Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwbr18 March pp. 1-6
  • Book to Take Prepare Life and Preaching Meeting

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Book to Take Prepare Life and Preaching Meeting
  • Book to Take Prepare Life and Preaching Meeting (2018)
  • Small Topic Dem
  • MARCH 5-11
  • MARCH 12-18
  • MARCH 19-25
  • MARCH 26–APRIL 1
Book to Take Prepare Life and Preaching Meeting (2018)
mwbr18 March pp. 1-6

Book to Take Prepare Life and Preaching Meeting

MARCH 5-11

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 20-21

“Any of Una Wey Want Be Great Person Must Serve the Rest of Una”

(Matthew 20:3) E still comot around the third hour, e come see other people wey no get work for market;

nwtsty media

Market

For some market, people dey like to sell things for road. One example na the picture wey dey the Meeting Book. Dem go pack many things for road sotey road go block. E easy for people wey dey live around to fit buy things like spoon, clay pot, things wey dem use glass make, and even fresh food. Because fridge no dey that time, many people dey go market everyday. People wey dey sell, fit hear news from people wey come buy or other visitors. People wey no get work fit wait for there to get work, and you fit still see children wey dey play for there. Jesus cure sick people for market, and Paul preach for market. (Ac 17:17) But because scribes and Pharisees na people wey dey carry shoulder up, dem like make people dey greet dem for this kind place.

(Matthew 20:20, 21) “Na im the mama of Zebedee sons carry im sons come meet am. E bow down to am, come beg am make e do something for am. 21 “Jesus ask am sey: “Wetin you want?” E tell am sey: “Promise me sey for your Kingdom, this my two sons go sitdown, one for your right side and the other one for your left.”

nwtsty study note for Mt 20:20, 21

mama of Zebedee sons: This na the mama of apostle James and John. The Bible book of Mark talk sey na James and John go meet Jesus by theirself. This one show sey na dem really want the position, but dem send their mama to help dem beg Jesus. Their mama name na Salome, and e fit be sey na Jesus aunty e be.​—Mt 27:55, 56; Mr 15:40, 41; Joh 19:25.

one for your right side and the other one for your left: The right side and the left side wey this place dey talk about, na position of respect and power. But na the person wey dey the right side dem dey respect pass.​—Ps 110:1; Ac 7:55, 56; Ro 8:34.

(Matthew 20:25-28) But Jesus call dem and tell dem sey: “Una know sey people wey dey rule other nations dey rule their people anyhow. And their great men dey use their power oppress dem. 26 Make una no ever be like that. Any of una wey want be great person, must serve the rest of una, 27 and any of una wey want be first must be una slave. 28 Just as the Son of man come, no be make dem serve am, but na to serve people, and to use im life pay for many people.”

nwtsty study note for Mt 20:26

serve: Or “servant.” The Greek word wey dem take dey describe servant na di·aʹko·nos. Many times, Bible dey use am for person wey dey carry body down, and wey no dey tire to serve other people. For Bible dem use this word take describe Jesus Christ (Ro 15:8), servants of Christ (1Co 3:5-7; Col 1:23), ministerial servants (Php 1:1; 1Ti 3:8), house servants (Joh 2:5, 9) and government workers (Ro 13:4).

Better Things Wey Dey Inside Bible​—Find Am Well

(Matthew 21:9) But all the people wey dey im front and back come dey shout sey: “We pray, make you save David Son! Anybody wey come with Jehovah name go get blessing! We pray make you wey dey heaven save am!”

nwtsty study note for Mt 21:9

We pray, make you save: Lit., “Hosanna.” This Greek word come from the Hebrew word wey mean “we pray, make you save” or “abeg, make you save.” Dem use am for here to beg God to save or to let David Son win. But as time dey go, dem come dey use am for song and prayer. This Hebrew word dey Ps 118:25, wey be part of the songs wey dey Ps 113-118. E dey easy to remember this word because dem dey sing am for Passover time. One way God take answer this prayer to save David Son, na when e resurrect am after e die. For Mt 21:42, Jesus quote wetin dey Ps 118:22, 23, and e talk sey na wetin happen to the Messiah.

