-
Rahab Hide People Wey Come Look the LandLesson Wey You Fit Learn From Bible
-
-
LESSON 30
Rahab Hide People Wey Come Look the Land
When Israel people wey go look Jericho reach there, dem stay one woman house. The woman name na Rahab. When the king for Jericho know sey dem come look how the land be, e send soldier go Rahab house. Rahab hide the two people wey come look the land for top of im roof, e come tell the soldier sey dem go another side. E tell the people wey come look the land sey: ‘I go help una because I know sey Jehovah dey una side and because una go win this land. Abeg make una promise me sey una go save me and my family.’
Dem tell Rahab sey: ‘We dey promise you sey nobody for inside your house go die.’ Dem still tell am sey: ‘Tie red rope for your window and nothing go happen to you and your family.’
Rahab come give dem rope wey dem go use come down from im window. Dem come run go the mountain, go hide for three days before dem go meet Joshua. As Israel people cross river Jordan finish, dem arrange how dem go take collect the land. The first land wey dem collect na Jericho. Jehovah sey make dem march round Jericho for six days and na once dem go march round everyday. But for the day wey make am seven, dem go march seven times. As dem dey march, all the priest dey blow trumpet and soldier dey shout as dem fit shout reach. Jericho fence come dey scatter. But Rahab house wey dey the fence no scatter. Rahab and im family no die because Rahab put mind for Jehovah.
‘Na so e still be, dem no sey Rahab na righteous person because of wetin e do when e let stranger enter im house and show dem another place wey dem go pass?’—James 2:25
-
-
Joshua and Gibeon PeopleLesson Wey You Fit Learn From Bible
-
-
LESSON 31
Joshua and Gibeon People
Other city hear sey Israel people don scatter Jericho. Their king come plan together to fight Israel people. But Gibeon people no join dem, dem get another plan. Dem wear tear tear cloth go meet Joshua and tell am sey: ‘The land wey we come from far well well. We don hear many things about Jehovah and everything wey e do for una for Egypt and Moab. If una promise us sey una no go come fight us, we go be una slave.’
Joshua believe dem and e tell dem sey e no go come fight dem. After three days, e come see sey where dem dey stay no far. Dem come from Canaan. Joshua come ask dem sey: ‘Wetin make una lie for us?’ Dem answer am sey: ‘Na fear catch us. We know sey Jehovah dey fight for una. Abeg make una no kill us.’ True true, Joshua no kill dem as e promise.
E no too tey, five king wey come from Canaan come dey threaten Gibeon people. As Joshua hear am, im and im soldier march round the city the whole night to protect dem. The fight start for early morning. Na so Canaan people start to dey run anyhow. But anywhere dem run go, Jehovah send ice block wey dey fall like rain for their head. Joshua come tell Jehovah sey make the sun no comot. Why Joshua go tell Jehovah sey make sun no comot when that kind thing never happen before? Na because e believe sey Jehovah go fit do am. True true, the sun no comot for the whole day until Israel people finish Canaan and their soldier.
‘If you sey “Yes” make e be yes, and if you sey “No” make e be no, anything wey pass this one na from the wicked person.’—Matthew 5:37
-