Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 December pp. 3-7
  • “I Know Sey E Go Come Back to Life”

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • “I Know Sey E Go Come Back to Life”
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • THINGS WEY HAPPEN WEY GIVE US HOPE!
  • THINGS WEY HAPPEN FOR APOSTLE DEM TIME
  • RESURRECTION GO REALLY HAPPEN!
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 December pp. 3-7
Martha dey talk with Jesus

“I Know Sey E Go Come Back to Life”

“Our friend don go sleep, but I want travel go there, go wake am.”​—JOHN 11:11.

SONG: 142, 129

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • Which story for Bible give Martha mind sey people wey don die go come life again?

  • Wetin make us dey sure sey people wey don die go come life again when time reach?

  • Like Martha, which better thing you dey wait for?

1. Wetin Martha believe sey go happen to im brother? (Check the first picture.)

MARTHA na Jesus tight friend, and na im disciple. But Martha dey cry. Wetin happen? Im brother Lazarus don die. Anything fit make im mind come down? Yes. Jesus promise am sey im “brother go come back to life.” Wetin Jesus talk fit no comot all the things wey dey pain Martha for mind, but Martha still believe wetin Jesus talk. E tell Jesus sey: “I know sey when the last day reach, e go come back to life.” (John 11:20-24) Martha believe sey people wey don die go come life again for front. But na that same day Jesus resurrect Lazarus. This one na miracle!

2. Like Martha, why e good make you believe sey people wey don die go come life again?

2 Today, we no get any reason to expect sey Jesus or im Father go do this kind miracle for us. But like Martha, you believe sey people wey you love, wey don die, go come life again when time reach? E fit be your husband or wife, your mama or papa, grandpapa or grandmamma wey you love well well. E fit still be your pikin. You dey wait for the time wey you go hold dem, talk to dem, and laugh with dem again. Like Martha, you get better reason to talk sey, ‘I know sey my person wey don die go come life again.’ But e good make you think about wetin make you believe sey people wey don die go come life again.

3, 4. Which miracle Jesus do, and how that one fit don make Martha faith strong?

3 Jesus resurrect one widow pikin. E do this miracle near one place wey dem dey call Nain for Galilee. Because Martha dey stay near Jerusalem, e fit be sey e no see am. But, Martha fit don hear about this miracle. E still get one time wey Jesus bring Jairus pikin come life. People wey dey the girl house “know sey the girl don die.” Even with that one, Jesus hold the girl hand and e tell am sey: “My pikin, stand up!” And quick quick, the girl stand up. E fit be sey Martha no still see this one. (Luke 7:11-17; 8:41, 42, 49-55) Martha and im sister, Mary, know sey Jesus go fit heal person wey dey sick. Na im make dem get the mind sey, if Jesus dey around, their brother wey be Jesus friend, for no die. But now wey e don die, wetin go come happen? Remember wetin Martha talk. E sey Lazarus go come life again for front, “when the last day reach.” Wetin make Martha get mind sey Lazarus go come life again? Why you dey sure sey one day people wey don die go come life again? And why you believe sey your people fit dey among dem?

4 We get better reason to believe sey people wey don die fit come life again. Make we talk about some of dem. As we dey talk about dem, you fit see some things for Bible wey talk about resurrection wey you never think about before. This one go make your faith strong sey one day, people wey you love go come back to life.

THINGS WEY HAPPEN WEY GIVE US HOPE!

5. Which other thing make Martha get the mind sey im brother go fit come life again?

5 Martha no talk sey: ‘My brother fit come life again.’ Instead, e talk sey: “I know sey my brother go come life again.” Wetin make Martha get this kind mind? E don learn about people wey God resurrect before Jesus time. E fit don learn am for house and for synagogue, when e still dey young. Make we talk about three example of people for Bible wey come back to life.

6. Which miracle Martha go don learn about?

6 The first example of person wey dem bring come back to life na for prophet Elijah time. This one happen when God give am power to do miracle. E get one poor widow wey dey stay Zarephath, one town wey dey the north side of Israel. The woman really take care of prophet Elijah. Because of this one, Jehovah make sure sey the widow flour and oil no finish, so that im and im pikin no go die. (1 Ki. 17:8-16) Later, the woman pikin come dey sick and e die. Elijah come go help am. Elijah touch the boy, and e pray make God bring the boy come life again. God answer Elijah prayer, and the boy come back to life. This na the first example of person wey Bible talk about wey dem bring come life. (Read 1 Kings 17:17-24.) Martha go don learn about this story.

