Wetin Dey Part 7
This part talk about wetin happen to King Saul and King David, and e take about 80 years. Saul first be person wey no dey carry shoulder and person wey dey serve God well. But as time dey go, e leave Jehovah. Jehovah come comot am from king and e tell Samuel make e choose David as the next king. Saul try to kill David many times because e dey jealous am, but David no try to do am back. Jonathan wey be Saul pikin know sey na David Jehovah choose, so e support am. David do some bad things, but e no vex when Jehovah correct am. If you be papa or mama, help your pikin see sey e good to dey do wetin Jehovah talk.