David Son: As dem call am David Son, e show sey Jesus come from David family, and sey na im be the Messiah.

(Matthew 21:18, 19) For early morning when e dey come back to the city, e come dey hungry. 19 E see one fig tree wey dey near road, e waka go near am, but na only leaf e see ontop. E come tell the tree sey: “You no go ever produce fruit again.” At once, the tree come die.

jy 244 ¶4-6.

Jesus Use Fig Tree Teach Better Lesson About Faith

But why Jesus make the tree die? E talk why e do am for the answer wey e give dem: “I dey tell una true sey if una get faith, and una no dey doubt, no be only wetin I do to this fig tree una go do, but even if una tell this mountain sey, ‘Comot from here and enter inside sea,’ e go happen. And una go get all the things wey una dey pray for, if una get faith.” (Matthew 21:21, 22) Na the point wey e talk before about faith e talk again for here, sey if person get faith e fit move mountain.​—Matthew 17:20.

As Jesus make the tree die, e use am teach correct lesson about why e good to get faith. E talk sey: “If una get faith sey una don already get everything wey una dey ask and pray for, una go get am.” (Mark 11:24) This na better lesson for all Jesus followers! Especially for im apostles, because of the serious test wey dem go soon face. But e still get another lesson about faith wey Jesus use the fig tree teach.

Like this fig tree, the nation of Israel dey hide who dem really be. Dem be people wey Jehovah choose to worship am. And dem agree sey dem go worship Jehovah. For people eye, dem be like who dey serve God well. But their character don really show sey dem no get faith. Dem even reject Jesus wey be God Son! So, dem come be like that tree wey no produce fruit. As Jesus make the fig tree wey no produce fruit die, e show wetin go happen to the nation of Israel.

Bible Reading

(Matthew 20:1-19) “The Kingdom wey dey heaven be like one oga wey get house. E comot for house early morning go hire people wey go work for im farm. 2 After im and the workers don agree sey e go pay dem one de·nar′i·us for one day, e come send dem go im farm. 3 E still comot around the third hour, e come see other people wey no get work for market; 4 e come tell dem sey, ‘Make una go join work for my farm, and I go pay una well.’ 5 Dem come go. E still comot around the sixth and ninth hour, and e do the same thing. 6 E go the final one around the eleventh hour, and e still see other people wey stand there, e come ask dem sey, ‘Why una stand here since morning without work?’ 7 Dem answer am sey, ‘Na because nobody don hire us.’ E come tell dem sey, ‘Make una go join work for my farm.’ 8 “When evening reach, the owner of the farm come call the man wey e put in charge of the farm. E tell am sey, ‘Call the workers and pay dem their money. Start with the last person and end with the first person.’ 9 When the people wey start work for the eleventh hour come, e pay each of dem one de·nar′i·us. 10 So when e reach the first people turn, dem come dey think sey their money go big pass other people own, but na one de·nar′i·us e still pay dem. 11 As dem collect the money, dem come start to complain about the oga wey get the house 12 dem talk sey, ‘Na only one hour this people work; you still pay dem the same amount wey you pay us, and na we do the work and suffer the heat!’ 13 But e answer one of dem sey, ‘My friend, I no do you bad thing. No be one de·nar′i·us you agree sey I go pay you? 14 Take your own, dey go. I want pay this last people the same amount wey I pay you. 15 I no get right to do wetin I like with my things? Or you dey jealous because I good?’ 16 Na so the last ones go take be the first, and the first, go be the last.” 17 For road as dem dey go up to Jerusalem, Jesus carry im 12 disciples go one side come tell dem sey: 18 “See! We dey go up, to Jerusalem, and the Son of man go enter the chief priests and the scribes hand, and dem go sentence am to death. 19 Dem go give am to people of the nations so that dem go treat am anyhow, beat am and come nail am ontop pole make e die there, and after three days e go rise up.”