7, 8. (a) How Elisha take help one woman wey im pikin die? (b) The miracle wey Elisha do, wetin e teach us about Jehovah?

7 The second example of person wey Bible talk about wey dem bring come life na for prophet Elisha time. E get one woman wey dem know well well for Shunem. The woman no get pikin. E really take care of Elisha well well. So because of this one, God bless im and im husband with pikin. After some years, the pikin come die. E pain the woman for body sotey e travel 19 miles (30 km) go meet Elisha for one mountain wey dem dey call Mount Carmel. Prophet Elisha come send im servant, wey im name na Gehazi, make e go resurrect the pikin. But when Gehazi reach there, e no fit bring the pikin come life. Later, Elisha come follow the woman go Shunem.​—2 Ki. 4:8-31.

8 When Elisha reach where the pikin dey, e come pray to Jehovah. And Jehovah answer im prayer. The pikin wey don die come get up. When the mama see im pikin, e happy no be small! (Read 2 Kings 4:32-37.) The woman fit don remember wetin Hannah talk for prayer. Hannah no fit born pikin. But Jehovah bless am with pikin wey im name na Samuel. When Hannah carry Samuel go tabernacle, e talk for prayer sey: “Jehovah . . . dey send person enter Grave, and e dey raise person up.” (1 Sam. 2:6) As God take raise the boy wey don die come life, this one help us know sey, true true, God get power to bring people wey don die come life again.

9. Talk how the third resurrection for Bible take happen.

9 Another miracle happen after Elisha die. Wetin happen fit surprise you. E don pass 50 years wey Elisha dey do prophet work. E come dey sick, and e later die. As time dey go, Elisha body rotten, na only im bone come remain. One day, some Israel people carry one man go bury. As dem dey go, dem come see some enemy for road. So that dem go quick run from their enemy, dem trowey the man for Elisha grave. Bible talk sey: “When the man body touch Elisha bone, the man come back to life and e stand up.” (2 Ki. 13:14, 20, 21) All this things wey happen show Martha sey God get power pass death. This one suppose make you believe sey God get power well well, and e no get anything wey e no fit do.

THINGS WEY HAPPEN FOR APOSTLE DEM TIME

10. How Peter take help one woman wey die?

10 For the part of Bible wey be Greek Scriptures, e get other example of people wey God resurrect. And na God servants do the miracle. For paragraph three, we talk about the one wey Jesus do near Nain and for Jairus house. Apostle Peter still do another one, and na one woman wey im name na Dorcas (Tabitha) e bring come life. Peter come where dem put the woman body, e come pray to Jehovah. And then e talk sey: “Tabitha, get up!” As e talk am finish, the woman come get up. Peter come “show dem the woman wey don come back to life.” Wetin happen “come make many people believe the Lord.” This people fit tell other people the good news about Jesus, and about the power wey Jehovah get to resurrect people wey don die.​—Acts 9:36-42.

11. Wetin Luke talk sey e happen to Eutychus, and how that one take affect other people?

11 Other people take their eye see another person wey dem bring come life again. E get one meeting wey dem do for one upstair wey dey where dem dey call Troas. Today, Troas na northwest of the country wey dem dey call Turkey. Apostle Paul dey the meeting, and e preach reach midnight. One young man, wey im name na Eutychus, dey listen as Paul dey preach. E sitdown for window. But sleep carry am. So e fall from the third story of the upstair. E be like sey na Luke first reach where Eutychus fall put. And since Luke na doctor, e fit don check am come see sey e no injure or faint, instead e don die. When Paul reach where the boy dey, e come hold am. And e tell everybody sey the boy don come back to life. This miracle touch many people wey see am. Dem know sey the boy die, and Paul bring am come life again. This one really make everybody mind come down.​—Acts 20:7-12

RESURRECTION GO REALLY HAPPEN!

12, 13. From the story about people wey dem resurrect, which question we go talk about?

12 All this story about people wey die and wey dem resurrect, suppose make you get the kind mind wey Martha get. Make we get the mind sey Jehovah, the God wey dey give life, go fit bring people wey don die come life again. E good to know sey God servant, like Elijah, Jesus, or Peter dey there when Jehovah do all this miracle. What about people wey die the time wey God no dey give people power to do miracle? Jehovah servant fit still get hope sey God go resurrect this people for front? Dem fit get the kind mind wey Martha get, when e talk sey: “I know sey when the last day reach, [my brother] go come back to life”? Wetin make Martha believe sey God go resurrect people? And wetin fit make you believe?

