LESSON 6
Wetin We Dey Enjoy As We Dey Serve God Together With Our Brother and Sister Dem?
Madagascar
Norway
Lebanon
Italy
The truth be sey, we no dey take our Christian meeting play. Even if na to trek for inside rain or for hot sun or pass inside thick bush, we go still go worship our God. Even as life no dey easy with everybody, na so e be for Jehovah Witness people, but why we still dey try go meeting?
E dey help us manage our problem. Apostle Paul talk sey make we ‘dey think about other people.’ (Hebrews 10:24) So wetin Apostle Paul mean be sey e good make we sabi our brother and sister dem well well and the kind problem wey dey worry dem. When we sabi the kind problem wey dey worry our brother and sister dem and how dem take dey solve am, this one go teach us how we go take solve our own.
E go help us make better friend. When we gather for our meeting, we dey see sey our brother and sister dem na our better friend. We still dey meet for another time to play and enjoy life together. How this one take dey make our life better? E dey make us respect and love ourself well well. And because we love dem well well even when dem get problem, e go dey easy for us to help dem. (Proverbs 17:17) As we dey serve God together for our different different congregation, this one go show sey we ‘get love for ourself well well.’—1 Corinthians 12:25, 26.
Make you choose your friend from people wey dey do wetin God want. If you dey follow Jehovah Witness people, you go see this kind friend. Abeg make you no allow anything stop you to serve God with us.
Why e good make we dey worship God together for our meeting?
Which time you go like come our meeting?