Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb18 March p. 7
  • “Continue to Dey Watch”

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • “Continue to Dey Watch”
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2018
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2018
mwb18 March p. 7
The ten virgins wey Jesus talk about for parable

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 25

“Continue to Dey Watch”

25:1-12

The parable of the ten virgin wey Jesus talk about na for the people wey go rule with am for heaven. But the lesson concern all of us wey dey serve Jehovah. (w15 3/15 12-16) ‘So, make we continue to dey watch, because we no know the day or the time.’ (Mt 25:13) You fit explain wetin the parable mean?

  • The man wey dey marry (vs. 1)​—Na Jesus

  • The five virgin wey get sense and wey prepare (vs. 2)​—Na the people wey go rule with Jesus for heaven. Dem ready to do their work well, and make their light shine till the end (Php 2:15)

  • The shout: “The man wey dey marry don come o!” (vs. 6)​—Na the things wey show sey Jesus don dey around

  • The five virgins wey no get sense (vs. 8)​—Na the people wey God don first choose to rule with Jesus for heaven, but dem no continue to dey watch and their light no shine reach the end

  • The five virgins wey no gree share their oil (vs. 9)​—This one mean sey, after Jehovah don give the anointed ones their final stamp, dem no go fit help the ones wey fall comot from Jehovah side

  • “The man wey dey marry, come” (vs. 10)​—Na when Jesus go come judge people near the end of great tribulation

  • The virgins wey ready come follow the man wey dey marry enter the marriage feast, and dem come lock door (vs. 10)​—Na when Jesus go gather the anointed ones go heaven, but e no carry the ones wey fall comot from Jehovah side

Wetin Jesus talk for the parable no mean sey many of the people wey go join am rule go fall comot, and Jehovah go need to replace dem. No! But, na warning for all of dem. E dey their hand to choose whether dem go continue to watch and dey ready, or whether dem go stop to watch. Na im make Jesus talk sey: “Make all of una ready.” (Mt 24:44) Whether we go live for heaven or for Paradise, Jesus want make we ready to use all our heart serve Jehovah well, and make we continue to dey watch.

Wetin I dey do now to show sey I dey watch?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share