Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 June p. 21
  • Abigail Get Better Sense!

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Abigail Get Better Sense!
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 June p. 21
Abigail

Abigail Get Better Sense!

FOR Bible, David praise one woman wey im name na Abigail. E tell am sey: ‘God go bless you for the better sense wey you get!’ Wetin make David praise am? And wetin we fit learn from Abigail example?

Abigail marry one man wey im name na Nabal. And na when David dey run from King Saul, e know Abigail. Nabal na rich man, and e get plenty sheep. Dem dey take care of im sheep around where mountain dey, for south of Judah. David and im men don dey protect Nabal men and im sheep ‘like wall.’ After, David come send people go beg Nabal make e find something for dem to chop. Dem tell Nabal sey make e give dem ‘anything wey e fit give dem.’ (1 Sam. 25:8, 15, 16) Since David and im men protect Nabal property, Nabal suppose give David wetin e ask for, no be so?

But Nabal no do like that. Instead, e shout give David men and curse dem. E no gree give dem anything. Im name really fit am. The name mean “person wey no get sense” or “mumu.” So David come ready to go punish Nabal for im bad mouth. Nabal and im family go suffer for this mumu thing wey e do.​—1 Sam. 25:2-13, 21, 22.

As Abigail think wetin go happen if David do wetin e get for mind, e come do something. Wetin Abigail do, show sey e get mind. E beg David, with the mind sey David no go want do wetin go vex Jehovah. E come give David and im men plenty things wey dem go chop. David let Abigail know sey na Jehovah use am help am. If no be Abigail, e for don do wetin go make Jehovah vex. David, wey go be the next king, tell am sey: ‘God go bless you for the better sense wey you get! Make e bless you because you make me no kill people today.’​—1 Sam. 25:18, 19, 23-35.

Make we no do like Nabal. Instead, make we dey show sey we like the good things wey people do for us. Like Abigail, when we see wetin fit cause trouble, e good make we do wetin we fit do so that things no go spoil. Make we beg Jehovah sey: ‘Give me better sense and help me know something.’​—Ps. 119:66.

When we do the correct thing, people fit see the sense wey we get. And whether dem tell us or dem no tell us, dem fit get the kind mind wey David get, when e tell Abigail sey: ‘God go bless you for the better sense wey you get!’

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share