LESSON 17
How Circuit Overseer Dey Help Us?
Malawi
People wey want go preach
People wey dey preach
Elders dem dey do meeting
Bible talk about Apostle Paul and Barnabas well well. Dem dey travel go different different place to go see people wey dey congregation for that time. Na because sey dem love their brothers and sisters well well make dem dey go visit dem. Paul talk sey e ‘want go back make e see all the brothers,’ make e fit know how dem dey. Paul ready to go far far place to see dem and help dem. (Acts 15:36) Na the same thing circuit overseer dey do today.
Dem dey come help us. Circuit overseer dey visit congregation two times for one year. Na one one week dem dey stay. Na so dem take dey visit about 20 different different congregation. Their example, and their wife own if dem don marry, fit help us. Dem dey try sabi everybody for the congregation whether na pikin or old person. Dem dey follow us go visit people wey we dey help learn Bible. Dem and other elders dey go visit brothers and sisters to help dem serve Jehovah well. The kind talk wey dem dey give for our meeting and assembly dey make our faith strong.—Acts 15:35.
Dem dey show love for everybody. Circuit overseer want make everybody for congregation serve Jehovah well. The meeting wey dem dey do with elders and ministerial servant dey help dem sabi how things dey for congregation. For this meeting, circuit overseer dey give dem better better advice wey go help dem do their work well. Dem even dey help pioneer sabi how dem go take preach well. Dem really want sabi and help people wey just join us make their faith fit strong well well. This brothers ‘dey work for our own good.’ (2 Corinthians 8:23) Make we follow their example.—Hebrews 13:7.
Why circuit overseer dey visit congregation?
Wetin we go gain when dem come?