LESSON 20
How Governing Body Take Dey Work Today?
Governing body for the apostle time
Dem dey read letter wey governing body send come
For the Apostle time, na one small group wey be ‘apostles and elders’ for Jerusalem be the governing body. Na dem dey tell all the congregation the better better thing wey dem go do. (Acts 15:2) Before dem gree for any matter, dem dey first look wetin Bible talk and dem dey follow wetin holy spirit want make dem do. (Acts 15:25) Na the same thing Governing Body dey do today.
God dey use dem do wetin e want. This brothers wey be Governing Body love Bible well well. Dem sabi how to take care of Bible matter and other matter dem. Dem dey gather everyweek to know wetin dey worry their brothers and sisters wey dey everywhere for this world. Dem still dey use letter or circuit overseer and other people take dey tell us wetin Bible talk. This one dey help us get one mind. (Acts 16:4, 5) Na this Governing Body dey arrange things wey we dey learn from Bible for different different congregation, dem still dey arrange our preaching work. And na dem dey choose some brothers wey go take care of congregation.
Dem dey do wetin God spirit tell dem. Governing Body dey follow wetin Jehovah and Jesus dey tell dem. (1 Corinthians 11:3; Ephesians 5:23) Dem no dey think sey dem be the oga for God people. Dem with their brothers wey holy spirit choose ‘dey follow Jesus anywhere e go.’ (Revelation 14:4) As dem dey do this big work so, dem go like am if we dey remember dem for our prayer.
Which people be the governing body for the apostle time?
How the Governing Body take dey show sey dem want make God use dem for this our time?