MARCH 12-18

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE| MATTHEW 22-23

“Obey the Two Commandment Wey High Pass”

(Matthew 22:36-38) “Teacher, which commandment for the Law high pass?” 37 E tell am sey: “‘You must love Jehovah your God with all your heart, all your soul and all your mind.’ 38 This na the highest and first commandment.

nwtsty study note for Mt 22:37

heart: Many times when Bible use the word heart, e dey talk about who the person really be. But when e use heart together with “soul” and “mind,” e dey get one particular meaning. E fit mean how something take dey affect person, wetin e really like, or how e dey feel. As Jesus use this three word (heart, soul, and mind) together for this verse, e dey show how our love for God suppose strong reach. We must use everything wey we get, love God.

soul: Or “everything about person.”

mind: Na the engine of person sense. We must use am learn about God and know the kind person wey e be before our love for am go strong. (Joh 17:3, ftn.; Ro 12:1) When dem write De 6:5 for the original Hebrew language, na ‘heart, soul, and strength’ dem use. But when dem quote wetin dey this verse for the book of Matthew, dem use “mind” wey be Greek word instead of “strength”. Many reason fit dey why dem use two different word. First, olden days Hebrew no get one word for “mind.” Many times, dem dey use the same word wey dem dey use for “heart.” When Bible use the word mind, e dey talk about who we really be; our thinking, feeling, and how we dey behave. (De 29:4; Ps 26:2; 64:6; check the study note for heart for this verse.) Because of this one, for many place for Greek Scriptures dem dey use “mind” for where Hebrew Scriptures use “heart.” (Ge 8:21; 17:17; Pr 2:10; Isa 14:13) Another reason wey fit make Matthew use the Greek word “mind” instead of “strength” when e dey quote wetin dey De 6:5 be sey, the Hebrew word wey be “strength” fit mean the power wey we take dey work, or wey we take dey think. As e be sey this two word get almost the same meaning, this one don help us know why the people wey write the Gospel no use exactly the same word wey dey Deuteronomy when dem quote am.

(Matthew 22:39) The second one wey be like the first one na: ‘You must love your neighbor as yourself.’

nwtsty study note for Mt 22:39

The second one: For Mt 22:37, Jesus answer the Pharisee question direct. But e no stop for there, e still tell am the second commandment (Le 19:18). E use this one show sey person no go fit obey one leave the other one and sey anybody wey obey this two commandment don obey the whole Law and the Prophets.​—Mt 22:40.

neighbor: The Greek word for “neighbor” mean person wey near you. But, no be only person wey near you. E fit still be anybody wey you dey do things with.​—Lu 10:29-37; Ro 13:8-10.

(Matthew 22:40) Na this two commandment hold the whole Law and the Prophets.”

nwtsty study note for Mt 22:40

the Law . . . the Prophets: “The Law” na the Bible book of Genesis to Deuteronomy. “The Prophets” na the Bible books wey talk about the things wey the prophets write for Hebrew Scriptures. But when dem use the two together, e fit mean wetin the whole Hebrew Scriptures dey talk about.​—Mt 7:12; 22:40; Lu 16:16.

hold: The Greek word wey dem translate as “hold” for here, show sey without this two law, other law no go fit stand. So, wetin Jesus mean for here be sey everything wey the whole Hebrew Scriptures dey talk about na love for God and neighbour, no be only the Ten Commandment.​—Ro 13:9.

Better Things Wey Dey Inside Bible​—Find Am Well

(Matthew 22:21) Dem answer am sey: “Caesar.” Na im e tell dem sey: “So, pay back Caesar things to Caesar, but God things to God.”

nwtsty study note for Mt 22:21

pay back to Caesar, wetin be Caesar things: Wetin Jesus talk for this Bible verse and for Mr 12:17 and Lu 20:25, na the only time wey Jesus talk about Roman emperor. To pay tax, and to obey government na part of the things wey be “Caesar things.” But we no go do wetin Jehovah hate because we want obey government.​—Ro 13:1-7.

but to God, wetin be God own: We go worship Jehovah from our heart, love am, hold am tight and dey obey am.​—Mt 4:10; 22:37, 38; Ac 5:29; Ro 14:8.

