Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 8 p. 24-p. 25 par. 1
  • Dem Escape From One Wicked King

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Dem Escape From One Wicked King
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Jehovah Save Jesus
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Jesus Stay for Nazareth as E Dey Grow
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Jehovah No Ever Forget Joseph
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 8 p. 24-p. 25 par. 1
King Herod dey tell im soldiers sey make dem go kill all the small small boys wey dey Bethlehem

CHAPTER 8

Dem Escape From One Wicked King

MATTHEW 2:13-23

  • JOSEPH AND MARY CARRY JESUS RUN GO EGYPT

  • JOSEPH AND IM FAMILY PACK GO NAZARETH

Joseph see Jehovah angel for dream, the angel tell am something wey e go need to do quick quick. E tell am sey: “Get up, carry the small pikin and im mama, make una run go Egypt, make you stay there until I tell you wetin you go do, because Herod go soon dey look for the pikin make e kill am.” (Matthew 2:13) As Joseph wake up, e wake Mary, come tell am wetin the angel talk.

Joseph and Mary carry their pikin run go Egypt that night, dem no waste time. Na the correct time dem run, because Herod don know sey the astrologers don pass another road go house. E tell dem sey make dem come tell am where the pikin dey, but dem no go. E vex no be small. Because e want kill Jesus, e come talk sey make dem kill all the small boys wey dey two years come down. Whether dem dey Bethlehem or the area wey near am. E tell dem from two years come down, because wetin the astrologers talk show sey the pikin suppose dey around that age.

One soldier dey drag one small boy from im mama hand

Na really wicked thing Herod do as e kill all this boys! We no know how many boys dem kill. The kind cry wey the boys mama cry match wetin prophet Jeremiah talk for Bible.—Jeremiah 31:15.

By now, Joseph and im family don run go Egypt, and na there dem come dey stay. One night, Joseph see Jehovah angel for dream again. E tell Joseph sey: “Get up, carry the pikin and im mama, make una go the land of Israel, because the people wey want kill the pikin don die.” (Matthew 2:20) Now Joseph don ready to go back to where dem come from. This one still make another thing wey Bible talk happen, sey God Son go come out from Egypt.—Hosea 11:1.

E fit be sey wetin dey Joseph mind na to go back to Judea, where dem dey live before dem go Egypt. This place near Bethlehem. But e come hear sey na Herod wicked pikin wey im name na Archelaus be king for Judea. For another dream, God warn Joseph about wetin fit happen if e go back to Judea. Na im make Joseph and im family go live for Nazareth, one far area for Galilee. So dem no stay near the area where the temple dey. This one still match another thing wey Bible talk, sey “Dem go call am Nazareth person.”—Matthew 2:23.

  • Which time the astrologers go back, wetin the king do, and how God take protect Jesus?

  • Why Joseph and im family come back from Egypt, and why dem no go back to Bethlehem?

  • Which things Bible wey talk wey happen?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share