Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • T-36 pp. 1-4
  • Wetin be God Kingdom?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin be God Kingdom?
  • Wetin be God Kingdom?
  • Similar Material
  • How You Think Sey Our Tomorrow Go Be?
    How You Think Sey Our Tomorrow Go Be?
  • Who Dey Control This World?
    Who Dey Control This World?
  • Suffer Suffer Go Fit End?
    Suffer Suffer Go Fit End?
  • Which Kind Book You Think Sey Bible Be?
    Which Kind Book You Think Sey Bible Be?
See More
Wetin be God Kingdom?
T-36 pp. 1-4
People wey come from different different place dey pray make God Kingdom come

Wetin be God Kingdom?

You go talk sey . . .

  • na something wey dey your mind?

  • na story wey people dey talk?

  • na government wey dey heaven?

SEE WETIN BIBLE TALK

God wey dey heaven go start one kingdom wey nothing go fit scatter.’—Daniel 2:44, New World Translation.

Dem don give us one pikin and na for im shoulder the government go sitdown put.’—Isaiah 9:6.

HOW WETIN BIBLE TALK FIT HELP YOU

  • Good government wey go do better for you.​—⁠Isaiah 48:​17, 18.

  • For the paradise wey dey come, we no go dey sick again, and na so-so happy we go dey happy.—Revelation 21:3, 4.

People wey dey work for garden and dey enjoy life for paradise when God Kingdom don dey rule the earth

WE FIT BELIEVE SEY WETIN BIBLE TALK NA TRUE?

Yes, make we see two reason wey go make us believe:

  • Jesus don show wetin God Kingdom go do. Jesus teach the people wey dey follow am sey make dem pray make God Kingdom come and make God do wetin e want for this world. (Matthew 6:​9, 10) Wetin Jesus do that time show how God go take answer that prayer.

    When Jesus dey this world, e give people wey dey hungry food, e make sick people well and bring people wey die come life again! (Matthew 15:​29-​38; John 11:​38-​44) As the person wey go be King for that Kingdom, Jesus show the better things wey people go enjoy.—Revelation 11:15.

  • All the bad bad things wey dey happen show sey e no go tey wey God Kingdom go come. Jesus talk sey before people for this world go get rest of mind, many many bad things go happen. Ground go dey shake-open (earthquakes), food no go dey again and people go dey fight war.—Matthew 24:3, 7.

    All this things don dey happen today. Na im make us ­believe sey e no go tey before God Kingdom go comot all the wahala for this world.

MAKE YOU THINK ABOUT THIS QUESTION

Fine earth wey God Kingdom go control

How you think sey life go be when God go bring im Kingdom come?

Bible answer this question for PSALM 37:29 and ISAIAH 65:21-23.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share