Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • ll part 9 pp. 20-21
  • Which Time Paradise Go Come?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Which Time Paradise Go Come?
  • Listen to God Make You Live Forever
  • Similar Material
  • This World Go Soon End?
    Wetin Bible Dey Teach Us?
  • Which Kind Love Dey Really Make Person Happy?
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Listen to God Make You Live Forever
ll part 9 pp. 20-21

PART 9

Which Time Paradise Go Come?

All the bad things wey dey happen now show sey e no go tey before God Kingdom go come. Luke 21:10, 11; 2 Timothy 3:1-5

Problem wey dey everywhere for this last days—People dey play gamble, war, different sickness, food no dey, pikin no dey obey papa and mama, husband dey beat wife

Bible don talk am sey all this bad things wey dey happen today go happen. E talk sey people go like money no be small, pikin no go dey hear word, people go wicked well well, and dem go like enjoyment pass anything.

Bible still talk sey ground go dey shake-open (earthquakes), people go dey fight war, food no go dey, and sickness go full everywhere. True true, all this things dey happen now.

Jehovah Witness  dey preach the good news about God Kingdom to one man

Jesus even talk sey, everywhere for this world, people go dey preach about the good things wey God Kingdom go do.—Matthew 24:14.

God Kingdom go comot all bad bad things. 2 Peter 3:13

Wicked people dey die for Armageddon, and God dey punish Satan and im demon

Small time, Jehovah go kill all the bad people wey dey for this world.

Jesus go chain Satan and the demons.

Jesus sitdown for im throne for heaven and people wey come from different place dey happy

All the people wey do wetin God dey talk go enter Paradise where nothing go make dem fear again and dem go love theirself well well.

  • Wetin Jesus talk sey go happen for our time?—Matthew 24:3-14.

  • God go kill bad people.—2 Peter 3:7.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share