Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w18 January p. 32
  • You Know?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • You Know?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
w18 January p. 32

You Know?

For Israel time, na true sey people dey really use Moses Law settle matter everytime?

SOMETIMES, dem dey use am. For example, Deuteronomy 24:​14, 15 talk sey: ‘If poor person come work for you, make you no play am wayo, whether na your brother or na stranger wey dey una land. If you no pay am, e go cry to Jehovah because of you, and wetin you do go be sin.’

Pieces of clay pot

The pieces of clay pot wey dem write wetin the farmworker talk

Something like this happen to one farmworker wey dem sey e no bring the complete amount of wetin e suppose harvest. E get pieces of clay pot wey dem see near Ashdod. Wetin dem write put na about this farmworker wey dey beg one governor. Maybe na person help am write am. When dem check the time wey dem write am, dem find out sey na before 600 B.C.E. Wetin dem write for the clay pot na: “E never too tey wey your servant [wey be the person wey dey beg for help] keep wetin e harvest. But after, Hoshayahu wey be Shobay son come collect your servant cloth. . . . All the people wey dey follow me harvest under sun, fit talk wetin happen . . . sey I no dey lie. I no do wetin dem sey I do. . . . Even if the governor no see am as wetin e suppose do to help im servant get im cloth back, make e pity for am help am! E no good if you no do anything as your servant no dey with im cloth.”

Simon Schama wey sabi this kind matter talk sey wetin dem write for this clay pot no be just about person wey want collect im cloth back. E still show sey the farmworker know wetin God Law talk for Leviticus and Deuteronomy. The Law sey make dem no treat poor people anyhow.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share