Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 November p. 5
  • What Can the Bible Teach Us?—How You Go Use Am

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • What Can the Bible Teach Us?—How You Go Use Am
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • Similar Material
  • Teach the Truth
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • How to Use Listen to God Brochure
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 November p. 5

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

What Can the Bible Teach Us?​—How You Go Use Am

What Can the Bible Teach Us?

Teach Us book resemble Bible Teach book. We dey use this two book teach people Bible, na the same thing dey inside and dem arrange dem for the same way. But Teach Us book dey explain the truth for simple way. Dem do am for people wey e hard for dem to understand Bible Teach book. Teach Us book no get appendix, but e get endnote wey dey explain some things wey dem don talk about inside the chapter. Question no dey for beginning of the chapter and e no get review box. For the end of every chapter, dem write all the main point wey dem don explain for inside the chapter. Like Bible Teach, we fit give people Teach Us book anytime, even if na another book we dey give people for that month. How we go take use this new things wey dey for Teach Us book when we dey conduct Bible study?

Summary wey dey for end of Teach Us book

SUMMARY: For many people, our normal style to conduct Bible study na to read paragraph for inside Bible Teach book and ask question and e dey work well for dem. But, if the Bible student no sabi the language well or e no sabi read well, you fit dey use Teach Us book. You fit still use the summary wey dey the end of the chapter to conduct the study and encourage the person sey make e try read the chapter later. For one study, you fit teach the person one truth for 15 minute. As the summary no get all the things wey dem write inside the chapter, e good make the teacher prepare well and think of how e go fit help the student. If na the main chapter you take conduct the study, you fit use the summary do review.

ENDNOTES: Dem arrange wetin dey the endnote as e take be for inside the chapter one by one. The teacher fit choose whether dem go read the endnote wey dey inside the Teach Us book when dem dey study.

Endnote wey dey inside Teach Us book
    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share