Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 2 p. 12-p. 13 par. 10
  • Dem Respect Jesus Before Im Mama Born Am

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Dem Respect Jesus Before Im Mama Born Am
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Angel Gabriel Visit Mary
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 2 p. 12-p. 13 par. 10
Donkey carry Mary for back; Elizabeth feel am as the pikin wey dey im belle jump as e hear Mary voice; Mary dey help Elizabeth for house

CHAPTER 2

Dem Respect Jesus Before Im Mama Born Am

LUKE 1:34-56

  • MARY GO VISIT IM FAMILY MEMBER ELIZABETH

When angel Gabriel tell Mary sey e go born boy wey im name go be Jesus, and wey go be King forever, Mary come ask am sey: “How this one go take happen, when I never sleep with any man before?”—Luke 1:34.

Angel Gabriel come tell am sey: “Holy spirit from God go come ontop you, and the Most High go use im power cover you. Na im make the pikin wey you go born go dey holy, and dem go call am God Son.”—Luke 1:35.

Gabriel still talk wetin help Mary believe, e sey: “See, even Elizabeth wey be your family member self don get belle. Na boy e go born, even as e don old. The person wey people dey talk sey e no fit born, im belle don reach six months now; because e no get anything wey God no go fit do.”—Luke 1:36, 37.

Wetin Mary talk show sey e believe wetin angel Gabriel tell am. Mary happy, come talk sey: “See! I be Jehovah servant! Make e happen to me as you talk.”—Luke 1:38.

As Gabriel comot, Mary come dey ready to go visit Elizabeth. Elizabeth and im husband Zechariah, dey live near Jerusalem, for the side of Judea wey get hill. From Mary house for Nazareth go reach Elizabeth house for Judea, e fit reach three or four days journey.

When Mary reach Zechariah house, e enter, come greet Elizabeth. As Elizabeth hear the greeting, holy spirit enter im body, e come tell Mary sey: “You be woman wey dem bless pass other women, and dem don still bless the pikin wey dey your belle! How I take get this kind blessing sey my Lord mama come see me? Because, as I hear your greeting, the pikin wey dey my belle happy, come jump.”—Luke 1:42-44.

Mary show sey e happy for wetin Elizabeth talk. E come sey: “Jehovah, I dey use all my heart praise you, and I no go fit stop to dey happy because of God wey be my Savior, because e don remember poor woman like me, wey be im servant. See! from now people from all generation go dey talk sey dem don bless me, because the Person wey get power pass don do big things for me.” For here, we see sey even as God take favor Mary reach, e still give God all the praise. E sey: “Im name dey holy. And from generation to generation, e dey show mercy to people wey dey fear am.”—Luke 1:46-50.

Holy spirit still move Mary to talk sey: “E don use im hand do big thing; and e don scatter people wey dey carry shoulder up because of wetin dem dey think for their mind. E don comot people wey get power well well from their throne. And people wey dey carry theirself down, e don raise dem up. E don give hungry people good things make dem chop belleful, and e don pursue rich people comot with nothing for their hand. E don help Israel im servant, e don remember to show dem im mercy, as e promise our papa papa dem, Abraham and im children, forever.”—Luke 1:51-55.

Mary dey help Elizabeth for house

Mary stay with Elizabeth reach three months, and e go don help Elizabeth well well because e go soon born. E really make sense sey this two women wey holy spirit help get belle dey together, especially for this special time for their life!

Remember, even before Mary born Jesus, dem show Jesus respect. When Mary reach Zechariah house, Elizabeth call Jesus “my Lord,” and the pikin wey dey Elizabeth belle “happy, come jump.” As we go see later, this one different from how other people treat Mary and the pikin wey dey im belle.

  • Wetin angel Gabriel tell Mary wey help am understand how e go take get belle?

  • How dem take respect Jesus before im mama born am?

  • How many months Mary stay with Elizabeth, and why e stay with am?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share