CHAPTER 39
Stubborn Generation Go Suffer
MATTHEW 11:16-30 LUKE 7:31-35
JESUS TALK BAD ABOUT SOME TOWNS
E PROMISE PEOPLE REST OF MIND
Jesus dey respect John well well, but which kind eye people take dey look John. Jesus sey: “This generation be like small children wey sitdown inside market dey call other children wey dem dey play with, sey: ‘We play flute for una, but una no dance; we cry well well, but una no beat una chest sey e pain una.’”—Matthew 11:16, 17.
Wetin Jesus mean? E explain am sey: “John come, e no dey chop and drink, but people sey, ‘E get demon.’ The Son of man come, e chop and drink, but people talk sey: ‘See! Na person wey dey chop too much, and wey dey drink well well, and na friend of tax collectors and sinners.’” (Matthew 11:18, 19) John na Nazirite and e live simple life. E no even dey drink but this generation sey e get demon for body. (Numbers 6:2, 3; Luke 1:15) But Jesus live like other people. E eat and drink, e no do am too much, but dem still talk sey e dey overdo am. E really dey hard to satisfy the people.
Jesus talk sey the generation be like small children for market wey no gree dance when other children play flute, and when others dey cry, e no pain dem. E come sey “Even with that one, better sense dey use the kind work wey e dey do show sey e dey righteous.” (Matthew 11:16, 19) Na true, the “work”—wey be the things wey Jesus and John do—show sey wetin the people dey talk against dem na lie.
After Jesus talk sey the generation stubborn, e come talk about some town where e do some miracles. The name of the towns na Chorazin, Bethsaida and Capernaum. Jesus sey if na for the town of Tyre and Sidon wey dey Phoenicia e do the miracles, those people for repent. E still talk about Capernaum where e don stay for some time. Even for there, many people no follow wetin e talk. Jesus come talk something about Capernaum people. E sey: “For the Judgment Day, e go better pass for the land of Sodom than for you.”—Matthew 11:24.
Jesus come praise im Father wey hide better truth wey dey im Word from people wey wise and know well well. But e show this things to people wey put body down like small children. (Matthew 11:25) Jesus dey tell this kind people sey: “Come meet me, all of una wey dey struggle and wey carry load wey dey press una down, and I go make una rest. Make una carry my yoke for una shoulder and learn from me, because I no dey quick vex and I dey carry body down, and una go get rest of mind. Because my yoke easy to carry, and my load no heavy.”—Matthew 11:28-30.
How Jesus take dey give people rest of mind? The leaders for Jew people religion don oppress the people with plenty tradition. One of dem na the strong law wey dem put for Sabbath Day. But Jesus dey give rest of mind because e dey teach dem the truth wey dey for God Word and e no add human being tradition join am. Some people don tire because of the way the government dey treat dem, and some no dey happy because of their own sin. Jesus show sey hope still dey for this kind people. Jesus show dem how God go fit take forgive their sin, and how dem go take become im friend.
Everybody wey accept Jesus yoke fit give God their life and serve our Father for heaven wey get soft mind and de pity people. This kind thing no be heavy load because God Law no hard to obey.—1 John 5:3.