Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb17 September p. 7
  • Train Dem So That Nothing Go Make Dem Stop to Serve Jehovah

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Train Dem So That Nothing Go Make Dem Stop to Serve Jehovah
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
mwb17 September p. 7

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

Train Dem So That Nothing Go Make Dem Stop to Serve Jehovah

E good to train new publishers to dey use all their mind preach, and to dey preach every time. Many example don show sey this one dey help dem sabi preach well well. (Pr 22:6; Php 3:16) Make we talk about some things wey you fit do to help your Bible student sabi how to preach well.

  • Start to train your student to fit preach as soon as dem make am publisher. (km 8/15 1) Help am know why e good make e dey try preach every week. (Php 1:10) No dey talk bad things about the place or the people wey una dey preach to. (Php 4:8) Still help am know sey e good make e dey follow una group overseer and other people waka for preaching. This one go help am learn many things.​—Pr 1:5; km 10/12 6 ¶3

    One brother dey help new publisher prepare for preaching
  • Even after your student baptize, no stop to help am. Continue to train am for preaching, especially if e never study “God’s Love” book finish.​—km 12/13 7

    One sister dey preach with new publisher
  • If you dey preach with new publisher, use simple style preach. After e don preach for the first time, thank am well well. Still tell am other things wey fit make im preaching better.​km 5/10 7

    One papa and im pikin dey preaching
    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share