey do. Make we no ever stop to dey do good to our brothers.