LESSON 21
Wetin Be Bethel?
Art Department, U.S.A.
Germany
Kenya
Colombia
Bethel, na Hebrew name wey mean ‘God House.’ (Genesis 28:17, 19, footnote) That name really fit the office wey Jehovah Witness people dey use take arrange their preaching work for different different country. The Governing Body dey for our head office wey dey New York for America. Na from there dem dey check branch office dem wey dey other country. Because dem dey work together, chop together and even learn Bible together, dem dey call dem Bethel family.—Psalm 133:1.
Na special place wey people dey use their mind work. Na people wey love God well well wey dey use all their time support preaching dey work for Bethel. (Matthew 6:33) Dem no dey collect salary but all of dem get fine place to stay. And dem dey give dem pocket money to buy small small things. Everybody for Bethel get work. Some dey work for office, some for kitchen, some na for where dem dey print book. Some even dey take care of the house, cloth and do other small small things.
Na place where people dey use all their time support preaching. Everything wey we dey do for Bethel na to help many many people sabi the correct things wey dey inside Bible. This book wey you dey read na one of dem. Na Governing Body write am. Dem use computer send am go give people wey go translate am for different different language for the whole world. When dem translate am finish, dem go print am with machine wey sabi do the work quick quick for Bethel. When the book don ready, dem go send am go all the congregation wey pass 110,000. Every work wey we dey do for Bethel na to support our preaching make people fit hear am quick quick.—Mark 13:10.
Who dey work for Bethel, and wetin dem dey give dem?
Which serious work Bethel for different different country dey support?