Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 5 p. 18-p. 19 par. 5
  • Noah Ark

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Noah Ark
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Other Materials Like This One
  • When the Heavy Rain Fall, Who Obey and Who No Obey?
    Obey God and You Go Live Forever
  • Na Only Eight People No Die
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 5 p. 18-p. 19 par. 5
Noah and im family dey build ark

LESSON 5

Noah Ark

As time dey go, people come many for the earth. But many of dem dey do bad things. Even self, some angel for heaven come dey do bad things. Dem comot from heaven come this earth. You know wetin make dem come? Dem come this earth so that dem go fit change their body to human being own and marry wife.

Dem come born pikin. The pikin wey dem born get power well well like giant and dem come dey cause wahala for other people. Jehovah no fit let all this bad things continue to dey happen. So, e sey e go use heavy rain destroy dem.

Noah and im family dey build ark and some dey cook food

But e get one man wey no dey do like dem. The man love Jehovah. Im name na Noah. E get one wife and three pikin, the three pikin name na Shem, Ham, and Japheth and dem don marry. Jehovah tell Noah sey make e build big ark so that im and im family no go die when e go use heavy rain destroy bad bad people. Ark be like big boat wey dey float for water. Jehovah still tell Noah sey make e carry different different animal enter the ark make dem for no die.

Noah no waste time at all, e start to dey work. Noah and im family use like 50 years take build the ark finish. Dem build am the way Jehovah tell dem. That time, Noah still warn people about the heavy rain. But nobody listen to am.

As e come be, e don reach time wey dem go enter the ark. Make we see wetin come happen.

‘As e be for Noah time, na so e go be when Son of man dey around.’—Matthew 24:37

Question: Why Jehovah use heavy rain destroy people? Wetin Jehovah sey make Noah do?

Genesis 6:​1-22; Matthew 24:​37-41; 2 Peter 2:5; Jude 6

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2025)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share