BETTER THINGS WEY INSIDE BIBLE | PSALMS 11-18
Who Jehovah Fit Invite Come Im House?
For Jehovah to invite person come im house, e mean sey the person go be im friend, the person go trust am and e go do wetin e tell am. Psalm 15 talk about the kind character wey anybody wey want be Jehovah friend go get.
PERSON WEY JEHOVAH INVITE MUST . . .
no dey shake as e dey serve God and e dey do the correct thing
talk true, even for im mind
respect other people wey dey serve Jehovah
do wetin e talk even when e no easy
help people with all im mind, no be because of wetin e go get from dem
PERSON WEY JEHOVAH INVITE NO GO . . .
gossip and spoil person name for im back
do im neighbor bad thing
use im Christian brother any how to get gain
always dey with people wey no dey serve Jehovah
dey take bribe