LESSON 3
How We Come Take Get the Truth Wey Dey Inside Bible Again?
Bible Students for 1870
This one na The Watchtower wey dem print for 1879, na im be the first one
The Watchtower as e be today
Bible don talk am sey after Jesus comot for this world, some of the people wey dey follow am no go follow im example. Dem go dey teach many many things wey no dey inside Bible. (Acts 20:29, 30) As Bible talk am, na so e take happen. Dem carry wetin people wey no sabi God dey teach come mix am with wetin Jesus teach. Na so people wey dey teach wetin no dey Bible but wey dey claim sey dem dey serve God take start. (2 Timothy 4:3, 4) Wetin make us believe sey the things wey we dey learn for inside Bible today na true?
Time come reach when Jehovah see sey people go sabi wetin really dey inside Bible. Jehovah talk am sey for this time of the end, im people go come sabi wetin Bible talk well well. (Daniel 12:4) For 1870, some people see sey many many things wey dem dey teach for church no dey inside Bible. Na so this small group come start to dey find the true things wey really dey inside Bible. And Jehovah bless dem well well as dem come sabi wetin Bible really teach.
Some people put their mind down sofri sofri learn Bible. As the small group wey be Bible Student dem take dey learn Bible that time, na so we still dey do today. Dem dey learn different different things wey Bible teach one by one. When dem see some place wey hard to learn, dem go find other place for Bible wey go help dem sabi am well. When dem see am sey wetin dem learn gree with other place for Bible, dem go write am down. This one come help dem sabi many many things wey dey inside Bible like God name, God Kingdom, wetin God want do for people, wetin dey happen when person die, and how people wey don die go take come back to life. All this one come free dem from plenty plenty lie lie wey people dey teach.—John 8:31, 32.
For 1879, this small group come see am sey time don come make everybody sabi wetin Bible dey really teach. Na that year dem come start to dey print the book wey we dey call, The Watchtower Announcing Jehovah’s Kingdom. We still dey print am reach today. Jehovah Witness people dey preach for different different language wey pass 750 and for 240 different different place. Today, people dey learn wetin Bible really teach everywhere for this world!
Wetin happen to the truth wey dey inside Bible after Jesus die?
How we come take get the truth wey dey inside Bible again?