(Matthew 23:24) Blind leaders wey dey filter fly comot, but dey swallow camel!

nwtsty study note for Mt 23:24

dem dey filter fly comot, but dey swallow camel: Fly and camel dey among the smallest and the biggest animal wey no clean for Israel people time. (Le 11:4, 21-24) The example of fly and camel wey Jesus use show the kind character wey Pharisee people get. Dem dey filter fly comot, meaning sey dem dey do the small small things wey dey the Law. But dem leave the important things wey the Law sey make dem do, that one be like when person dey swallow camel even as e big reach.

Bible Reading

(Matthew 22:1-22) Jesus come use story teach dem again sey: 2 “The Kingdom wey dey heaven be like one king wey arrange marriage feast for im son. 3 E come send im slaves make dem go call the people wey dem invite for the marriage feast, but the people no gree come. 4 E still send other slaves sey, ‘Tell the people wey dem invite sey: “See! I don prepare my evening food, I kill my bull and other better animal, and everything don ready. Make una come the marriage feast.”’ 5 But dem no even mind am, so dem comot, this one go im farm, and another one go im business; 6 but the rest catch the slaves, beat dem well well, and even kill dem. 7 “The king come vex well well, e send im soldiers make dem go kill the people wey kill im slaves, and burn their city. 8 Na im e tell im slaves sey, ‘The marriage feast don ready, but the people wey we invite no qualify. 9 So, make una go the different different road wey dem dey pass go out of the city, and invite anybody wey una see come the marriage feast.’ 10 Na im the slaves go the road, dem come gather all the people wey dem see, both good and bad people; the hall wey dem dey do the marriage come full with people wey dey chop. 11 “When the king come check the people wey come, e see one man wey no wear marriage garment. 12 E come ask the man sey, ‘My friend, how you take enter here when you no wear marriage garment?’ But e no talk anything. 13 Na im the king tell im servants sey, ‘Make una tie im hand and leg, and make una trowey am for outside, inside darkness. Na there e go dey, dey cry and dey grind im teeth.’ 14 “Because na many people dem call, but na some dem choose.” 15 Na im the Pharisee people comot, dem come go plan how dem go take catch am with wetin e talk. 16 Dem come send their disciples and the people wey dey follow Herod go meet am, dem tell am sey: “Teacher, we know sey you dey talk true well well, and wetin you dey teach about God na true. You no dey do things so that people go favor you because no be people face you dey look. 17 Now tell us, wetin you think? Law support to dey pay head tax to Caesar?” 18 But as Jesus know their wicked mind, e tell dem sey: “Pretenders, why una dey test me? 19 Show me the tax coin.” Dem come give am one de·nar′i·us. 20 E ask dem sey: “Which person face and name be this?” 21 Dem answer am sey: “Caesar.” Na im e tell dem sey: “So, pay back Caesar things to Caesar, but God things to God.” 22 When dem hear am, dem no fit talk again, dem come leave am, waka comot.

MARCH 19-25

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 24

“Continue to Serve Jehovah Well for This Last Days”

(Matthew 24:12) and because people wey dey break law go plenty well well, the love wey most people get go come cold.

it-2 279 ¶6

Love

Our Love Fit No Strong Again. Jesus Christ tell im disciples many things wey go happen for front. One of dem be sey, many people wey dey claim sey dem know God, no go get love (a·gaʹpe) again. (Mt 24:3, 12) Apostle Paul even talk sey for last days, people “go like money” well well. (2Ti 3:1, 2) So, e clear sey person fit start to love bad things, and the love wey e first get go come weak. This one really show why e good to dey think about wetin we dey learn for Bible and to dey do am. This things go help us continue to get strong love.​—Eph 4:15, 22-24.

