LESSON 18
How We Take Dey Help Our People Wey Dey Inside Wahala?
Dominican Republic
Japan
Haiti
Jehovah Witness people dey quick arrange things to help their people when different different wahala happen. This one dey show sey we love ourself well well. (John 13:34, 35; 1 John 3:17, 18) How we take dey help dem?
We dey help dem with money. For Apostle time, when plenty plenty people dey hungry for Judea, Christian wey dey Antioch gather money send go give their brothers wey dey there. (Acts 11:27-30) Na so Jehovah Witness people dey do today. When we hear sey our brothers and sisters dey suffer for anywhere for this world, we dey gather money for our congregation send go give dem.—2 Corinthians 8:13-15.
We dey help dem with wetin dem need. Elders wey dey the area wey the big wahala happen dey try check whether everybody for the congregation dey fine. Some of dem dey arrange food, clean water wey dem go drink, cloth wey dem go wear, place wey dem go stay and medicine wey dem go take. Jehovah Witness people wey sabi how to build house go come join build the Kingdom Hall and house wey scatter. When wahala happen, Jehovah Witness people dey quick help because all of us na one. Na true sey we dey help our brothers but we still dey help plenty people wey no be Jehovah Witness.—Galatians 6:10.
We dey use Bible take help dem. People wey dey inside this kind big wahala need help. When e happen like that, we dey get power from Jehovah, ‘God wey dey make our mind come down.’ (2 Corinthians 1:3, 4) Jehovah Witness people dey happy to tell people wetin dey inside Bible sey, e no go tey wey God go use im kingdom comot all wahala wey dey make us suffer.—Revelation 21:4.
Why Jehovah Witness people dey help people quick quick when wahala happen?
How we fit use Bible take cool the mind of people wey suffer this kind wahala?