13 Some place for Bible show sey God servant know sey people wey don die go come life again when the time reach. Make we talk about some of dem.

14. Wetin we fit learn from Abraham story?

14 Think about wetin God tell Abraham make e do im pikin Isaac. Jehovah tell am sey: “Abeg, carry your only pikin Isaac wey you love well well. Go use am do sacrifice.” (Gen. 22:2) How you think sey e go do Abraham for body when God tell am this thing? Jehovah don promise Abraham before sey na through im pikin e go bless the whole earth. (Gen. 13:14-16; 18:18; Rom. 4:17, 18) Jehovah come still tell Abraham sey the pikin “go come from Isaac.” (Gen. 21:12) But how that one go take happen if dem use Isaac do sacrifice? Bible tell us wetin Abraham believe—e believe sey God go bring Isaac come life again. (Read Hebrews 11:17-19.) Abraham think sey, if im obey God, maybe after some hours, one day, or one week, God go just resurrect Isaac? No place for Bible talk so. Abraham no know when im pikin go come life. But e trust Jehovah sey e go bring Isaac come life.

15. Which hope Job get?

15 Job na another person wey still know sey people wey don die go come life again when time reach. E know sey, if dem cut tree, e fit still grow again and be like new tree. But no be so e be with human being. (Job 14:7-12; 19:25-27) If human being die, e no fit stand up from grave by imself. (2 Sam. 12:23; Ps. 89:48) But, that one no mean sey God no fit bring person wey don die come life. The truth be sey, Job believe sey Jehovah go remember am when the time reach. (Read Job 14:13-15.) But Job no know when that time go be. Even with that one, e trust Jehovah. E know sey na Jehovah make us and na im give us life. This one come make am get the mind sey Jehovah go remember am when e die, and e go bring am come life.

16. Wetin Jehovah angel tell Daniel?

16 Daniel na another person wey we know well well for the part for Bible wey be Hebrew Scriptures. E use all im life serve Jehovah, and Jehovah help am. E get one time wey God angel tell Daniel sey: “You wey be special person, make you get peace, and make you dey strong.”​—Dan. 9:22, 23; 10:11, 18, 19.

17, 18. Wetin dem promise Daniel?

17 Daniel don almost reach 100 years and e go soon die. E fit dey think about how im tomorrow go be. Daniel go come life again? The answer na yes. How we take know? For the ending of the book of Daniel, we read wetin God promise am. E sey: “As for you, continue go reach the end, and you go rest.” (Dan. 12:13) Daniel know sey people wey don die dey rest. Dem no fit plan, dem no fit learn and dem no fit think for Grave. And Daniel go soon go there. (Eccl. 9:10) But that one no mean sey im own don finish. God promise am better thing for front.

18 Jehovah angel still tell Daniel sey: “But for the last day, you go stand up and you go get wetin dem keep for you.” Daniel no know when this one go happen. Daniel know sey e go die and e go rest. But when the angel talk sey Daniel ‘go stand up and get wetin dem keep for am,’ e mean sey when time reach, Jehovah go resurrect am. E go tey, after e don die, before this one go happen. This one go happen “for the last day.” For Jerusalem Bible, this verse talk sey: “You go get up collect your portion when the end of time reach.”

One woman dey read about resurrection and e come dey think about how im pikin go take resurrect

Like Martha, make you get the mind sey people wey don die go come life again (Check paragraph 19, 20)

19, 20. (a) How the different different story about resurrection take help Martha? (b) Wetin we go talk about for the next topic?

19 All this example wey we talk about, give Martha better reason to believe sey “when the last day reach,” im brother Lazarus “go come back to life again.” The things wey Jehovah promise Daniel, and the strong faith wey Martha get, suppose make us believe sey, people wey don die go come life again.

20 All this resurrection wey Bible talk about na things wey really happen. And dem teach us sey true true, God go bring people wey don die come life. And we get the mind sey e go really happen. We don still learn about people for Bible wey dey wait for the time when dead people go come life again. If God promise sey e go resurrect person, and many many years don pass wey e talk am, e fit still happen? If na so, that one go make us get more reason like Martha, to put mind for the time wey dead people go come life again. But, when e go take happen? We go talk about this matter for the next topic.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share