CHAPTER 9
Jesus Stay for Nazareth as E Dey Grow
MATTHEW 13:55, 56 MARK 6:3
JOSEPH AND MARY BORN OTHER CHILDREN
JESUS LEARN HAND WORK
Jesus don dey grow. The family dey live for one small city wey dem dey call Nazareth. Nazareth dey the north side of Judea, for the area wey dem dey call Galilee. The place dey ontop hill, and e dey the west side of one big river wey dem dey call Sea of Galilee.
Jesus dey around two years when Joseph and Mary carry am come here from Egypt. That time na only Jesus be the pikin wey Joseph and Mary get. Later, dem come born other children—James, Joseph, Simon, Judas and some girls. So, Jesus get at least six brothers and sisters wey e senior.
Jesus still get other family members. We already know Elizabeth and im pikin, John wey dey live for Judea. E fit be sey Salome wey dey stay for Galilee with im husband, Zebedee na Mary sister. Their two sons na James and John and dem fit be Jesus first cousin. We no know whether Jesus and this boys really live together as dem dey grow. But we know sey after dem don grow, all of dem come dey do things together. Dem come even be part of Jesus apostles.
Joseph really need to work to fit take care of im family. Na carpenter e be. Since Joseph take care of Jesus like sey na im born am, people dey always call Jesus, “the carpenter pikin.” (Matthew 13:55) Joseph teach Jesus carpenter work, and Jesus know the work well well. Some people even dey call Jesus, “the carpenter.”—Mark 6:3.
Joseph and im family make Jehovah the number one person for their life. Dem dey follow the Law wey e give dem, like the one wey sey make dem dey teach their children wetin Jehovah want “when dem dey for house and when dem dey waka for road, before dem sleep, and when dem wake up.” (Deuteronomy 6:6-9) One synagogue dey Nazareth. We dey sure sey Joseph dey always carry im family go worship God for there. Bible talk sey Jesus dey always go the synagogue, and na so “e dey always do for Sabbath day.” (Luke 4:16) And the family still like to dey travel go Jehovah temple wey dey Jerusalem.