Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 June pp. 16-17
  • Question From People Wey Dey Read Our Book

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Question From People Wey Dey Read Our Book
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Similar Material
  • You Go Get the Mark Wey Go Show Sey God Go Save You?
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 June pp. 16-17
Jesus dey arrange im army for heaven

For our time the man wey carry wetin person take dey write, na Jesus Christ; e go mark the people wey e go save

Question From People Wey Dey Read Our Book

The man wey carry wetin person take dey write and the six men wey carry wetin dem take dey scatter things for Ezekiel vision, who dem be?

Dem be the army wey dey heaven wey join scatter Jerusalem reach ground and for Armageddon dem go still join hand finish this wicked world wey Satan dey control. Why e be sey as we take sabi am now make sense?

After Jehovah show Ezekiel the bad things wey Jerusalem people dey do, e show am wetin go happen before dem go scatter am. Na around 607 years before Jesus time dem scatter Jerusalem. E see six men wey carry wetin dem take dey scatter things and one man dey with dem, ‘im cloth na linen,’ and e carry ‘wetin person take dey write.’ (Ezek. 8:6-12; 9:2, 3) Jehovah tell the man sey: ‘Waka for inside the whole town, put mark for the front of people head wey no happy and wey dey complain about the bad things wey dey happen for the town.’ Dem come tell the six men wey carry wetin dem take dey scatter things sey make dem kill all the people wey no get the mark. (Ezek. 9:4-7) Wetin the vision teach us and who be the man wey carry wetin person take dey write?

Ezekiel see this vision around 612 years before Jesus time. The first meaning wey this vision get be sey Babylon army go scatter Jerusalem reach ground. E happen five years after the vision. Na true sey Babylon people no dey worship Jehovah but e use dem scatter Jerusalem. (Jer. 25:9, 15-18) Why Jehovah use dem? Na because im people no do wetin e want. But this one no mean sey dem go just dey kill people anyhow; na only bad people dem go kill. Because of the love wey Jehovah get, e make arrangement to save Jew people wey no happy for the bad things wey dey happen for Jerusalem.

Ezekiel no follow put mark for people head and e no join kill the people wey no get mark. But na the angel dem go direct this work. So this vision help us see wetin go happen. Jehovah don send the angel dem to arrange how to kill wicked people and save good people.a

We don explain before sey for this our time, the man wey carry wetin person take dey write na the people wey go follow Jesus rule wey still dey this world. Before, we think sey the people wey don dey serve Jehovah because of our preaching, don get the mark wey go save dem. But this time we don see sey we suppose change how we take sabi this vision. Wetin dey Matthew 25:31-33 show sey na Jesus dey judge people. And e go judge dem when great tribulation come. E go separate people wey be like sheep from people wey be like goat. People wey be like sheep go save; people wey be like goat go die.

From how we take sabi am now, wetin we fit learn from this Ezekiel vision? The things wey we learn reach five:

  1.  Before dem scatter Jerusalem, Ezekiel and Jeremiah warn the people, as Isaiah don do before. For our time, Jehovah dey use Governing Body dey teach im people and warn other people before great tribulation start. Today, all of us dey join hand warn people.—Matt. 24:45-47.

  2.  Like Ezekiel, Jehovah people no dey join mark the people wey go save. Na Jehovah message dem dey preach and angel dey direct their work.—Rev. 14:6.

  3.  As e be for Ezekiel time wey the mark no dey show for front of person head, na so e still be for our time. Wetin people go do so that God go save dem? Dem suppose put ear for Jehovah message, get better character wey Christian suppose get, serve Jehovah and continue to support the people wey go rule with Jesus. (Matt. 25:35-40) Na this kind people go get the mark wey go save dem for great tribulation.

  4.  For our time, the man wey carry wetin person take dey write, na Jesus Christ; e dey mark the people wey go save. E go mark the great crowd as sheep for great tribulation. Na this one go make dem fit get life wey no go end for paradise.—Matt. 25:34, 46.b

  5.  For our time, the six men wey carry wetin dem take dey scatter things na Jesus army for heaven and na Jesus be their Oga. Dem go soon comot all the bad people and the bad things wey dey this world.—Ezek. 9:2, 6, 7; Rev. 19:11-21.

This things wey we don learn, dey make our faith strong sey Jehovah no dey kill good people join bad people. (2 Pet. 2:9; 3:9) E still help us remember why we suppose dey preach now. We suppose warn everybody before this world go end!—Matt. 24:14.

a People like Baruch (wey dey write for Jeremiah), Ebed-melech wey be Ethiopia person and Rechab pikin dem no die even though sey the mark no show for front of their head. (Jer. 35:1-19; 39:15-18; 45:1-5) The mark no be ordinary mark wey person fit see.

b The mark wey people wey go follow Jesus rule go get, different from the great crowd own. Dem go get their own before dem die or before great tribulation start.—Rev. 7:1, 3.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share