LESSON 15
Which Kind Work Elders Dey Do for Congregation?
Finland
Elders dey teach
Elders come visit dem for house
Dem dey preach
Just as e be for Apostle time, Jehovah Witness people dey choose some people wey love God well well and wey ready to ‘help other people for the congregation to serve God.’ We dey call dem elders. Their faith strong well well. (Acts 20:28) Elders na people wey don learn about God well well and wey go fit help other people serve God well. ‘Na the love wey dem get for God dey make dem do this work. Dem no dey collect salary, and nobody dey force dem do their work.’ (1 Peter 5:1-3) How elders take dey help us?
Dem dey take care of the congregation. Elders dey help everybody for the congregation learn wetin God want. Dem want make we serve God well. Dem sabi sey na God give dem this big work. Na im make dem no dey march people head pass. Their work dey make us happy well well. (2 Corinthians 1:24) Just like mama wey get pikin dey sofri sofri take care of im pikin, na so elders dey do for everybody wey dey their congregation.—Proverbs 27:23.
Dem dey help us do wetin God want. Na every week elders dey use Bible take teach us wetin God want. This one dey make our faith strong well well. (Acts 15:32) Dem dey show us correct example for preaching and dey train us for different different way to take preach.
Dem dey help all of us one by one. Elders get love well well for the congregation. Sometimes, dem dey visit us for our house or for Kingdom Hall. Dem dey use Bible help us, so that we go fit keep wetin we dey learn for mind.—James 5:14, 15.
As dem no dey collect salary, elders dey do other work to support their family. We dey respect this elders because no be small work dem dey do.—1 Thessalonians 5:12, 13.
Which kind work elders dey do for congregation?
How elders dey take help all of us one by one?