LESSON 2
Why Dem Dey Call Us Jehovah Witness People?
Noah
Abraham and Sarah
Moses
Jesus Christ
Many people think sey Jehovah Witness na one new church wey just start. But the truth be sey, e don pass 2,700 years wey God call people wey dey worship am ‘im witness.’ (Isaiah 43:10-12) Before 1931, na ‘Bible Students’ be our name. Wetin make us come dey answer Jehovah Witness now?
The name dey show people who our God be. The time wey dem write Bible, e pass 7,000 place wey that name Jehovah, show for inside Bible. For many many Bible wey dey today, people don comot that name and dem come change am to Lord or God. The truth be sey, e don tey wey God tell Moses sey im name na Jehovah, when e sey: ‘Na my name be this forever.’ (Exodus 3:15) That name Jehovah make am dey different from other fake fake god. We happy well well sey we be Jehovah Witness people.
The name dey show the work wey we dey do. Na from Abel time, many many good people don dey show sey dem believe God. No be only Abel o, people like Noah, Abraham, Sarah, Moses, and David follow join ‘plenty plenty other people dem wey talk about God.’ (Hebrews 11:4–12:1) Just like when person enter court to talk wetin im sabi about person wey no do bad, na so Jehovah Witness people dey ready to tell people about God.
The name dey show sey we dey follow Jesus. Bible call Jesus ‘faithful and true witness.’ (Revelation 3:14) Even Jesus talk am sey, im ‘tell other people God name’ and help dem ‘sabi wetin dey inside Bible.’ (John 17:26; 18:37) People wey dey really follow Jesus suppose to dey answer God name and tell people about am. Na wetin Jehovah Witness people dey do be that.
Wetin make us dey answer Jehovah Witness?
Na which time Jehovah Witness people take start for this world?
Who be the number one Jehovah Witness?