Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 January p. 32
  • You Know?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • You Know?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Similar Material
  • Jehovah Test Im Faith
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 January p. 32
Isaac carry wood and Abraham carry one pot wey hot charcoal dey inside

You Know?

How dem take dey carry fire travel for olden days?

ABRAHAM dey prepare to go far place go do sacrifice to Jehovah. Genesis 22:6 tell us wetin e come do. E sey: ‘Abraham carry the wood wey e want use do offering wey dem burn for fire give Isaac im pikin. E come carry the fire and knife for hand, and two of dem come dey waka go together.’

Bible no tell us how people take dey light fire for olden days. Some people study about this Abraham and Isaac story. One of dem talk sey e go hard Abraham and Isaac to carry fire travel from the start of that long journey go reach the end. So, e fit be sey na the thing wey dem dey use light fire the story dey talk about.

Other people talk sey, to light fire for olden days no be small work. E easy for people to collect hot charcoal from their neighbor take make fire, instead of dem to light am by theirself. So, some people wey dey study this kind matter believe sey Abraham carry container wey hot charcoal dey inside. The container fit be clay pot wey get long chain hand and person fit gather hot charcoal from the fire wey dem light the night before the next day. (Isa. 30:14) E no go hard person wey carry hot charcoal dey travel to use the charcoal and dry pieces of wood light another fire.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share