(Matthew 24:39) and dem no even know until the heavy rain come, and sweep all of dem comot. Na so e go still be when the Son of man, go dey around.

w99 11/15 19 ¶5

You Dey Do Everything Wey God Want Make You Do?

5 Jesus Christ talk about our time when e sey: “Just as e be for Noah time, na so e go be when the Son of man dey around. That time before the heavy rain fall, men dey chop, drink and marry, and dem dey give women out for marriage, until Noah enter inside the ark, and dem no even know until the heavy rain come, and sweep all of dem comot. Na so e go still be when the Son of man, go dey around.” (Matthew 24:37-39) For person to eat and drink na normal thing, but e no good to overdo am. And marriage na better thing wey God arrange by imself. (Genesis 2:20-24) But if we see sey this normal things don become the main thing for our life, make we beg Jehovah to help us. Jehovah fit help us put im Kingdom first, do wetin good, and still help us do everything wey e want make we do.​—Matthew 6:33; Romans 12:12; 2 Corinthians 13:7.

(Matthew 24:44) Because of this one, make una ready too, because the Son of man go come the time wey una no think sey e go come.

jy 259 ¶5

Jesus Apostles Sey Make E Show Dem Sign

Jesus warn im disciples sey dem go need to dey awake, and dey ready. E use another example show dem how this warning dey important reach. E sey: “Know one thing: If to sey the owner of the house know when the thief go come, e for stay dey watch and no allow the thief enter im house. Because of this one, make una ready too, because the Son of man go come the time wey una no think sey e go come.”​—Matthew 24:43, 44.

Better Things Wey Dey Inside Bible​—Find Am Well

(Matthew 24:8) All this one na the beginning of serious pain.

nwtsty study note on Mt 24:8

serious pain: The Greek word wey dem translate to serious pain dey talk about the kind serious pain wey woman dey get when e dey born pikin. Dem use am for this verse to show the wahala, pain, and suffer wey we dey face. So, as Bible don talk am for Mt 24:21, e fit be sey the wahala, suffer and pain wey we go face before the great tribulation come, go happen many times, tough well well, and long like labor pain.

(Matthew 24:20) Continue to dey pray make the time wey una go run no be for cold season or for Sabbath day;

nwtsty study note for Mt 24:20

cold season: For this kind season, weather dey always cold well well, heavy rain dey fall, and water dey full everywhere. So, e no go easy for person to travel, to find food and even see where to put head.​—Ezr 10:9, 13.

for Sabbath day: For place like Judea, the Law wey dem put for Sabbath day no go fit make person travel far or carry load. Dem even dey lock their city gate for Sabbath day.​—Go check Ac 1:12 and App. B12.

Bible Reading

(Matthew 24:1-22) As Jesus dey comot from the temple, im disciples come meet am to show am the whole temple. 2 Na im e tell dem sey: “Una dey see all this things? I dey tell una true sey, e no get as one stone go take remain ontop another stone, because dem go scatter all of dem reach ground.” 3 As e sitdown for Mount of Olives, im disciples come meet am when e dey alone. Dem ask am sey: “Tell us, which time all this things go happen, and wetin go show sey you dey around and sey the end don dey near?” 4 Jesus answer dem sey: “Sofri so that nobody go deceive una, 5 because many people go come with my name, dey talk sey, ‘I be Christ,’ and dem go deceive many people. 6 Una go hear about war, and news about war, but make sure sey e no make una fear, because this things must happen but the end never reach. 7 “Nation go fight nation and kingdom go fight kingdom, and food no go plenty again and earthquake go dey happen for different different place.” 8 All this one na the beginning of serious pain. 9 “And dem go carry una give people wey go suffer and kill una, and the whole world go hate una because of my name. 10 That time, many people go fall, dem go betray one another, and hate one another. 11 Many fake prophet go come and dem go deceive many people; 12 and because people wey dey break law go plenty well well, the love wey most people get go come cold. 13 But na the person wey endure reach the end, go save. 14 And dem go preach the good news about the Kingdom for everywhere wey people dey for this earth, so that all the nation go know, and after that one, the end go come. 15 “As prophet Daniel talk, if una see sey the yeye thing wey dey cause destruction stand for the holy place, (make the person wey dey read use sense), 16 make the people wey dey Judea begin run go the mountains. 17 Make the man wey dey ontop house no come down come take things comot from im house, 18 and make the man wey dey farm no come house to collect im outer garment 19 Women wey get belle and women wey newly born go suffer well well that time! 20 Continue to dey pray make the time wey una go run no be for cold season or for Sabbath day; 21 because that time, great tribulation wey never happen since the beginning of the world come reach now, go come. And e no go happen again. 22 In fact, if dem no reduce the days, nobody go save; but because of the people wey dem don choose, the days go short.

