Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • One Slave Wey Obey God
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
    • Joseph dey run from Potiphar wife

      LESSON 14

      One Slave Wey Obey God

      Na Joseph be Jacob second to last boy. But im senior brothers see am sey na im their papa like pass. You think sey this one make dem happy? For where! Dem jealous am, come even hate am. When Joseph dream one kind dream, e tell im brothers. The dream mean sey dem go bow down for am. This one come make dem hate am well well.

      Joseph brothers throwey am for inside one deep hole

      One day wey Joseph brothers dey take care of sheep near Shechem, Jacob send Joseph go see how the work dey go. When im brothers see am dey come from far far, dem come dey tell theirself sey: ‘See this one wey dey dream anyhow. Make we kill am!’ Dem drag am, come throwey am inside one deep hole. But Judah wey be one of im brother sey: ‘Make we no kill am! Make we sell am as slave.’ Dem come sell am for 20 silver money to Midian people wey dey go do business for Egypt.

      Joseph brothers come soak im coat for inside goat blood give their papa. Dem come ask am sey: ‘No be your pikin coat be this?’ This one come make Jacob dey think sey na animal kill Joseph. E pain Jacob well well no be small. Nobody fit make e mind come down.

      Joseph dey prison

      Dem sell Joseph as slave to one big man wey im name na Potiphar wey dey stay Egypt. But Jehovah no leave Joseph. Potiphar see am sey Joseph dey do im work well and na person wey dem fit trust. Before you know, e put Joseph to dey control everything wey e get.

      Potiphar wife see sey Joseph fine well well and e dey strong. Na everyday e dey beg Joseph make e sleep with am. Wetin Joseph go come do? E no gree sleep with am, e talk sey: ‘No! E no make sense. My oga trust me, and you be im wife. I no go sleep with you because God hate am!’

      One day Potiphar wife try to force Joseph sleep with am. E hold Joseph cloth, but Joseph run comot. When Potiphar come house, e wife tell am sey Joseph want rape am. But na lie be that. Potiphar come dey vex well well sotey e throwey Joseph for prison. But Jehovah no still forget Joseph.

      ‘Carry yourself come down because you dey God strong hand, so that e go raise una go up when time reach.’—1 Peter 5:6

      Question: How Joseph brothers treat am? Wetin make Joseph go prison?

      Genesis 37:​1-​36; 39:​1-23; Acts 7:9

  • Jehovah No Ever Forget Joseph
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
    • Joseph dey tell Pharaoh wetin e dream mean

      LESSON 15

      Jehovah No Ever Forget Joseph

      When Joseph dey prison, Pharaoh wey be Egypt king get dream wey nobody fit explain. One of im servant come tell am sey Joseph fit tell am wetin the dream mean. Pharaoh come sey make dem carry Joseph come.

      Pharaoh ask am sey: ‘You fit tell me wetin my dream mean?’ Joseph answer am sey: ‘For the first seven years, food go plenty well well for Egypt, but after that seven years finish, food no go dey for seven years.’ Choose person wey get sense wey go gather food so that hungry no go finish your people.’ Pharaoh come tell am sey: ‘I choose you! Na you go be number two person wey get power pass for Egypt!’ You know who help Joseph know wetin Pharoah dream mean? Na Jehovah help am.

      Joseph dey direct people to gather food

      Joseph gather food for the first seven years. After that seven years, food no come dey anywhere for the earth as Joseph talk. People dey come from different different place come buy food for Joseph hand. When im papa Jacob hear sey food dey Egypt, e send ten of im pikin go buy.

      When Joseph brothers come meet am, e know sey na dem. But dem no know sey na im. Dem come bow down for am, as e dream when e dey young. Because Joseph want see whether dem still get bad mind, e tell dem sey: ‘Una come look our land. Una want come see where we for weak.’ Dem come sey: ‘No o! We be 12 brothers wey dey stay Canaan. But one of our brother don die and our last born dey with our papa for house.’ Joseph come tell dem sey: ‘Make una carry una last born come before I go believe una.’ Dem come go house go meet their papa.

      When their food finish, Jacob come send dem go Egypt again. Dem carry Benjamin wey be their last born as dem dey go. As dem reach there, Joseph test dem. E hide im silver cup for Benjamin bag wey e take carry food and tell im brothers sey na dem thief am. When Joseph servant see the cup for Benjamin bag, im brothers surprise. Dem come dey beg Joseph make e punish dem instead of Benjamin.

      Na now Joseph come see am sey im brothers don change. E come start to dey cry sey: ‘I be una brother. My papa still dey alive?’ Im brothers come surprise. E come tell dem sey: ‘Make una no reason wetin una do me. God send me come here to save una. Make una go carry my papa come quick quick.’

      Dem come go house go tell their papa the good news, and dem carry am go Egypt. After many many years, Joseph and im papa come dey together again.

      Joseph and im papa, Jacob, dey greet theirself

      ‘If una no gree forgive people the bad things wey dem do una, una Father no go still forgive una the bad things wey una do.’—Matthew 6:15

      Question: How Jehovah take help Joseph? How Joseph take show sey e don forgive im brothers?

      Genesis 40:1–​45:28; 46:​1-7, 26-​34; Psalm 105:​17-​19; Acts 7:​9-​15

Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
Log Out
Log In
  • Pidgin (West Africa)
  • Share
  • How You Want-Am
  • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
  • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
  • How We De Handle Information for This Website
  • Privacy Settings
  • JW.ORG
  • Log In
Share