Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Pidgin (West Africa)
  • BIBLE
  • PUBLICATIONS
  • MEETINGS
  • The Bush Wey Fire Dey
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
    • Moses dey the bush wey fire dey

      LESSON 18

      The Bush Wey Fire Dey

      Moses stay Midian for 40 years. E marry and e get pikin. One day, as e dey take care of sheep near the mountain wey dey Sinai, e see something wey e never see for im life before. E see bush wey fire dey, but the bush no dey burn. As Moses dey near am to see why, e hear one voice from the bush sey: ‘Moses! No near this place. Pull your sandals because na holy place you dey stand so!’ Na Jehovah use angel talk to am.

      Fear catch Moses, na im e cover im face. The voice sey: ‘I don see as Israel people dey suffer. I go save dem from Egypt people hand come put dem for better land. Na you go carry dem comot from Egypt.’ You no think sey that one go surprise Moses?

      Moses sey: ‘Wetin I go talk if dem ask me sey, who send me?’ God come tell am sey: ‘Tell dem sey na Jehovah, the God wey Abraham, Isaac, and Jacob serve na im send you.’ Moses come sey: ‘What if the people no listen to me?’ Jehovah come show Moses sey e go help am. E tell am sey make e throwey im stick for ground. Na im the stick turn to snake! As Moses hold the snake tail e turn to stick back. Jehovah come tell am sey: ‘If you do this miracle, e go show sey na me send you.’

      Moses come sey: ‘I know sabi talk well.’ But Jehovah promise am sey: ‘I go tell you wetin you go talk, and I go send your brother Aaron make e help you.’ When Moses see am sey Jehovah dey with am, e carry im wife and pikin and start to dey go Egypt.

      ‘Make una no worry about wetin una go talk or how una go talk am. God go give una wetin una go talk that time.’—Matthew 10:19

      Question: Wetin Moses see as e dey take care of im sheep? Wetin Jehovah want make Moses do?

      Exodus 3:1–​4:​20; Acts 7:​30-​36

  • The First Three Things Wey God Take Punish Egypt
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
    • Moses and Aaron stand for Pharaoh front

      LESSON 19

      The First Three Things Wey God Take Punish Egypt

      Egypt people force Israel people work as slave. Jehovah tell Moses and Aaron sey make dem tell Pharaoh sey: ‘Let my people go make dem go worship me for desert.’ Pharaoh say e no care about wetin Jehovah talk, e sey: ‘Israel people no dey go anywhere.’ Pharaoh come force dem to dey work pass before. Jehovah go show Pharaoh pepper! You know how e take do am? E punish Egypt people ten times. Jehovah tell Moses sey: ‘Pharaoh no dey listen to me. Tomorrow morning, e go dey river Nile. Go meet am and tell am sey as e get stronghead so, all the water for river Nile go turn to blood.’ Moses obey, so e go meet Pharaoh. Pharaoh dey look Aaron as e nack the Nile river with im stick, na im the water turn to blood. The river come dey smell, fish come dey die for inside, and people no come see better water drink for there again. But Pharaoh no still let dem go.

      After seven days, Jehovah tell Moses make e go meet Pharaoh again and tell am sey: ‘If you no let my people go, frog go full Egypt.’ But Pharaoh no still let dem go. Na im Aaron raise im stick and frog start to full everywhere. Dem see frog for their house, their bed and their plate. Frog full everywhere! Pharaoh come sey make Moses beg Jehovah make e stop am. E promise sey e go let Israel people go. So Jehovah stop am, na im Egypt people start to dey gather all the frog wey don die. Everywhere come dey smell. But Pharaoh no still let dem go.

      Jehovah come tell Moses sey: ‘Make Aaron nack ground with im stick and dust go turn to small small fly wey dey bite.’ Na once, fly wey dey bite full everywhere. Some of Pharaoh people come dey tell am sey: ‘Na God dey punish us so.’ But Pharaoh no still let dem go.

      Three things wey God take punish Egypt from the ten things na: blood full river Nile , frog, and fly wey dey bite

      ‘I go make dem know my power and my force, and dem go know sey my name na Jehovah.’—Jeremiah 16:21

      Question: Wetin be the first three things wey God take punish Egypt? Why Jehovah use am punish dem?

      Exodus 5:​1-​18; 7:8–​8:​19; Nehemiah 9:​9, 10

Publication for Pidgin (West Africa) (2017-2026)
Log Out
Log In
  • Pidgin (West Africa)
  • Share
  • How You Want-Am
  • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
  • Wetin You Go Do and Wetin You No Go Do If You Want Use This Website
  • How We De Handle Information for This Website
  • Privacy Settings
  • JW.ORG
  • Log In
Share