MARCH 26–APRIL 1

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 25

“Make Una Continue to Dey Watch”

(Matthew 25:1-6) “The Kingdom wey dey heaven be like ten virgins wey carry their lamp go meet one man wey dey marry. 2 Five no get sense and five get sense. 3 The five wey no get sense carry their lamp, but no carry oil, 4 But the five wey get sense carry their lamp and still carry oil for container. 5 As the man wey dey marry dey delay to come, sleep come dey catch dem, and dem come sleep go. 6 For midnight, dem come hear one shout sey: ‘The man wey dey marry don come o! Make una go meet am.’

(Matthew 25:7-10) Na im all the virgin come get up, come on their lamp. 8 The five wey no get sense come tell the five wey get sense sey, ‘Make una give us small oil from una own, because our lamp go soon quench.’ 9 The five wey get sense answer dem sey: ‘This one fit no reach we and una, so make una go where dem dey sell, and buy some for unaself.’ 10 As dem dey comot go buy the oil, na im the man wey dey marry come. The virgins wey ready come follow am enter the marriage feast, dem come lock the door.

(Matthew 25:11, 12) Later, when the other virgins come back, dem start to sey, ‘Oga, Oga, open door for us!’ 12 E answer dem sey, ‘I dey tell una the truth, I no know una.’

Better Things Wey Dey Inside Bible​—Find Am Well

(Matthew 25:31-33) “When Son of man go come with im glory, e go come with all the angels, then e go sitdown for im wonderful throne. 32 People for all nation go gather for im front, and e go separate dem from each other, the way shepherd dey separate sheep from goat. 33 And e go put the sheep for im right side, but the goats for im left side.

w15 3/15 27 ¶7

Continue to Dey Support Christ Brothers

7 Today, we don understand the story of the sheep and the goat pass before. We don understand sey na Jesus be “the Son of man,” and the King. The people wey e call “my brothers” na the men and women wey God use im spirit choose, to rule with Christ for heaven. (Rom. 8:16, 17) “The sheep” and “the goats” mean people from all nation. This people no follow for people wey God use im holy spirit choose. Which time dem go judge dem? Na near the end of the great tribulation. Why dem go judge some people as sheep and some as goat? Na because of the way dem take treat Christ brothers wey remain for earth. The end of this world don near finish. But we happy well well sey Jehovah don help us small small to understand the meaning of this story and other story wey dey Matthew chapter 24 and 25!

(Matthew 25:40) And the King go answer dem sey, ‘True true I dey tell una sey, just as una do am to the one wey small pass among this my brothers, una don do am to me.’

w09 10/15 16 ¶16-18

“Una Be My Friends”

16 If you want live for Paradise, how you go take show sey you dey support Christ brothers, and sey you be their friend? Make we see three ways. The first way na to use all our mind preach. Jesus command im brothers make dem preach the good news for the whole world. (Matt. 24:14) But, if the other sheep no help dem for this work, e go really hard Christ brothers wey still dey this earth to fit do this work. So, any time wey members of the other sheep go preach, dem dey help Christ brothers for this holy work wey Jesus give dem. The slave wey get sense wey dem fit trust, dey happy well well sey their friends dey help dem for this work. And Jesus self dey happy.

