LESSON 14
Which School Dey for Pioneers?
United States
Gilead School, Patterson, New York
Panama
E don tey wey Jehovah Witness people don get different different school wey dey teach Bible. Some school dey wey dey help pioneer dem ‘sabi how to preach well well.’—2 Timothy 4:5.
Pioneer School. Pioneer dey go this school after dem don preach for one year. Na six days dem take dey do this school for any Kingdom Hall wey near their house. This school dey help pioneer near God well well and e dey help dem sabi how to preach. And wetin dem dey learn from the school no dey make dem tire to serve God.
School for Kingdom Evangelizers. This school dey help pioneer wey ready well well to go any place wey people wey dey preach never plenty. This school na for two months. People wey go this school be like Isaiah wey sey, ‘I dey here! Send me!’ This one show sey dem dey follow Jesus wey be the first person wey preach for this earth. (Isaiah 6:8; John 7:29) As dem dey comot for their town, na simple life dem dey live. Dem fit even carry dem go some place wey the weather cold or wey hot well well. Some place get different different food wey dem no dey chop. Dem even dey learn different different language wey go help dem fit preach. People wey don marry and people wey never marry fit go. But na only people wey dey 23 years go reach 65 years fit go this school. This school dey help dem sabi things for Bible wey go make dem ready to preach for everywhere wey Jehovah want use dem.
Watchtower Bible School of Gilead. For Hebrew language, the name ‘Gilead’ mean ‘Plenty Witness.’ And since 1943 wey this school don start, e don pass 8,000 people wey don learn for this school. When dem finish the school, dem dey send dem ‘go different different country’ as Missionary. This people dey do this work well. (Acts 13:47) We no get any congregation for Peru when Missionary first reach that country. But today, Peru don get pass 1,000 congregations. Before Missionary enter Japan, Jehovah Witness people for that country no reach 10. Today, e don pass 200,000 people wey dey preach for that country. This school na for 5 month and na Bible dem dey learn for there. The people wey fit go this school na special pioneer, circuit overseer, missionary and people wey dey work for bethel. This school dey teach dem make dem fit preach well well and make other brothers and sisters faith strong well well.
Why people dey go Pioneer School?
Which people fit go School for Kingdom Evangelizers?