Wetin God Want?
God want make we enjoy life for paradise!
You think sey this one go happen? Bible talk sey na God Kingdom go fit do am. God want make we sabi wetin that Kingdom go do for us.—Psalm 37:11, 29; Isaiah 9:7.
God want make we live better life.
Just like papa wey good well well go do better for im pikin, God want make we enjoy better life and get life wey no go end. (Isaiah 48:17, 18) God don promise sey ‘any person wey do wetin e want go get life wey no go end.’—1 John 2:17.
God want make we follow wetin e dey tell us.
Bible talk sey, God dey ‘teach us im way’ make we fit ‘do wetin e want.’ (Isaiah 2:2, 3) God don gather some ‘people wey dey answer im name’ make dem help other people dem sabi wetin e want for this world.—Acts 15:14.
God want make we worship am.
God want make we worship am. This kind worship no dey scatter people, but e dey bring dem together. (John 13:35) Who dey teach people everywhere how we go fit worship God together today? Make you read this book.