17 The second way na to use our money support the preaching work. Jesus encourage im followers to use “this world property” make friend with im and im Father. (Luke 16:9) No be sey we fit use money buy our friendship with Jesus or Jehovah. But as we dey use the things wey we get support the Kingdom work, we dey show sey we love God, and sey our friendship with am no be for mouth. (1 John 3:16-18) We dey use our money support the Kingdom work when we dey preach, when we contribute to build and maintain the different different place wey we dey meet to worship Jehovah, and when we contribute to support the world wide preaching work. Whether wetin we contribute big or small, make we know sey Jehovah and Jesus really value am.​—2 Cor. 9:7.

18 The third way na to dey cooperate with the elders for congregation. Jehovah don choose dem with im spirit, and na Jesus dey direct dem. (Eph. 5:23) Paul write for Bible sey: “Make una dey obey people wey dey lead una and make una dey do wetin dem talk.” (Heb. 13:17) Sometimes, e no dey easy for us to do the things wey elders tell us from Bible. E fit be sey, we know some of the things wey dem no dey do well. This one fit make us no take wetin dem talk serious. But make we remember sey, Jesus Christ wey be the head of the congregation still dey use dem, even as dem no dey perfect. So, the way we behave when dem tell us wetin we go do, fit affect our friendship with Jesus. When we use all our mind obey dem even with their mistake, we dey show sey we really love Jesus Christ.

Bible Reading

(Matthew 25:1-23) “The Kingdom wey dey heaven be like ten virgins wey carry their lamp go meet one man wey dey marry. 2 Five no get sense and five get sense. 3 The five wey no get sense carry their lamp, but no carry oil, 4 But the five wey get sense carry their lamp and still carry oil for container. 5 As the man wey dey marry dey delay to come, sleep come dey catch dem, and dem come sleep go. 6 For midnight, dem come hear one shout sey: ‘The man wey dey marry don come o! Make una go meet am.’ 7 Na im all the virgin come get up, come on their lamp. 8 The five wey no get sense come tell the five wey get sense sey, ‘Make una give us small oil from una own, because our lamp go soon quench.’ 9 The five wey get sense answer dem sey: ‘This one fit no reach we and una, so make una go where dem dey sell, and buy some for unaself.’ 10 As dem dey comot go buy the oil, na im the man wey dey marry come. The virgins wey ready come follow am enter the marriage feast, dem come lock the door. 11 Later, when the other virgins come back, dem start to sey, ‘Oga, Oga, open door for us!’ 12 E answer dem sey, ‘I dey tell una the truth, I no know una.’ 13 “So, make una continue to dey watch, because una no know the day or the time. 14 “Because e just be like one man wey call im slaves before e travel abroad, come put all im property for their hand. 15 E give one, five talent, come give another one two talent, and still give another one, one talent. E give all of dem as their power reach, and e come travel abroad. 16 At once the one wey dem give five talent go do business with the five, e come gain more five. 17 The same way, the one wey dem give two, gain more two. 18 But the one wey dem give one talent comot go dig ground and hide im oga money. 19 “After long time, their oga come return to settle account with dem. 20 Na im the one wey dem give five talent come out, come bring another five talent, e talk sey, ‘Oga, you give me five talent, see, I don gain more five talent.’ 21 Im oga tell am sey, ‘Well done, better slave wey dem fit trust! As you show sey dem fit trust you for small thing, I go put many things for your hand. Come follow your oga enjoy.’ 22 The next one wey dem give two talent come out, e come talk sey, ‘Oga, you give me two talent, see, I don gain two more talent.’ 23 Im oga tell am sey: ‘Well done, better slave wey dem fit trust! As you show sey dem fit trust you for small thing, I go put many things for your hand. Come follow your oga enjoy.’

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share