Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 7 p. 22-p. 23 par. 6
  • Astrologers Come Visit Jesus

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Astrologers Come Visit Jesus
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Jehovah Save Jesus
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Dem Escape From One Wicked King
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 7 p. 22-p. 23 par. 6
Star dey lead the astrologers go where Joseph, Mary, and Jesus dey

CHAPTER 7

Astrologers Come Visit Jesus

MATTHEW 2:1-12

  • ONE “STAR” LEAD ASTROLOGERS GOJERUSALEM BEFORE E LEAD DEM GO WHERE JESUS DEY

Some men come from East, dem be astrologers. Astrologer na person wey dey study stars. Dem believe sey dem fit use am know the meaning of things wey dey happen for person life. (Isaiah 47:13) When dem dey East, dem see one star, na im dem start to follow am. The star no carry dem go Bethlehem, but na Jerusalem e carry dem go.

When the astrologers reach Jerusalem, dem ask sey: “Wey the pikin wey dem born, wey go be king of the Jews? We see im star when we dey East, and we don come greet am.”—Matthew 2:1, 2.

Star dey lead the astrologers go where Joseph, Mary, and Jesus dey

When King Herod wey be king for Jerusalem hear am, e no happy at all. E gather the chief priests and other people wey dey lead for Jew people religion, come ask dem sey; where dem talk sey dem go born the Christ. Dem answer am as e dey for God Word, sey na for Bethlehem. (Matthew 2:5; Micah 5:2) Herod tell dem sey make dem carry the astrologers come meet am, but make dem no let people know. E tell the astrologers sey: “Make una go find the small pikin well, and when una don see am, make una come tell me so that I go still go greet am.” (Matthew 2:8) But wetin really dey King Herod mind na to kill the pikin.

After the astrologers comot from King Herod palace, one surprising thing happen. That “star” wey lead dem from East come start to lead dem again. E clear sey this star no be ordinary star. The truth be sey e get who send this star come lead dem. Dem follow the star until e stop for the house wey Joseph, Mary, and Jesus dey.

Star dey lead the astrologers go where Joseph, Mary, and Jesus dey

When the astrologers enter the house, dem see Mary and Jesus. As dem see am, dem come bow down to am. Dem give am gold, frankincense, and myrrh. Later, when dem want go tell King Herod where Jesus dey, God use im angel warn dem for dream sey make dem no go. So when dem dey go back to their country, dem come pass another road.

Who be the person wey use the “star” lead this astrologers? Remember, the star no carry dem straight go meet Jesus for Bethlehem. But e first carry dem go Jerusalem where King Herod wey want kill Jesus dey. And e for kill Jesus if to sey God no warn dem sey make dem no go tell King Herod where Jesus dey. So e clear sey na Satan, wey be God enemy put the star for there, because e want make dem kill Jesus.

  • How we take know sey the “star” wey lead the astrologers no be ordinary star?

  • Where Jesus dey when the astrologers come visit am?

  • Why e correct to talk sey na Satan use the “star” lead the astrologers?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share