LESSON 5
Wetin You Go Enjoy When You Come Our Meeting?
Argentina
Sierra Leone
Belgium
Malaysia
Plenty people no dey go church again because dem no fit get better answer for many many question wey dey worry dem for mind. Why e good make you follow Jehovah Witness people go their Kingdom Hall? Wetin you go see when you come?
Belle go sweet you well well sey you dey serve God with people wey love you. Christian for the apostle time dey gather to worship God for small small group wey dem dey call congregation. For this meeting, dem dey learn Bible and help theirself. (Hebrews 10:24, 25) When dem gather, belle dey sweet dem well well because dem sabi sey dem dey with people wey love dem and love God well well. (2 Thessalonians 1:3; 3 John 14) As we dey follow their example today, e dey make us happy.
You go learn how you fit take do wetin Bible talk. For Moses time, na papa, mama and their pikin dey gather for one place worship God. Today too, overseer for our different different congregation dey help us sabi how we go dey do wetin we dey learn for Bible. (Deuteronomy 31:12; Nehemiah 8:8) Everybody dey free to sing and dem dey free to answer question to show wetin dem believe.—Hebrews 10:23.
Your faith go strong well well. Apostle Paul tell one congregation wey dey for im time sey: ‘I really want see una, make we fit help ourself so that our faith go strong well well.’ (Romans 1:11, 12) As we dey go meeting together with our brother and sister dem, our faith for God dey strong well well, and e dey help us to do wetin we dey learn.
We want make you come follow us enjoy this meeting. We go happy well well if you fit come. Everything wey we dey do for there na free—you no go pay anything.
Which example we dey follow for our meeting today?
Wetin we go enjoy if we dey go meeting everytime?