Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • lfb lesson 92 p. 214-p. 215 par. 1
  • Jesus Appear to People Wey Dey Catch Fish

Video no dey for wetin you select.

Sorry, the video no go fit play.

  • Jesus Appear to People Wey Dey Catch Fish
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 92 p. 214-p. 215 par. 1
Fish dey fire as Jesus dey talk to im disciples

LESSON 92

Jesus Appear to People Wey Dey Catch Fish

After some time when Jesus appear to im apostles, Peter come go the big river wey dey Galilee go catch fish as e dey do before. Thomas, James, John, and some other disciples follow am. Dem put their net for the river the whole night, but dem no see any fish catch.

When day break, dem see one man stand for dry land wey near the river. The man ask dem from where e stand sey: ‘Una catch any fish?’ Dem tell am sey: ‘We no see catch o!’ The man come tell dem sey: ‘Make una put una net for the right side of una boat.’ As dem put am, fish come full the net sotey dem no fit drag am enter their boat. Na that time John come know sey na Jesus, e come talk sey: ‘Na our Lord o!’ Na once Peter jump enter water, come dey swim go where Jesus dey. The other disciples use boat follow am.

When dem reach dry land, dem see sey bread and fish dey fire. Jesus come tell dem sey make dem put some of the fish wey dem catch, join the one wey dey fire. As e done, Jesus sey: ‘Make una come chop.’

Peter dey go meet Jesus for dry land and the other disciples use boat follow am

As dem chop finish, Jesus ask Peter sey: ‘You love me pass to dey catch fish?’ Peter answer am sey: ‘Yes, my Lord, you know sey I love you.’ Jesus come sey: ‘Give my lamb food chop.’ Jesus ask am again sey: ‘Peter, you love me?’ Peter answer again sey: ‘My Lord, you know sey I love you.’ Jesus come tell am sey: ‘Take care of my small sheep.’ Jesus ask Peter that question again. Peter come weak. E tell Jesus sey: ‘My Lord, you know everything. You know sey I love you.’ Jesus come tell am sey: ‘Give my small sheep food chop.’ Jesus come still tell Peter sey: ‘Continue to dey follow me.’

‘Jesus come tell dem sey: “Make una follow me, and I go teach una how to catch people.” Quick quick, dem leave their net and start to dey follow am’ ​​—Matthew 4:​19, 20

Question: Which miracle Jesus do for people wey dey catch fish? Why you think sey Jesus ask Peter three times sey: ‘You love me?’

John 21:​1-​19, 25; Acts 1:​1-3

    Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2025)
    Log Out
    Log In
    • Pidgin (West Africa)
    • Share
    • How You Want-Am
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
    • How We De Handle Information for This Website
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share